For more dan one week, one Indian doctor for war-torn Ukraine don dey holed up for basement at home wit im pet big cats - one black panther and one jaguar.
Girikumar Patil, wey bin buy di two cats from Kyiv zoo about 20 months ago say e no go commot home without im pets.
E don live for over six years for Severodonetsk, one small town wey dey located for di Donbas region of eastern Ukraine.
After di war begin, Mr Giri, wey dey single, bin dey only come out of im cramped basement to buy food for im cats - di male jaguar be 20 months old and di female panther be six-month-old cub - afta di curfew end early in di morning. (Di jaguar na one rare hybrid between one male leopard and one female jaguar, e tok.)
So far, Mr Giri say e don buy 23kg of sheep, turkey and chicken meat from neighbouring villages at prices four times higher dan normal.
"My big cats bin dey spend nights wit me inside di basement wit me. E bin get plenti bombing wey dey happun around us. Di cats dey fear. Dem dey chop less. I no fit leave dem," Oga Patil, wey be 40 years old, tok.
"Dis be di second war I dey live through. But dis one dey scarier". E tok.
Oga Giri say e bin earlier dey live for Luhansk, where Russian-backed rebels bin dey fight Ukrainian troops since 2014 despite one ceasefire agreement. During di fight for di region, im house and one Indian restaurant wey e open for di area dey destroyed, e tok.
He come move to Severodonetsk, about 100km (62 miles) away, buy new place, begin practise medicine and buy im new pets.
"Now I dey stuck in a war zone. Dis time I dey really worried. My parents don dey call me and ask me to come home, but I no fit leave di animals," Mr Patil tok.