You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Ukraine invasion: Second batch of Nigerians land Abuja from Poland

    Anoda batch of Nigerian student wey dem evacuate di conflict for Ukraine don arrive di Nnamdi International Airport dis evening

    Emergency officials say one hundred and eighty students na dem land from Poland.

    Early dis morning, four hundred and fifty Nigerians bin land di capital from Romania. Dem gatz return on Wednesday but delay bin happun sake of logistics wahala.

    Some of di students wey speak to BBC Pidgin say dia experience dey devasting.

    Yemi Ajayi say im get unforgettable experience as e see pipo dey die from hunger and sake of say dem weak and no fit walk again.

    E also for all im life e neva see wia dem just dey shoot pipo and kill dem anyhow.

    E say im feel happy becos wen e get life, hope dey.

  2. China TV rights holder no go show Premier League matches sake of FA support for Ukraine

    Chinese company wey hold television rights don tell di Premier League say dem no go broadcast top matches for England dis weekend sake of say di league plan to show support for Ukraine, di BBC don discover.

    China na close political ally of Russia, wey don invade Ukraine.

    Di Premier League don say dem “use dia who mind reject wetin Russia dey do" and dem dey ready to show solidarity wit Ukraine.

    "We call for peace and our thoughts dey wit all those wey di war don affect," dem add, wen dem dey announce dia plan earlier diis week.

    Di plan include for captains to wear special armbands in Ukrainian colours, while stadium screens go display 'Football Stands Together' in front of di kontri blue and yellow flag.

    Dem also don tell fans to join "a moment of reflection and solidarity before kick-off for each game".

    Wen we about di refusal of di Chinese company to show matches, di Premier League no gree tok.

    For 2019 China state broadcaster CCTV remove one Arsenal-Manchester City game from dia schedule afta comment wey former Gunners midfielder Mesut Ozil make.

    Ozil bin make social media post about how China dey treat Uighur Muslims.

  3. BBC don suspend operations for Russia for now

    As we don dey tok since morning, di lower chamber of di Russian parliament say e approve law wey go put pipo for prison for up to 15 years say dem dey spread "fake" information.

    Dem don shut down some independent outlets for Russia while some don stop operation.

    International media houses like BBC and Deutsche Welle now dey restricted.

    Now di BBC director-general don announce di suspension of di of di work of all BBC tori pipo for Russia to follow di law.

    Director General Tim Davies say, "Di law be like say e wan make di process of independent journalism to crime, we no get choice but to suspend di work of all BBC tori pipo and support staff for insde Russia as we dey look dis mata well-well. We go continue to run our BBC News Service for Russian from outside Russia".

    E add say, "Di safety of our staff na di most important and we no dey ready to put dem for criminal prosecution kjust because dem dey do dia jobs.

    "I go like hail dem for dia bravery, determination and professionalism. We dey committed to do accurate, independent information wey dey available to pipo around di world including all di millions of Russians wey dey use our services."

    E conclude say "Our journalists for Ukraine and around di world go continue to report di invasion for Ukraine."

  4. In-fotos: Tears, hugs, shock and oda moments of Nigerian returnees

  5. IGP approve new 'improved' dress code for police women, Police women don dey allowed to dey use small earring and scarf under dia beret

    Nigeria Inspector General of Police, Usman Alkali Baba don approve new and improved dress codes for women officers.

    Di Police Force inside statement wey di Public Relations Officer Olumuyiwa Adejobi sign say women officers go now dey allowed to dey wear small earrings and scarf under dia berets or cap to complete dia uniform.

    Di IGP say dis development dey in line wit international best practices wey dey address di growing concern for gender mainstreaming and respect for culture and diversity.

    E add say di Nigeria Police workforce get officers wey come from different ethnic, religious backgrounds and plenty women dey di force.

    “Di need to guarantee inclusion, gender mainstreaming, ethnic and religious diversity for di work place for optimum output and professionalism don become important.” E tok.

    Oga Baba add say di dress code dey optional and e ask senior women police officers to ensure compliance wit di approved standard for women police officers wey choose to follow dis dress code.

    Di IGP say kontris like Canada, America, Sweden, Turkey, Australia, UK, among odas also follow for dis dress code mata.

    Dem unveil di dress code for one IGP meeting wit Strategic Police Managers on March 3, 2022.

  6. Before and afta fotos show Russian destruction for Ukraine

  7. 'Women dey desperately pass dia babies give border guards'

    Women for Ukraine don dey share dia experience about di Russian invasion on Radio 5 Live.

    Vlada wey be 29 years old and don choose to stay for Kyiv wit her mama. Di two of dem dey hide for house.

    She say dem dey “try to support each oda and describe how dem dey feel.”

    “Explosions near us wey make our windows begin shake,” she tok.

    Olesia dey travel to Polish border wit hope say she go find where to stay. She leave behind her 83 year old grandmother for Kyiv.

    “She bin dey worry about us, Olesia tok. So she tell us to go. Even though Kyiv dey safe for now, we no know wetin fit happun later, so we decide to escape.”

