Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Deadly blast don hit Russian border city - Regional governor
Ukraine ‘ready’ to resume grain exports to Africa

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Most African kontris rely on grain supplies from Ukraine and Russia Ukrainian Foreign Minister Dmytro Kuleba say im kontri dey ready unconditionally to resume grain exports to Africa and oda parts of di world.
Dis exports fit happun if Russia end di naval blockade for di Black Sea.
For interview wit Tanzania privately owned The Citizen newspaper, he say despite say many African kontris neva come out openly to support anybodi for di Russian invasion of Ukraine, im kontri go make sure say dem keep dia part of dibargain.
"Ukraine go kontinu to work closely with all African nations in di coming days and weeks to ensure say all our contracted goods reach your markets, and to overcome di global food crisis wey di irresponsible actions of Russia dey cause" Mr Kuleba tok.
E also urge di world and all African states to work togeda and "pressure Russia to allow a safe sea route for our food exports".
Fuel and food prices for Africa don go up since 24 February wen di Russia-Ukraine war start and attempts by some leaders to ease di burden wey causse di katakata no dey successful.
Putin wan capture most of Ukraine – US
Russia don promise Belarus Iskander-M nuclear-capable missiles
Wetin Ukraine go gain as EU give dem candidate status?
Why UK dey send Ukraine M270 multiple-launch rocket systems despite Russia warning
Ukraine vex as Macron say "no humiliate Russia"
Ukraine round-up: 100 days of war and some Russians refuse to fight
Russian soldier chop life sentence for Ukraine war crime
Russian soja plead guilty for war crimes trial over Ukraine conflict
Ukraine don win di battle for di city of Kharkiv - Reports
CCTV video show how Russian soldiers kill Ukrainian civilians
US First Lady make unannounced visit to Ukraine
See how Macron second term begin for Elysee Palace
How Russian billionaires and businessmen dey run go Dubai to avoid sanctions
Russia claim say Ukraine 'kill dia own civilians' for Kherson
Wetin Zelensky and South Africa President Ramaphosa discuss for phone call?, Ukraine President don dey reach out to world leaders for support
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin
Ukraine President Volodymyr Zelensky do phone call wit di President of South African Cyril Ramaphosa on Tuesday evening.
For one tweet, Mr Zelensky say den tok about di resistance of im kontri to di invasion by Russian troops.
Dem also discuss about relations between di two kontris and co-operation wit international organisations.
Di Ukrainian president don dey reach out out to global leaders and regional blocs to beg for world support.
Mr Ramaphosa office neva give any statement about di phone call.
South Africa dey among 17 African nations wey no vote for United Nations resolution wey dey demand an end to di Russian offensive for Ukraine.

Wia dis foto come from, Zelensky
Gunmen kidnap more dan 70 pipo for northwest Nigeria
'Dis Ramadan dey full of pain' - How Ukraine Muslims dey fast
