Inec return APC Bola Tinubu as president-elect

Millions of Nigerians vote for di most competitive presidential election since military rule end. Sabi pipo say dis time, na three horse race.

Live Coverage

Victor Ezeama, Helen Oyibo, Jelilat Olawale and Annette Arotiba

  1. Senate beg Nigerians to dey peaceful

    The Nigerian Senate

    Wia dis foto come from, The Nigerian Senate/Facebook

    Di Senate don beg Nigerians to remain peaceful and support di processes leading to di collation and announcement of di 2023 presidential election results in line wit extant laws.

    Di Senate resolution follow adoption of a motion on di build up to announcement of election results by di Independent National Electoral Commission, Inec.

    Lawan say: “In di Electoral Act that we pass, nothing like di electoral transmission. Wetin we pass na to transfer afta all di paper work.

  2. 'Demands by PDP, Labour Party, ADC for cancellation of results dey impossible'

    Di presidential campaign council of di All Progressives Congress (APC) say demand by opposition parties calling for di cancellation of di presidential election dey impossible.

    PCC tok dis one in reaction to di press briefing wey three opposition political parties hold earlier.

    Di PDP, ADC and Labour party dey protest di conduct of di election wey hold on Saturday.

    Festus Keyamo, tok-tok pesin for di APC campaign say di INEC chairman go violate di Law if e cancel election process wey don start.

    “Dis requests no dey possible under di Law. Dem dey make illegal demand.”

    Di APC say di only remedy now na for di aggrieved parties to go court if dem no like di outcome of di election.

  3. 'Stop threatening di SCOPE’ - INEC Rivers

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
    INEC REC Rivers State
    Wetin we call dis foto, INEC warn against threatening di SCOPE for Rivers State

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) dey tell pipo wey dey send threat messages to di State Collation Officer for di Presidential Election, Prof Teddy Adias to stop am as e no get hand for di election results.

    Resident Electoral Commission of INEC for Rivers State, Dr Johnson Alalibo Sinikiem for media briefing emphasize say im function na just to collate results of elections time various local goment areas and so im no be supervising presiding office or presiding officer wey dey conduct elections for polling units.

    Dr Sinikiem also draw attention of di Election commissioner and of Police wey be di co-chairman of di Inter-agency Consultative Committee on Election Security to dis attempt to spoil di collation of di Presidential Election for Rivers State.

    Di State Collation Officer for di Presidential election Prof Teddy Adias bin suspend di collation exercise sake of death threats im receive since di election begin and say e no go kontinu wit di collation until INEC address di issue.

    So far, INEC don receive results from 21 local goments areas and remain results from two local goment, Degema and Obio Akpor remain.

    Meanwhile, di INEC REC announce di suspension of PHALGA 2 House of Representatives and Port Harcourt Senate elections for alleged irregularities.

    E say di Commission go conduct thorough investigation before dem go take any further actions.

  4. Different groups dey protest for INEC National Collation centre

    Pipo wey dey protest di election results

    Nigerians don arrange dey protest for di fromt of di collation building for Abuja.

    Dis dey come as protests don happun for states like Imo wey claim say election no hold for di communities.

    Di angry protesters for Abuja dey denounce di Independent National Electoral Commission (Inec) say dem tiff dia votes.

    One man tell BBC say, "everytin happuning dia na lies, all lies... dem just dey cook di results".

    Pipo wey dey protest
    Pipo protesters
    Pipo protesting

    Meawhile opposite dem supporters of Inec work arrange dia own protests.

    Wey dem ask di collation centre make dem kontinu di work wey dem dey do.

    Dia placards bin read, "Inec no dey intimidated by jokers".

    Dr Fatima Abdullahi from Nasarawa State say "we want di results to kontinu to dey called by di bodi wey dey tasked to run elections".

    Tensions dey already dey grow across di kontri, three days afta Nigeria vote for election wey spoil partially sake of kasala and ballot snatching.

    Opposition parties don call for fresh election, wey accuse Inec say dem dabaru di poll, accusation wey Inec deny.

    Di announcement of official results go soon start again.

