You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Wetin Abramovich sanction mean for Chelsea

  2. Di latest developments from Ukraine

    Una well done, those wey just dey join us, dis na di summary of di latest happening from Ukraine:

    • Di foreign ministers of Russia and Ukraine dey hold peace tok for Antalya, Turkey
    • US Vice -president Kamala Harris dey Poland one day afta her administration reject Poland proposal to transfer jet fleet to di US, instead of to give am directly to Ukraine
    • Di UK yarn say Moscow dey deploy conscript troops to Ukraine even though Russian President Vladimir Putin bin give assurance this week say e no go happun
    • Report say four pipo don die and out of dis number, no na pikin. Dem die afta Russian forces for night bomb one residential building near di city of Kharkiv according to Ukraine's State Emergency Services
    • White House officials don warn say Russia don dey grow desperate and fit use chemical weapons to attack civilians in coming days
    • US officials estimate say between 5,000 to 6,000 Russian troops don die so far for Ukraine
    • Ukraine's President Zelensky yarn give say Russia Bombing of hospital for di besieged city of Mariupol wey destroy maternity and pikin wards- na war crime
    • Plenti private companies don pledge to end business for Russia, as di kontri economic isolation kontinu.
  3. Breaking, Russian and Ukrainian foreign ministers dey meet

    Di Russian and Ukrainian foreign ministers dey meet for di first time since Russia's invasion of Ukraine start, Reuters news agency dey report.

    Russian foreign minister Sergei Lavrov and im Ukrainian counterpart, Dmytro Kuleba, dey for Antalya, Turkey.

  4. Breaking, UK sama Chelsea owner Abramovich sanction

    Di UK goment don sama Chelsea football club's owner Roman Abramovich sanction.

    Di Russian billionaire na one of seven Russian oligarchs whose assets don dey frozen.

    For one UK Treasury documentwey dem post online, Abramovich dey described as "pro-Kremlin oligarch" wey get close associations to Russian President Vladimir Putin.

    Abramovich don previously deny say im get close financial ties wit Putin or the Kremlin.

  5. Ghana gold businessman wan buy Chelsea Football Club for $3.1billion dollars, Ghana gold business man declare bold plan to buy Chelsea Football Club for $3.1billion dollars

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin, Accra

    Ghanaian gold businessman and politician dey trend after he declare interest to buy Chelsea Football Club.

    Bernard Antwi Boasiako popular known as Chairman Wontumi say he put in $3.1 Billion dollars bid to own take over affairs for Stamford Bridge.

    De popular gold businessman say he go buy Lionel Messi and Christiano Ronaldo make dem play for de Blues.

    Social media dey blow over de idea say as African, he make bold move to own English club.

    Current owner Roman Abramovich put de club up for sale after Russia-Ukraine war start.

  6. 'I recognize dia luggage and dat na how I find out'

    One man don tok about how e find out say Russian attack kill im wife and two pikin dem for Twitter wey show dia dead bodi.

    Sarhiy Perebynis tell di New York Times say "I recognize dia luggage and dat na how I find out".

    Tetiana Perebyinis and dia two pikin, Mykyta, 18, and Alisa, 9 die for di town of Irpin as dem bin dey try escape. For 2014, di family bin run comot eastern Ukraine to stay fo Kyiv on top di kasala dia between di Ukrainian army and Russian-backed separatists.

    Serhiy bin dey take care of im mama wey dey sick before di war start.

    And he tell di newspaper say e hear wiiinnn as e bin dey try enta Kyiv, dem force am go Russia to cross enta Poland.

    E tell di Russian soldiers for di Poland borde say, "My whole family die for wetin you dey call special operation and we dey call war. Do as you like with me, I no get anytin to lose."

    Serhiy write for Facebook for Russians sat wetin im face be like horror feem.

    E write say "e dey hard to watch di wife wey you love dey lie down for black bag for ground".

    E say also add, "I go go fight for dem to di end".

  7. Seven pipo don die for Ukraine ontop overnight attacks

    Ukrainian officials don reveal say seven civilians don die from over night Russian attacks.

    Four of di pipo wey die na pikin according to reports.

    Authorities reveal say dem bin die for di Kharkiv and Sumy regions.

    Officials say overnight attacks by Russia for Sumy region bin kill at least three pipo wey include one 13 year old boy and two women.

    Reports say dem bomb residential area and gas pipeline for di area.

    While for Kharkiv, four pipo die wey include two small pikin dem according to di Ukrainian State |Emergency Services.

    Dem say di bombing for dat side bin hit a residential building near Kharkiv city just afta midnight.

