You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Ukraine tok say ceasefire no dey hold along evacuation route

    A ceasefire wey Russia and Ukraine agree to allow civilians to leave di city of Mariupol no dey fully observed, di city council tok.

    For one message wey dem post on Telegram, di council tok say fighting dey take place for Zaporizhzhia region, wey be say na dia di humanitarian corridor end.

    Ukrainian officials dey negotiate with di Russian side to confirm di temporary ceasefire along di entire evacuation route, di message tok.

  2. Russian F1 driver Mazepin don chop sack

    Russian Formula One driver Nikita Mazepin don chop sack from di Haas team as a result of Russia decision to invade Ukraine.

    Haas, wey be US-based outfit, also terminate di contract of dia title sponsor, Russian chemicals company Uralkali.

    Mazepin Billionaire papa, Dimitry, na part owner of Uralkali and pady to Russia President Vladimir Putin.

    Im papa bin be one of di leading Russian businessmen wey dem invite to meet Putin for Kremlin hours after di invasion began.

  3. Ukraine warns Russia not to abuse ceasefire

    Ukraine Deputy Prime Minister Iryna Vereshchuk don warn Russia say make dem no abuse ceasefire.

    Vereshchuk tok say make Russia no take advantage of agreed humanitarian corridor to advance dia troops.

    She tok say dia goment dey "verify" information say Russian troops dey use di ceasefire to move closer to Ukrainian positions for areas along di evacuation routes.

    "We dey use dis channel to evacuate civilians - women and children – and to also deliver humanitarian cargo to pipo wey remain,” she tok.

    "Di whole world dey watch.”

    Vereshchuk also confirm say di International Committee of Red Cross dey part of di ceasefire tok.

    And na dem go head di evacuation columns along di routes wey lead out of di cities wey dem agree on.

    Di ceasefire dey place around di cities of Mariupol and Volnovakha from 09:00 -16:00 local time (07:00-14:00 GMT).

  4. Mariupol deputy mayor: Attacks continue despite ceasefire

      • Author, Joel Gunter
      • Role, BBC News

    Di ceasefire no dey hold at di end of di evacuation route out of Mariupol.

    We dey now hear say di city imsef still dey under shelling.

    "Russia continue to bomb us and use artillery. E dey crazy," Mariupol deputy mayor Serhiy Orlov tell BBC.

    "E no get any ceasefire for Mariupol and e no get any ceasefire all along di route. Our civilians dey ready to escape but dem no fit to escape under shelling."

  5. E dey important to increase oil and gas output immediately - Elon Musk

    Ogbonge Tech oga, Elon Musk say e dey important to increase oil and gas output immediately.

    Di oga of Tesla wey dey react to di sactions on Russia sake of Ukraine war, say sustainable energy solution no go fit automatically make up for Russia oil and gas export.

    Di tweet say: “Hate to say it, but we need to increase oil & gas output immediately. Extraordinary times demand extraordinary measures. Obviously, dis go negatively affect Tesla, but sustainable energy solutions no just fit react automatically to make up for Russian oil & gas exports.”

    But Oga Musk no be di only tech boss wey dey worry about di coming scarcity sake of dis war.

    Blockchain developer Ser Jeff Garzik also tweet im concerns concerning di economic sanctions as e say dis fit accidentally become “oil and gas embargo.”

    Garzik say: “Di economic sactions on Russia dey sufficiently wide sotey dem fit effectively become accidental(?) oil and gas embargo, due to difficulty in paying for 2nd-order service like shipping. Di carve-outs for oil and gas fit punch through di sanctions.”

    United States and western kontris impose economic embargo on Russia and dis one mean say dem no go buy anytin wey Russia dey seel and dat include dia oil and gas.

    Russia na energy giant and di second largest producer of natural gas for di world.

    Di whole of Europe dey heavily depend on Russia to satisfy im need for oil and gas.

    Already, Russia don threaten to restrict export of oil and gas.

  6. Ten days of Russia war in Ukraine - Wetin don happun so far?

  7. Ten days of war: Wetin don happun so far?

    Di Russian invasion of Ukraine don enta di 10th day. Dis na di recap of di major developments since di invasion begin:

    ·Di number of civilian casualties still dey unclear but di UN refugee agency tok say more dan one million pipo don run komot from Ukraine since February 24 and millions more dey on di move.

    ·Di first major Ukrainian city wey fall na Kherson. Di city dey where the Dnieper river meets the Black Sea.

    ·Russian missiles bin don dey target di capital Kyiv and di second-largest city Kharkiv. One massive armoured convoy approaching Kyiv by road dey currently stalled.