    Pro protesters
    Pro protesters
    Pro protesters
  5. Breaking, PDP, LP and ADC demand for fresh election

    Three political parties for Nigeria dey demand for fresh election, dem say di presidential election dey “compromised”.

    Di three wey call for fresh elections na Peoples Democratic Party, Labour Party and African Democratic Congress.

    Julius Abure from LP, PDP chairman, Iyorchia Ayu and ADC Ralph Nwosu, tok dis one for joint press conference for Abuja on Tuesday.

    Dem add say manual transmission of results compromise diintegrity of di election process.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  6. Final result from state level for Delta state

    Delta state collation center
    Wetin we call dis foto, Final result from state level for Delta state

    Final presidential results from Delta state Collation Centre, Asaba don land.

    Delta state get 25 Local Government Areas and dis na di final result for di state level form Delta state as announced by di SCOPE.

    WARRI SOUTH WEST

    APC: 2,857

    LP: 2,591

    NNPP: 40

    PDP: 3,183

    FINAL RESULTS

    APC: 90,183

    LP: 341,866

    NNPP: 3,122

    PDP: 161,600

    Total Registered voters: 3,225,046

    Accredited voters: 667,149

    Valid votes: 615,341

    Rejected votes: 39,309

    Vote cast: 654,650

  7. 'Declare election inconclusive' - PDP tell INEC

    Ifeanyi Okowa and Atiku Abubakar

    Wia dis foto come from, Twitter/@IfeanyOkowa

    Wetin we call dis foto, PDP want make INEC declare election inconclusive

    Di Atiku/Okowa Campaign Organisation don ask di Independent National Electoral Commission (INEC) to cancel all di results dem don gada so far and declare di election inconclusive.

    One tok-tok pesin for di campaign, Daniel Bwala wey tok dis one for inside statement say di conduct of di 2023 presidential elections dey criticised acr

    Di Peoples Democratic Party President Campaign Council also want make di kontri electoral body suspend di national collation immediately and address di complain wey some parties raise as e relate to BVAS bypass plus di electronic transmission of result.

    Dis dey come afta PDP accuse INEC say dey refuse to follow di electoral act wey tok say all anomalies must dey corrected before di final declarations of result and returns.

    E add say many pipo don condemn di conduct of di 2023 general elections as one wey dey full of irregularities and no follow di electoral act.

  8. Breaking, National collation centre to resume by 2:00pm

    Collation of results for Inec national centre Abuja go resume by 2:00pm today.

    Dem bin adjourn am on Monday to 11:00am today.

    Five states dey ground and ready to go but dem wan give chance for more states to come.

    Before dem adjourn am, di returning officer for di presidential election, Inec oga, Prof Mahmood Yakubu bin don receive results of 14 states.

  9. Nigeria goment reply former President Olusegun Obasanjo

    Nigeria goment reply former president Olusegun Obasanjo
    Wetin we call dis foto, Nigeria goment reply former president Olusegun Obasanjo

    Nigeria goment don respond to one letter wey former President Olusegun Obasanjo write to president Muhammadu Buhari, say make e cancel di Presidential/National Assembly election wey hold for di kontri on Saturday 25, February on top accuse say magomago and electoral malpractice na im full am.

    Di Nigeria goment for inside one statement wey di Minister of Information and Culture, Lai Mohammed issue say di former president letter na calculated attempt to undermine di electoral process and to incite violence.

    And add say make di former Nigerian leader no scata di 2023 general elections wit im inciting, self-serving and provocative letters on di election.

    As di announcement of di presidential election dey go on for Abuja, di kontri capital on Monday, former President Olusegun bin issue one letter wey e address to President Muhammadu Buhari.

    E tok for inside di letter say make di electoral body save di kontri from “a looming danger” over wetin e describe as corruption of di electoral process.

    Di elder statesman allege say tension dey build up and e ask President Muhammadu Buhari to “cancel all di elections wey no pass di credibility and transparency test.”