    Masha and her 14 year old don become refugees and don relocate go Tel Aviv.

    “We waka go Ukranian border and na terrible night. We see pregnant women, children and elderly wey stand for several hours.”

    “women dey desperate to carry dia children give border guards because dem dey freeze.”

  8. Ukraine to Nato: We need more than just una weapons

    Ukrainian foreign minister Dmytro Kuleba don thank kontris for di Nato military alliance for di weapons and ammunition dem don send to help fight di Russian invasion u say dem need pass dat one.

    "Help us," na wetin im hala for video on Facebook.

    "If you no do, I dey fear say you go need share responsibility for di lives and suffering of civilian Ukrainians wey don die sake of Russian pilots wey dey throw bombs for dem."

    Kuleba say e sure say di time go come for di war wey Europe "go ready to give us anything we need so dat Putin ino go hit reach you" wey go turn Europe to a "nightmare".

    "My hope be say, make e no dey too late".

  9. We dey fight di world first 'dynamic' war - Ukraine cyber chief

    Di Ukraine cyber security authority say di kontri dey fight war for di cyber realm and for ground.

    Dem say dem dey face constant cyber-attacks against dia goment and infrastructure network, wit citizens as well as officials wey don become target.

    State Service of Special Communications Deputy Chairman, Viktor Zhora, say im cyber defence dey stop most attacks - but say dem dey involve for fight against Russia.

    "These two war [wey we dey fight] dey part of dis serious war. Dis dey happen for di first time in history and I believe say cyber war only fit end wit di end of conventional war and we go do everything we fit do to bring dis moment closer."

    As di invasion start, di digital ministry launch di "IT Army of Ukraine", wey don dey focus on Russian targets including attempt to disturb transport and power network.

    Di Telegram group for di army don get 270,000 members - but di ministry estimate say e fit reach as many as 400,000 hackers wey dey fight online for Ukraine.

  10. 'Everywia e go, e dey spread love' - Riky Rick memorial

    Pipo send messages of love and live performances dem boku from hip-hop artistes bin attend di memorial service of di South African rapper Riky Rick wet die last week at di age of 34.

    Dem bin stream am live for YouTube and thousands of pipo attend online.

    DJ Black Coffee bin reveal for di memorial say, "e always tell us say e no go dey here long. E bin know".

    Di ogbonge DJ say Riky Rick no deserve wetin one Sunday newpaper bin do wen dem revea im suicide note to im wife and pikin dem. E say "Everywia e bin go, e dey spread love, e no mata who you be or wia you from come. E sabi how to lift pipo and eyet e bin dey suffer plenti personally."

    Di mood for di memorial bin dey like party as pipo bin dey look for di life and last days of di man wey im real name na Rikhado Makhado.

    Many wey perform credit am with how dem take start dia career and for di stage wey im perform dem write di phrase wey e bin like tok, "We neva die, we multiply".

  11. Ukraine-Russia don plan anoda round of tok-tok dis weekend

    Ukrainian and Russian officials go continue dia tok-tok for di third time dis weekend to try to end di fight-fight wey di Russian invasion cause.

    "Di third leg fit happun tomorrow or di day afta – we dey follow up di mater well-well," Ukrainian presidential advisor Mykhailo Podolyak tok.

    Di first round of tok-tok see officials from both sides meet on di Ukrainian border wit Belarus – wit small breakthrough.

    For di second meeting between officials, Russia agree to di need for temporary ceasefire for humanitarian corridors to allow civilians to escape di fight-fight. But Ukraine say di outcome no be wetin dem dey expect.

    Ukraine President Volodymyr Zelensky bin don request for one-to-one meeting wit Russian President Vladimir Putin, saying dat na di only way to end di war.

  12. Hungary don gree to collect Ghanaian students from Ukraine

    Ghana say Hungary don agree to take some of dia citizens wey run comot from Ukraine so dem go fit continue dia studies for Europe.

    Some universities for Hungary dey open spaces and resources for students wey go pay di same fees as dem bin dey pay for Ukraine, Hungarian authorities tok.

    More dan 1,000 Ghanaian students bin dey live for Ukraine until Russia invade dem last week, and di West African nation done evacuate dia pipo two times so far.

    One 24-year-old computer science student wey arrive Accra on Friday morning tell di BBC say some Ukrainian institutions dey help students complete dia courses online.

    Some 700 Ghanaian students don cross di Ukrainian border into neighbouring kontris, but some no dey willing to return home sake of say dem no dey sure of di future of dia education.

  13. Pakistan bombing kill at least 30 pipo for Shia mosque for Peshawar

    At least 30 pipo don die inside bomb blast wey happun for one mosque for di north-western Pakistani city of Peshawar.

    According to di police wey give di informate, more than 50 pipo dey reported to injure for di suspected suicide attack on Shia mosque during di Friday prayers.

    Some of those wey injure dey for critical condition. No group don claim say na dem carry out di attack yet.