    ·Di southern port of Mariupol still dey under siege and Russian troops dey head towards anoda port, Odesa – to capture both go cut off Ukraine maritime access.

    ·Russian troops don also seize di Zaporizhzhia nuclear plant on Friday after dem shell am for hours. Di Zaporizhzhia nuclear plant na di largest for Europe. Di move bin alarm world leaders who tok say di attack fit cause kasala.

    ·Di Chernobyl plant, di site of di 1986 nuclear accident, also dey under Russian control.

    ·Ukraine President Volodymr Zelensky don condemn di West for dia refusal to enforce no-fly zone over im kontri. Im tok say "all di pipo wey go die go die because of you".

    ·Di US and EU don impose sanctions on Russia. Dem freeze Russian assets and target di kontri central bank and President Vladimir Putin and im inner circle. Di rouble don go down sake of di restrictions wey also hit trade, investments and travel.

    ·Independent media wey include di BBC don suspend dia work in Russia after di kontri approve one draconian law wey go censor reporting of di war for Ukraine.

    ·Companies like Samsung, Airbnb and Cartier don suspend exports to / or operations for Russia.

  8. US Senate go meet Zelensky on Zoom

    Tori bi say dem don invite di United States to speak with Ukraine President United President Volodymyr Zelensky on Zoom.

    Zelensky don dey in touch wit President Joe Biden but dis go be di first time di Senate go speak to di Ukraine leader since Russia invade di kontri more dan one week ago.

    Last week, Ukraine ambassador to US Oksana Markarova bin meet members of di Senate and tok say her kontri urgently need more supplies to fight Russia.

  9. Third batch of Nigerians for Ukraine return home

    Di third batch of Nigerians wey run komot from Ukraine war don land for Nigeria.

    Di Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom) tok say di evacuees land for Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja about 11:50pm local time on Friday.

    Dem arrive from Budapest, Hungary.

  10. More dan one million pipo don already run from Ukraine, UN tok

    Some 1.2 million pipo don already run from Ukraine sake of di Russia invasion, according to di latest figures from UN High Commissioner for Refugees.

    Over half of dat number don enta Poland wey be Ukraine neighbour.

    As of Thursday 3 March, 650,000 bin run to Poland while 150,000 enta Hungary and di rest bin enta into oda European nations.

    Moldova, Slovakia and Romania na dem receive di next largest numbers of refugees.

    "Many more dey on di move both inside and outside di kontri,” di UNHCR tok.

    "Dem dey in need of protection and support. As the situation dey continue to unfold, estimated 4 million pipo fit run away from Ukraine.”

    Total population for Ukraine before di invasion na about 44 million.

  11. Breaking, Russia declare temporary ceasefire inside two Ukrainian cities

    Na day 10 of Russia invasion of Ukraine - and latest tori be say Russia declare temporary ceasefire inside two Ukrainian cities.

    See news lines we dey follow inside dis latest update:

    • Russia's defence ministry announce a temporary ceasefire and di opening of humanitarian corridors for civilians from 10:00 Moscow time (07:00 GMT) on Saturday from two cities in south-eastern Ukraine,MariupolandVolnovakha
    • Russia say dem agree di routes out of di cities with di Ukrainian side, but we neva seen confirmation of dat tori from Ukraine
    • Mariupolis wey be a major port city and wey don dey controlled by Russian forces for several days. Also heavy fighting dey happun inside Volnovakha
    • Earlier, di mayor of Mariupol appeal for civilians to dey allowed to leave in di midst of wetin im cal a "blockade" by Russian forces
    • Elsewhere, di fighting dey continue. Multiple explosions na im dem don hear inside Kharkiv, wey dey di north-east of Ukraine
    • Inside di eastern city of Sumy, wey dey surrounded by Russian troops, shelling begin at 05:00 (02:00 GMT) according to Ukrainian media
  12. Wetin be di latest in Ukraine?

    Na Saturday morning we dey so, 5 March and di Russia-Ukraine war don enta di tenth day.

    For readers wey just dey join us, dis na di summary of di latest developments:

    ·Cities around Ukraine dey under heavy pressure from Russian shelling, and dem dey hit civilian targets. Cities for di south of di kontri, wey get access to the Black Sea bin dey face particular pressure, though Russia continue to dey press from di north and east of di kontri as well.

    ·Ukraine President Volodymr Zelensky don condemn di West for dia refusal to enforce a no-fly zone over. "All di pipo wey go die go die because of you,” im tok.

    ·Western companies wey dey Russia don dey stop work and some of dem na Microsoft, Samsung, LVMH.

    ·Meanwhile, independent media firms, wey include di BBC, don suspend work for di kontri after Moscow approve one draconian law censoring reporting of di war for Ukraine.

