800,000 pikin dem dey among two million wey dey run from Ukraine: Save the Children
Save The Children say an estimated number of 800,000 pikin dem dey among di two million pipo wey don run comot Ukraine afta Russia invasion begin.
Many of dem dey make di trip on dia own di agency don warn.
“Parents dey take di most desperate, heart-breaking measures to protect dia pikin. Dis one include to dey send dia pikin away with neighbours and friends, to seek safety outside of Ukraine, while dem stay home to protect dia homes,” na so Irina Saghoyan from di NGO tok.
Report come yesterday of one of such case– one 11-year-old boy, Hassan, wey leave im home for Zaporizhzhia on im own because im mama no fit leave im grandmother,
He arrive safely for Slovakia, afta one 1,200km train journey, e carry just two small bags, im passport, and im relatives phone number wey im write for im hand.
More dan half of di refugees wey dey leave Ukraine dey go Poland, and den Hungary and Slovakia.