    Thousands of pipo don die, most especially, for Pakistani sectarian violence in recent years.

    "I see one man wey shoot two policemen before e enta di mosque. Seconds later I hear one loud noise," one witness Zahid Khan tell AFP news agency reports.

    Di blast scata di windows of nearby buildings. Local pipo dey help carry pipo wey die and injure for dia motor or motorbikes.

    One tok-tok pesin for Peshawar Lady Reading hospital, Muhammad Asim Khan, a spokesman for Peshawar's Lady Reading Hospital. Say dem don declare emergency for di hospital.

    E confam say about 30 deadi bodies dey di hospital.

  14. Breaking, Russia dey use cluster bombs for Ukraine - Nato

    Nato Secretary General Jens Stoltenberg say evidence dey say, Russia dey use cluster bombs for dia invasion.

    For news conference, e tell tori pipo say, "we don see di use of cluster bombs and we don see reports say dem dey use oda weapons wey dey against international law."

    E also tok say, di Western Military alliance no go set up no-flyzone ova Ukraine or send troops go dia but promise say dem go help Ukraine in oda ways and ask President Vladmir Putin make e stop di invasion now-now.

  15. How dangerous di attack be?

    As we don report, Ukraine say "several" pipo dey "killed and injured" wen Russia attack and seize control of di Zaporizhzhia nuclear power plant.

    Di UN's nuclear watchdog, di International Atomic Energy Agency, tok say none of di safety systems for di plant dey affected, and no release of radioactive material dey.

    But nuclear experts say di attack creat very risky situation.

    If a reactor - di device wey dey responsible for generating energy for nuclear power plant - and di building wey dey house am dey damaged, di reactor fit overheat and lead to core meltdown.

    Radiation from di plant fit den leak into di surrounding environment. If pipo dey exposed to dis radiation e fit cause severe immediate and long term health impacts, wey include cancer.

    Yet experts say - although di attack dey dangerous - important differences between di Chernobyl and Zaporizhzhia plants dey.

  16. Ukraine say pipo don die for fire wey happen for nuclear plant

    Plenti pipo don die and odas wunjure for di fire wey happen afta Russian army attack one nuclear power plant for Ukraine, di kontri foreign affairs ministry tok.

    Employees dey monitor di Zaporizhzhia plant to make sure say e dey operate safely and radiation level still dey normal, di ministry tok for statement dem publish on Facebook.

    But if anytin disturb di process to cool di nuclear fuel inside di power units e fit cause serious radioactive damage.

    “Thousands of pipo wey – including civilians wey no fit comot for di area near di plant sake of di war and attack wey dey happun – e go affect dem badly,” di statement tok.

    Sake of di reaction from di Ukrainian president, di ministry say nuclear disaster for Zaporizhzhia fit dey worse pass previous accidents for nuclear plants – including di one wey happun for Chernobyl and Fukushima.

    “Russia don consciously cause armed attack for di nuclear power site, action wey violate all international agreement inside di IAEA [International Atomic Energy Agency],” di statement add.

  17. 'Like students wey dey go camp, except dem dey carry assault rifles'

      • Author, Jeremy Bowen
      • Role, BBC Middle East editor

    Dis young men dem don volunteer to fight for Ukraine. Wen we meet dem yesterday, di boys still bin dey excited and patrioticfor di kind of young men dey dey when dem sign up for war.

    Some older men bin dey dia too, and dem look like dem fear pass di 18 and 9 year olds.

    Di teenagers resemble you dey go camping trip except dem bin dey carry assault rifles. Dem tok say dem bin only get three days training, but dem already sabi how to shoot and maintain dia guns.

    Dis morning we see dem dey man road blocks for di edge of di city. Apart from di live weapons dem also carry Molotov cocktails.

    Ukraine get professional army, and dem go fit use di volunteers for secondary roles.

    But if and wen Russia attack Kyiv, dis fit change sharp-sharp and volunteers but young and old fit find dia self for di middle of di kasala.

  18. President Buhari don return afta 3 days for Kenya

    Nigeria president Muhammadu Buhari don return to Abuja afta aim three days trip to Kenya.

    Na so Bashir Ahmad, Special Adviser to the president on Digital media tok for social media post.

    President Buhari return afta e participate for di 50th Anniversary of di UN Environmental Programme (UNEP) for Nairobi, Kenya.

    Tok-tok pesin for di president, Femi Adesina for earlier statement bin say from Kenya, President Buhari go go London for im routine medical check-up.

  19. NFF invite 25 man list of Super Eagles players wey go play Ghana

    Emmanuel Dennis and Ademola Lookman dey among di 25-man list di Nigeria football federation (NFF) invite to play di world cup qualifiers.

    Na captain Ahmed Musa go lead di squad wey de play Ghana for di world cup qualifiers play-off later dis month.

    Di two west African kontris dey meet wit di first leg wey dey happen for Ghana on 25 March while Nigeria go host di second leg on 29 March.