  8. Breaking, Four killed in shelling for south-east Ukraine: SES

    Four pipo dey reportedly killed - of which two na small pikin dem - after Russian forces shell one residential building near di city of Kharkiv for night, na so Ukraine State Emergency Services (SES) tok.

    Di attack reportedly take place in di village of Slobozhanske, for south-east Ukraine.

    SES add say dem also rush a five-year-old girl wey bin dey injured to hospital for treatment.

    Rescuers dey expected to continue search operations today to pull bodies from di rubble.

    Fire from bombardment also set a shopping mall ablaze for di heart of Kharkiv - however dem no report any casualties.

  9. Russian advance don slow: Ukraine defence ministry

    Di General Staff of di Armed Forces of Ukraine don post im daily morning update, wia e tok say di Russian advance into parts of Ukraine don slow.

    Here na oda tins wey e tok:

    • Russia's advance for di direction of Kyiv don dey restrained
    • For eastern Ukraine, defense forces continue to deter di Russian offensive for Donetsk, Slobozhansky and parts of di Tavriya operational districts. Dem dey defend di cities of Kharkiv and Okhtyrka
    • For di south, di defense of di port city of Mariupol dey continue
    • Ukrainian forces don also fend off di Russian offensive for di directions of di cities of Kryvyi Rih,Mykolayiv,Voznesensk and di settlement ofNovovorontsovka(Kherson region)
    • Over di past two days, Ukrainian fighter jets and anti-aircraft missile units don destroy four Su-25 attack aircraft and two Russian helicopters
    • Di pace of di Russian offensive don dey slowed. Di number of cases of desertion and looting don increase wella

    Di BBC neva independently verify di statement.

  10. Di latest news from Ukraine

    Una welcome. See wetin you need to know about wetin dey happun for Ukraine.

    • Di foreign ministers of Russia and Ukraine don land for Turkey to hold peace talks for di city of Antalya on Thursday
    • US Vice-President Kamala Harris dey Poland one day afta di US reject di kontri plan to transfer im jet fleet to di US, rather dan directly to Ukraine
    • White House officials son warn say Russia dey grow increasingly desperate, and fit resort to chemical weapons attacks against civilians in di coming days
    • US officials estimate say between 5,000 to 6,000 Russian troops don die so far in Ukraine
    • Ukraine President Zelensky say Russia bombing of one hospital for di city of Mariupol - wey destroy di maternity and children wards - na war crime
    • More private companies dey pledge to end business Russia, as di country economic isolation continue
  11. Una good morning!

    Una good morning.

    Una welcome to our live coverage today of tori from around di world.

    We go bring una tori from Nigeria, across Africa and di rest of di world.

    Di world eye still dey Ukraine afta Russian invade dem.

  12. Who be Olena Zelenska - Ukraine First Lady?

  13. Russia 'destroy' Ukraine maternity hospital for 9 March attack

  14. Nigeria President express sadness ontop Kebbi killings

    Nigeria president don extend sympathy to di family of di vigilante members wey bandits brutally murder for Kebbi State northwest Nigeria.

    “Dis egregious level of criminality dey shocking”, Muhammadu Buhari tok for inside statement.

    Oga Buhari say di killing dey very very sad.

    On Monday, 7 March, bandits ambush di vigilante members for Sakaba/Wassagu Local Government Area of di state.

    President Buhari also assure Nigerians say im go do evritin to tackle dis kain palava.

    Di Nigerian leader don direct security forces to redouble dia efforts to frustrate di operational plans of terrorists even before dem launch attacks.

    Kebbi State command tok-tok pesin, Nafiu Abubakar, wey confam di attack say dem neva fit ascertain di number of casualties as dem still dey investigate di mata.

    Buhari currently dey London for medical examination.

  15. Evacuations from at least one city bin stop - reports

    As we bin dey report, Ukraine and Russia don agree to hold 12-hour ceasefire for six cities for Ukraine today to allow civilians escape some of di heaviest fighting.

    But we dey hear say no be all di planned evacuations of civilians dey happun.

    For Izyum, eastern Kharkiv, one regional official dey claim say di evacuation of civilians dey "prevented by Russian shelling".

    Oleh Synehubov say di explosions for suburbs mean say di evacuation convoys no fit leave.

    For Mariupol, for south-east, di situation no too clear.

    Ukraine foreign minister write on Twitter say Russia continue to block evacuation attempts and di delivery of humanitarian aid.

    BBC no fit verify di situation for ground.

    For Sumy, north east Ukraine, di picture dey quite different.

