Millions of Nigerians vote for di most competitive presidential election since military rule end. Sabi pipo say dis time, na three horse race.
Live Coverage
Victor Ezeama, Helen Oyibo, Jelilat Olawale and Annette Arotiba
More provisional results from Akwa Ibom state
Wetin we call dis foto, INEC Uyo collation centre
All di presidential results as collated by Inec from di 31 LGAs for Uyo, Akwa Ibom state don enta wit dis latest local goment areas dem announce.
Na Inec go announce di final winner of di states and general winner.
IKOT EKPENE LGA:
APC 11803
LP 5985
PDP 6624
NNPP 207
IKOT ABASI LGA:
APC 2875
LP 4616
PDP 6900
NNPP 153
UKANAFUN LGA:
APC 6152
LP 2067
PDP 7751
NNPP 160
UYO LGA:
APC: 7769
LP: 27534
PDP: 12245
NNPP: 1044
ABAK LGA:
APC: 15058
LP: 5057
PDP: 7017
NNPP: 123
Provisional results from four LGAs for Kaduna state show
Wetin we call dis foto, INEC Kaduna state collation centre
Provisional presidential
election results as announced by Inec for di state level don resume for Kaduna State Collation Centre.
Na Inec go announce di final winner of di states and general winner.
JABA LGA:
APC: 3131
LP: 9,967
PDP: 8,798
NNPP: 335
KADUNA SOUTH LGA:
APC: 29596
LP: 22577
PDP: 42996
NNPP: 9124
KAURU LGA:
APC: 15,870
LP: 11,293
PDP: 19,018
NNPP: 3,128
LERE LGA:
APC: 24695
LP: 15,568
PDP: 34,149
NNPP: 7,264
Provisional result by INEC for Lagos State
Provisional result wey INEC don announce for Lagos presidential election show say Labour Party na dem take di lead for di state.
But INEC for national level go need ratify di result from di state before dem go declare di official winner for Lagos State.
Accredited voters : 1347152
APC 572606
LP 582454
NNPP 8442
PDP 75750
Dis na provisional result wey di state INEC go carry go di national collation centre for Abuja wia di official result go dey announced.
Police ask presidential candidates to caution parties supporters against inciting comments
Wia dis foto come from, NPF
Wetin we call dis foto, Police warn against inciteful comment
Di Nigeria Police don ask di
presidential candidates of di major political parties for di 2023 general elections
to caution dia party members and supporters from making inciting statements wey
fit heat up di polity.
Di police tok dis one for inside
statement wey di Force tok-tok pesin, CSP Olumuyiwa Adejobi release.
Di statement charge di
presidential candidates to use di waiting period opportunity to teach dia
supporters di rule of law plus respect for di constitution.
E also warn say make pipo stop to
dey mount pressure on di Independent National Electoral Commission, Nigeria
electoral body, INEC as all hands dey on deck to speedily conclude di collation of results and declare di winner.
Di NPF encourage presidential
candidates to admonish dia supporters to maintain of di Peace Accord dem
recently sign for di smooth conduct of di election.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Collation of presidential election resume for Asaba, Delta state
Collation of presidential election results don resume for Delta State.
So far, eight local goment don
announce dia results out of di 25 Local goment areas for Delta State.
See di local goment wey
don collate dia results so far.
Na Inec go announce winners of each state, and di general winner for di national level.
BOMADI LGA:
APC 2421
LP 3134
NNPP 38
PDP 4429
NDOKWA WEST
APC 3840
LP 12889
NNPP 56
PDP 8599
IKA SOUTH
APC 3290
LP 17,868
NNPP 166
PDP 7,485
WARRI NORTH
APC:1379
LP: 2417
NNPP:52
PDP: 3411
ETHIOPE EAST
APC:6314
LP:10,806
NNPP:402
PDP:7,854
ANIOCHA SOUTH
APC1,686
LP14,208
NNPP113
PDP4,672
Party agents for Akwa Ibom reject result from Oruk Anan LGA
Wetin we call dis foto, INEC collation centre for Uyo
Palava break out for INEC collation centre for Uyo, di Akwa Ibom State capital as party agents reject results from Oruk Anan Local Goment Area of di state.