    ·Di mayor of Mariupol for southeast Ukraine don appealed for a humanitarian corridor to im city sake of wetin im call "blockade" by Russian forces.

  13. Ukraine fit absolutely win Russia war - US Blinken

  14. Singapore sanction Russia

    Singapore don tok say dem go impose sanctions on Russia sake of say dem invade dia neighbour Ukraine.

    Dem go impose export controls and put financial limits ontop certain Russian bank. Dem go also place restrictions on cryptocurrency transactions and ban financial institutions from providing services wey fit help Russia central bank.

    Foreign Minister Vivian Balakrishnan bin tell parliament say Singapore won "act like many oda like-minded kontris to impose appropriate sanctions and restrictions against Russia".

    Na di first among regional neighbours wey go enact sanctions, though oda members of di Association of South East Asian Nations don condemn Russia actions.

  15. European peace dey as fragile as ever

      • Author, Kevin Connolly
      • Role, Europe correspondent, Brussels

    Na time to stop saying e dey somehow unbelievable say dis fit dey happun for 2022.

    E no dey unbelievable now dan e bin dey for 1914 or 1939.

    Peace always fragile - and wetin dey happun even for di most distant corners of Europe go always affect all of us.

    But to pick out di correct lessons from big moments wen everytin change no dey easy.

    Di question for our generation na weda or not we miscalculate how to handle Russia wen di Soviet Union collapse.

    Western Europe main reaction to di end of di Cold War na to take 30-year holiday from serious defence spending.

    But dis new age of containment go call for much more.

  16. If you just dey join us - Dis na quick recap of wetin don happun, Daniel Semeniworima, Onyinye Chime and Solomon Babatunde dey run dis Saturday morning.

    If you just dey join our live coverage, we welcome you.

    Di Ukraine conflict na still di biggest tori for world.

    • Russia say e go allow civilians to leave Mariupol and Volnovakha from 07:00 GMT
    • Mariupol - key southern port - don dey under siege by Russian forces for days
    • Earlier, Ukraine president condemn Nato leaders for not putting no-fly zone over im kontri
    • Di no-fly zone bin suppose stop Russian warplanes - but di West say e no want to escalate
    • Russia don ban Facebook, and now dem dey report say dem also block access to Twitter and YouTube
    • More dan 1.2m people don run from Ukraine since di invasion begin, UN say
  17. Good morning and welcome

    Una welcome to a live daily coverage of news around di world.

    Russia invasion of Ukraine wey enta tenth day dis morning still be di biggest news we go dey update you.

    Daniel Semeniworima,Onyinye Chime and Solomon Babatunde go join oda BBC reporters to give you latest update for dis live page.

  18. Good night!

    Na hia we go end today BBC Pidgin Live Page.

    To catch up wit all di tori wey you fit don miss today, make you scroll down di page.

    We go return on Monday 7am wit all di latest tori on Russia-Ukraine war as e dey happun plus oda ogbonge tori around di world..

    Na Jelilat Olawale, Helen Oyibo, Faith Oshoko, Victor Ezeama and Annette Arotiba bring una all di tori from afternoon till dis night.

    Good night.

  19. Russia don launch pass 500 missiles since di invasion start - US

    One senior US defence official don tell tori pipo di way wey Pentagon dey view di main developments wey dey happun for day nine of Russia invasion for Ukraine.

    Here be di main points:

    • Russia don launch pass 500 missiles since di invasion start and 92% of Russian combat power wey dem bin plan before dey for inside Ukraine
    • But di airspace ova Ukraine still dey contested
    • Di main advance of Russian forces go north of Kyiv still dey about 25km outside di city
    • Russian forces now dey around 10km outside di city centres of Chernihiv and Kharkiv
    • For di south, heavy fighting still dey happun for Kherson wey tori be say dey under Russian control, and US no dey position dispute am
    • Fighting dey happun now inside Mykolaiv, for di north-east of Odessa
    • Di US no dey assess say Russians dey Mariupol but Moscow no get plan to surround Mariupol for di north and for di coast
    • Di assault for di Zaporizhizhya nuclear power plant show say Russian invasion dey "reckless" but no radioactive leakage don comot so far for di plant, according to US assessment.
  20. Russia media regulator ban Facebook

    Russia don ban Facebook, according to one tori Russian state-owned news agency RIA Novosti.

    Di tori say di kontri media regulator Roskomnadzor decide to block access to di social media platform.

    Di regulator add say dem don get 26 cases of discrimination against Russian media by Facebook since October 2020, wit access wey dem restrict to state-owned channels like RT and the RIA news agency.