    However, oga Lai say di former President organize di worst election since Nigeria return to democratic rule for 1999, so e no qualify to advise President Buhari wey dey try leave beta election legacy.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  10. ‘My life dey under threat for di work I dey do’ - Prof. Adias

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
    Prof. Charles Teddy Adias
    Wetin we call dis foto, Prof. Charles Teddy Adias suspend collation process

    Di State Collation Officer for di Presidential election (SCOPE), Prof. Charles Teddy Adias don suspend collation and announcement of result for di state level afta e complain of plenti threats to im life and family wey im dey receive since e start di work for di elections

    E say im name and foto dey all over social media with allegation say na im be di pesin wey dey rig election for Rivers State in favour of a particular party.

    Prof. Adias say im dey bombarded with plenti calls and text messages wey dey threaten im life and family and even display some social media posts about dis threats to im life.

    E emphasize say im work na just to receive reports of di results from LGA collation officers and e no get access to di figures of results or how dem conduct di elections and so e no deserve di threats e dey receive.

    Di Scope ask di security agencies and Inec to address di issues of threats e dey receive and so e adjourn further collation of results till Inec address dis threats e dey receive.

    Meanwhile, di commissioner of police on election duty to Rivers State, CP Aderemi Adeoye condemn dis threats to di Scope life.

    E add say whoever dey behind dis threats go get im say for court.

    E come advise di Scope to write a formal complaints about di threats to im life to di Commissioner of police so dem go launch investigations into di mata and assure am say di police go provide security for am for im house.

    CP Adeoye appeal to di Scope to complete di collation exercise so e no go affect wetin dey happun for di national collation centre and announcement of result. But e no gree.

  11. Breaking, Rivers state Scope allege threat to life, suspend collation of result

    Rivers state Scope Prof. Charles Teddy Adias don comot di state collation centre afta e say e no dey do again due to threats to im life and family.

    E want make dem suspend further collation of results till further notice until dis threats to im life dey addressed by INEC.

  12. Rivers state resume collation of results

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
    Rivers state collation centre

    Rivers State don resume collation of di presidential election results.

    Results from two local goments na im remain to complete di collation as 21 out of 23 local goments don already submit dia own.

    Di two local goment wey remain na Obio Akpor and Degema.

  13. APC reply former President Olusegun Obasanjo call for cancellation of election

    APC reply former President Olusegun Obasanjo

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, APC reply former President Olusegun Obasanjo

    Di All Progressives Congress Presidential Campaign Council don respond to one call by former President Olusegun Obasanjo wey say make di Nigeria electoral body, Inec chairman, Prof. Mahmood Yakubu cancel di elections wey mago-mago dey for di Saturday exercise.

    Di Special Adviser, Media, Communications and Public Affairs, APC PCC, Dele Alake for im response describe Obasanjo allegation as “coup to democracy” and add say im comments na move to disrupt di kontri democratic process.

    “Obasanjo repeat without no evidence rumours wey e pick say di Bimodal Voters Accreditation System dey compromised and di results wey Inec dey announce dey fraudulent.

    “E dey tragic say na former president wey suppose be elder statesman dey tok like dis to endanger and derail di democratic process for selfish, egoistic and malicious reasons.

    “E no get any evidence to prove im laughable and ridiculous allegations against Inec plus di credibility of di ongoing process.” Dele Alake tok.

    Di former two-time president for inside statement wey e address to president Muhammadu Buhari, e allege say di election process dey corrupted and most of di results wey no come from di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) and server no be di true reflection of di will of Nigerians wey don make dia choice.

    E allege say Inec officials don dey compromised plus di result don dey doctored as dem change to manual transmission. E say make President Muhammadu Buhari cancel di elections for areas wey no pass di credibility test.

    “Tension dey build up, make all elections wey no pass di credibility and transparency test dey cancelled and areas wia dem disrupt di election, make dem cancel and do am again on March 4, 2023 and make e change BVAS and server officials.”

    Obasanjo add say make di Inec chairmo do everytin to rectify di errors of di last two as “No BVAS, no result go dey acceptable and no upload through service, no result go dey acceptable.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  14. More results for di state level from Delta

    Delta state collation center
    Wetin we call dis foto, Delta state collation center

    State collation of di presidential election results for Delta State don resume today.

    Before now, 22 local goment bin don announce dia results out of di 25 Local Government Areas wey dey Delta State.

    Di three local goment areas wey remain na; Warri South, Warri South West and Isoko North.