    Pipo don fit leave di city for private cars and on bus since this morning, di city mayor tok.

    And for Enerhodar, southern Ukraine, convoys of mainly women and children don begin leave, im mayor tok.

  16. Court don adjourn Hanifa murder case to 22nd of March, Prosecution go present dia final witnesses on March 22

    Court don adjourn Hanifa murder case to 22nd of March.Justice Usman Na’abba of Kano High Court on Wednesday adjourn di case before am of di murder of di five-year-old student Hanifa Abubakar to 22nd of March 2022 for further hearing.

    On dat day, di prosecution team led by attorney general of Kano state Barrister Musa Lawal go present dia final two witnesses before di court (already dem don present seven for di case).

    Dem present shovel wey second defendant Hashim Isyaku allegedly use dig hole wey dem bury di remains of Hanifa although im lawyer argue say as a labourer and bricklayer wey im client be e, no dey out of place to find shovel under im bed.

  17. Court nack popular Ponzi Scheme operator Umanah Umanah with 20 years imprisonment

    Di Uyo Zonal Command of di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don secure di conviction and sentencing of one notorious Ponzi scheme operator, Umanah Umanah to 20 years imprisonment before Justice Agatha Okeke of di Federal High Court Uyo, Akwa Ibom State on 8 March 2022.

    Na 2020 di case start wen operatives of EFCC arrest Umanah following petition by one of im victims, wey allege say Umanah dupe am of over N2.9million (two million, nine hundred Thousand Naira) and give am N500, 000. 00 (Five hundred thousand naira) cheque, wey bounce as di bank dishonor am because di account no dey funded.

    During investigation, EFCC discover say Umanah lure im victims through big-big promises of return on investment of up to 50% in seven days through im company, No Burn Global Limited, wey get network for several States of di federation. Di court find am guilty on di two count charge bordering on false issuance of dud cheque and obtaining by false pretense to di turn of N2.9 million naira.

    Read more hia.

  18. Ukraine First Lady tok about di war horrors and call for no-fly zone

    Ukraine First Lady Olena Zelenska don release her first public statement inside letter wey she address to di global community.

    Inside am, she tok about di horrors of war, particularly for women and pikin dem. She also name some pikin wey don die for di war so far:

    • “Eight-year-old Alice wey die on di streets of Okhtyrka while her grandfather dey try to to protect her.
    • “Polina from Kyiv, wey die inside di shelling with her parents.
    • “14-year-old Arseniy wey dey hit on di head by tins wey destroy for di attack, and dem bin no fit save am because ambulance no reach am on time because of intense fires.

    “Wen Russia say dem no dey 'wage war against civilians,' I call out di names of di murdered children first,” she write.

    She than di support of di international community, and neighbouring nations wey don take in refugees. But she also repeat di calls of her husband, President Zelensky, for Western nations to declare a no-fly zone. Nato no wan dis action because e go involve Western forces to likely engage dia military against Russian aircraft.

    “We need those in power to close di sky. Close di sky and we go manage di war on di ground ourselves."

    “With dis letter, I testify and tell di world: di war for Ukraine no be war 'somewhere out there'. Dis na war inside Europe, close to di EU borders."

    “If we no stop Putin, who dey threaten to start a nuclear war, dia no go be safe place for di world for any of us.”

  19. Court confam as exhibits statements wey suspects for Hannifa murder give police

    Court on Wednesday for Kano rule say statements wey prime suspect Abdulmalik Tanko and two odas give police on di murder of five-year-old Hanifa Abubakar dey valid and admissible for court.

    For di trial within trial wey hold for court, defence counsel Mukhtar Usman bin wan make Justice Usman Na’abba dismiss di statements wey di suspects give police adding say dem give am under duress.

    For im ruling, Justice Na’abba say di suspects no prove say police beat or threaten dem and infact di third defendant Fatima Musa use her own mouth tok say dem no beat her.

    Normal trial go continue as di prosecution team go continue to present witlessness to prove dia case.

  20. Ghana Police name rogue officers wey dey behind bullion van robberies

    Police for Ghana say dem kill two police officers who be suspects inside de series of bullion van robberies wey hit de country.

    Dem shoot de two police officers for dia Borteyman hideout near Ashaiman on Tuesday.

    Inside statement wey public affairs director, DCOP Kwesi Ofori release, he explain say exchange of gunshots happen during de raid, wey two policemen, No.58284 Constable Reindolph Gyimah Ansah den No. 53549 Lance Corporal Stephen Kwaku Nyame wey dem arrest earlier in connection with de Bullion Van Robberies chop bullet den die.