Dem allege fraud for di result wey dem collate for di local goment area as follows:
ORUK ANAM LGA:
APC 7039
LP 2617
PDP 8962
NNPP 74
More results from presidential election results collation centre for Lagos
INEC still dey continue to collate presidential results from local goment areas of Lagos state,
Returning officers dey take turn to read out di results from dia areas of assignment.
Here na two LGAs wey dem just announce.
Alimosho LGA
Registered 855724
Accredited 158209
APC 62909
LP 71327
NNPP 701
PDP 8201
Mushin LGA
Registered voters: 406132
Accredited voters: 73975
APC 41907
LP 23390
NNPP 410
PDP 3478
Ojo LGA
Registered voters: 401798
Accredited voters: 70494
APC 20603
LP 38859
NNPP 462
PDP 3701
Dis na provisional result wey di state INEC go collate go di national collation centre for Abuja wia di official result go dey announced.
Delta state don come back
Article Information
Author, Princess Igho Williams
Role, BBC Pidgin
Collation of di presidential election results still dey go on for Asaba, Delta State.
So far, eight local goment don announce dia results out of di 25 Local Government Areas for Delta State.
See di local goment wey don announce dia results:
Aniocha North, Ika North East, Oshimili North, Ethiope West, Ika South, Bomadi
Ndokwa, West
Warri North.
NLC ask Buhari to call Inec to order
Article Information
Author, Tamara Ebiwei
Role, BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, NLC
Di Nigeria Labour Congress, don continue to express worry about di state of di nation as di collation of results dey go on, dem dey vex say as Inec officials no fit upload results to server fit cause kasala for di kontri.
Inside statement di workers union release on Sunday night, president of di union Joe Ajaero tok say, "we continue to express our deep concerns over di apparent manipulation of results for Lagos and Rivers states and demand di real results as captured by di BVAS be uploaded without fail."
"INEC must understand say not uploading results to server go create avoidable crisis"
Dis na wetin di Nigeria Labour Congress tok as di collation of result for state levels don dey go far.
"We demand make INEC investigate di activities of one of di officials for di ICT department wey fit dey responsible for technically jamming di airwaves wey make am difficult for BVAS results to dey transmitted to di servers."
NLC allege say di pesin wey fit jam di airwaves to stop di successful transmission of results "na one former Commissioner for Lagos State and im name na Femi Odubuyi".
We call on President Muhammed Buhari to rise to di occasion and call di electoral umpire (INEC) to order. Di president suppose to seize di redemptive power for dis situation and demand INEC to return to di rule book for election conduct.
Na only if im do dis im go reassure Nigerians of im innocence for di unfolding drama.
Breaking, Kaduna state don come back
Inec officials don resume for Kaduna state afta dem take break early mor-mor from di collation of di presidential results.
INEC don resume collation of presidential election results for Rivers state
Article Information
Author, Karina Igonikon
Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
Wetin we call dis foto, Rivers state INEC collation centre
Collation of results
of di Presidential election wey hold on Saturday 25 February 2023 from three
local goment areas for Rivers state: Ahoada West, Tai and Opobo/Nkoro don finish.
But di state collation officer
for di presidential election (SCOPE) Prof. Charles Teddy Adias step down
results from two local goments: Gokana and Abua/Odual becos dem no balance.
Dis na becos di number of
accredited voters suppose dey equal to di number of total votes cast (dis na di
sum of valid votes and rejected votes).
Wen di number of accredited
votes no tally wit di total number of votes cast, di figure no dey accepted.
Prof. Adias tell di LGA collation officers wey dey present di results to check dia figures and re- present am wen
announcement of results resume today.
Meanwhile, announcement of di
results of elections for Senate and House of Representatives dey go on at di
same time for dia different constituencies.
INEC also say dem go conduct
elections for places wia dem bin no conduct election becos of BVAS malfunction.