    See latest result dem announce:

    Isoko North

    APC:2,734

    LP:17,765

    NNPP:105

    PDP:8,254

    Warri South

    APC: 1,234

    LP: 13,289

    NNPP: 177

    PDP: 7,653

  15. Wetin be di presidential results state by state so far?

    Lagos state Inec collation center

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Lagos state Inec collation center

    Nigeria Independent National Electoral Commission (Inec) don so far receive di results of 14 states for di national collation centre from di hands of di State Coalition Officers for the Presidential Election, Scope.

    Di winners for each state na as follows:

    Bola Tinubu:

    • Kwara state
    • Oyo state
    • Ogun state
    • Ekiti state
    • Ondo state
    • Jigawa state

    Atiku Abubakar

    • Osun state
    • Adamawa state
    • Gombe state
    • Yobe state
    • Katsina state

    Peter Obi:

    • Lagos state
    • Enugu state
    • Nasarawa state

    Remember, to win for di first round, a candidate must get di largest number of votes nationwide and at least 25% of di votes inside two-thirds of di 36 states plus di Federal Capital Territory.

    Na di Inec chairman wey be di returning officer for di presidential election go announce or call di winner of di election afta e don receive and accept all results from di states and di FCT.

  16. Final result for state level from Cross River

    Final result from  Cross River State

    Wia dis foto come from, Twitter/@Peterobi

    Wetin we call dis foto, Final result from Cross River State

    Dis na di final result for di state level from Cross River state as announced by di Scope.

    Di breakdown na as follows:

    APC:130,520

    PDP:95425

    LP: 179,917

    NNPP: 1644

    Registered voters: 1691642

    Valid votes: 416968

    Accredited votes: 416968

    Rejected votes: 24608

    Total votes:441576

  17. Final result for state level from Bayelsa State

    Atiku Abubakar

    Wia dis foto come from, Atiku Abubakar

    Dis na di final result for di state level from Bayelsa state as announced by di Scope.

    See di breakdown as follows:

    APC - 42572

    LP - 49975

    NNPP- 540

    PDP - 68818

    Registered voters -1056862

    Accredited voters -177368

    Valid votes -165325

    Rejected Votes -7786

    Total Votes Cast -173111

  18. EU observers criticise failures for Nigerian poll

    EU observers criticise failures for Nigerian poll

    Wia dis foto come from, ge

    Wetin we call dis foto, EU observers criticise failures for Nigerian poll

    One European Union observer mission don fault di lack of transparency and operational failures for di Nigerian election, according to dia preliminary findings.

    Confidence bin dey say di electoral body Inec bin dey independent and professional as dem dey prepare for di elections.

    But e no be so as public trust reduce sake of lack of correct planning and effective communication for di process - including on di election day, di observers tok.

    Nigerians bin vote for di presidential and parliamentary general election on Saturday.

    Di observers note say some poll centres open late and dem also no always follow polling procedures.

    Dem add say, uploading di results using electronic system no work, and dis don raise concerns as transmission of presidential election results forms delay.

    Di observer team don ask stakeholders for di election to uphold peace until dem complete di process and say make pipo address any palava wey arise through legal channels.

  19. Final results for state level from Kaduna

    Final results from Kaduna State.

    Registered Voters: 4,335,208

    Accredited Voters: 1,418,046

    APC : 399,293

    LP : 294,494

    NNPP : 92,969

    PDP 554,360

    Total Valid Votes : 1,360,153

    Invalid Votes : 41,223

    Total Votes Cast : 1,401,376

  20. Wetin don happun so far?

    National collation centre

    Inec national collation centre dey on break and go reconvene by 11:00am today afta dem begin receive results from di state level.

    See wetin don happun so far:

    • Inec don receive results from 14 states so far including Lagos, Kwara and Katsina.
    • PDP spokesperson Dino Melaye fault result announcement process for national collation centre, stage walk-out
    • Bola Tinubu call for calm afta losing Lagos to Peter Obi
    • Kwankwaso win Kano
    • Atiku win Adamawa, Katsina, Osun
    • Some states still dey collate result for di state level
    • Former Nigeria President Olusegun Obasanjo reject manual transmission of result