One of such places na 7 RAs for
Degema local goment areas wit INEC ad hoc staff no deploy to and elections go
hold for those areas today.
INEC for Uyo, Akwa Ibom resume collation of presidential elections wit Eket LGA
Wetin we call dis foto, INEC collation centre Uyo
INEC collation center for Uyo,
Akwa-Ibom state don resume di collation of di presidential election result.
Akwa Ibom get 31 local goment
areas, 4,353 polling units and 2,357,418 registered voters.
Dem announce 23 local goments
areas yesterday. E dey expected say dem go announce di remaining eight LGAs
today.
EKET LGA:
APC 4675
LP 13238
PDP 9757
NNPP 315
Breaking, Akwa Ibom don come back
Akwa Ibom state INEC officials don return to continue wit di collation of di presidential results.
Dem bin don first announce 23 local goments yesterday.
Akwa Ibom get 31 local goment areas, 4,353 polling units and 2,357,418 registered voters.
E remain eight local goments for dem to announce.
Police arrest suspects wey wan burn INEC office
Di Kano state Police Command say dem don arrest four suspects wey come to burn INEC office for Takai local goment inside di state.
According to statement wey Police tok-tok pesin SP Abdullahi Kiyawa release, di suspected criminals bin come to carry out dia plan as collation of results dey happun inside di INEC office.
“Na swift response from di police and oda security pipo stop dis attack and at di end, di workers continue dia collation peacefully.”
Meanwhile, Police say some group of thugs also attack campaign office of New Nigeria Peoples Party for Tudun Wada local goment wey lead to di death of two pipo.
Breaking, Rivers state don come back
Rivers state Inec officials don come back to continue wit di collation of di 2023 presidential election results.
Presidential election result collated by Inec for Kwara state
Wetin we call dis foto, Kwara INEC presidential result sheet
Kwara state breakdown as announce by Inec for di state:
Registered voters: 1,695,928
Accredited voters: 497,519
Total votes cast: 469,971
Total voided votes: 26,712
APC - 263,572
LP - 31,166
PDP - 136,909
NNPP - 3,141
Presidential election result collated by Inec for Ondo state
Di Vice Chancellor of di Federal
University Oye-Ekiti wey also be di Returning Officer for di collation of di
presidential results for Ondo state, Prof. Abayomi Fasina don announce di total
votes from di 18 local goment areas of di state.
See di breakdown:
Total Registered Voters 1,991,344
Total Accredited voters 571,402
APC 369,924
LP 47,353
NNPP 931
PDP 115,163
SDP 1,293
Total Valid Votes 550,998
Total Rejected Votes 19,009
Total Votes Cast 570,007
Presidential Election provisional result for Ogun State
Wia dis foto come from, AFP
Results from di presidential election for some South-west states don dey drop.
However, dis na provisional results
for di state level, di Independent National Electoral Commission go still
verify dem for di national level by 11am today.
Dis na di total collation of di presidential
result from di 20 Local Government Areas for Ogun state.
Di Vice Chancellor of di Federal
University of Agriculture Abeokuta, Prof. Kayode Adebowale wey also be di INEC
retuning officer announce di results.
Registered Vote 2687606
Accredited voters 612341
Total vote cast 611448.
APC - 341554
LP - 85829
PDP - 123831
NNPP - 2200
SDP - 738.
Ganduje son lose House of Reps seat
Article Information
Author, Mansur Abubakar
Role, BBC Pidgin, Kano
Wia dis foto come from, Credit Gandujiya Online
Kano state Govnor Umar Ganduje son lose im bid to represent Tofa/Rimin Gado for House of representatives afta im opponent Tijjani Jobe of New Nigeria Peoples Party defeat am.
INEC wey announce di result on Sunday tok say Jobe get 52,456 votes to defeat Ganduje wey poll 44,809 votes.
Im father Abdullahi Ganduje don serve as Kano govnor for eight years now and dey among govnors wey go step down on May 29 2023.
Breaking, Kano dey go on break
Inec officials say dem dey go on break for Kano and dem go resume by 11:00am.
Dem still get six more local goments to announce, out of 44.