Inec return APC Bola Tinubu as president-elect
Millions of Nigerians vote for di most competitive presidential election since military rule end. Sabi pipo say dis time, na three horse race.
Live Coverage
Victor Ezeama, Helen Oyibo, Jelilat Olawale and Annette Arotiba
Sanwo-Olu call for calm afta report of violence for Lagos

Wia dis foto come from, Babajide Sanwo-Olu
Authorities for Lagos say evri wia dey calm afta report of fight-fight for some parts of di state on Monday morning.
Di report of violence happun afta Labour party win Tinubu for Nigeria commercial capital.
''No need for violence, dis no be part of our culture.''Govnor Babajide Sanwo-Olu tok.
''I dey beg all Lagosians to go about dia business without any fear of harassment''. e add.
Di govnor say dem don ask law enforcement agencies to make sure say no breakdown of law and order for any part of di state.
Sanwo-Olu advise pipo for di state to remain calm as im assure dem say eviritin go dey alright.
We be peaceful pipo and na so we go remain.
Viral Video: Police arrest four officers wey involve for electoral malpractice for Rivers State
Di Rivers state police command say dem don arrest four of dia personnel wey video capture on di presidential election on Saturday.
Di command say dem arrest one officer and three inspectors on top allegation of election malpractice.
Video bin capture di officers inside one pick up vehicle wit inscription "RRT 050" dey follow suspected political thugs commit electoral malpractice, Grace Iringo-Koko, police tok-tok pesin confam.
“Di Rivers State Police Command don arrest and take into custody one officer and three Inspectors for interrogation.
“Di Command hereby assure di electorate in Rivers State of dia pure commitment to promoting di rule of law and ensure say all offenders dem find guilty go chop sanction.”
Enugu state presidential election results

Wia dis foto come from, Peter Obi/Facebook
Di presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi, don win Enugu State, Southeast Nigeria.
Na di state collation officer, Prof Maduebibisi Ofo Iwe announce di result of di election wey happun on Saturday.
Enugu presidential election result;
APC – 4,772
LP – 428,640
NNPP – 1808
PDP - 15,749
Calm don return to Lagos Island post election kasala

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Soldiers for Lagos Street for Post election gbas-gbos Soldiers from di Nigerian Armed Forces dey patrol some streets for Lagos Island on 27 February, to secure di pipo and property.
Dis na after hoodlums bin go harass some market owners as Nigerians dey continue to wait for di result of di Saturday presidential election.
Police say things don go back to normal and di APC candidate Bola Ahmed Tinubu plus Govnor Babajide Sanwo-Olu don also call for calm.
Tinubu say just because Labour Party win di state no mean say make kasala burst sake of say, di beauty of democracy na say pipo get right to vote di candidate wey dem like.
Govnor of di state, Sanwo-Olu report cases of friction but sat law enforcement don get order say make kasala no burst.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images
Tinubu speak afta Obi take lead for Lagos

Wia dis foto come from, Bola Tinubu
Di Presidential candidate of di All Progressives Congress party tell di pipo of Lagos state to dey calm.
Bola Tinubu tok dis one for inside statement wey APC presidential campaign council release on Monday
Dis statement dey come afta Labour party win am for Lagos state for di provisional result wey state Inec announce.
Di result go still dey presented to di INEC chiarman for di national collation centre wia dem go announce di official result.
Di Labour party win for Lagos dey significant as Bola Ahmed Tinubu, govern di state from 1999 to 2007.
Tinubu tell residents make dem no do anytin we fit lead to breakdown of law and order.
‘’Di beauty of democracy na say pipo get di right to vote for di candidate of dia choice.’’ Tinubu tok
‘’A democrat must accept di outcome of any election whether e favour you or not.’’ E add.
Dem say di fact say APC narrowly lost Lagos State to another party no be reason for violence.
Party agents accuse collations officers of mago-mago for Akwa Ibom
PDP agent, Dino Melaye tok why e para for INEC chairman for collation centre
Agent of di PDP, Dino Melaye bin raise objections durind di presentation of results for di national collation centre, Abuja.
E bin demand discontinuation of di process until im party views dey heard.
Di INEC chairman caution Oga Dino make e no ''distrupt'' di process.
Di tok to tori pipo afta di centre announce one hour break.
States wey INEC don receive presidential results so far, Tinubu don win five states so far

Wia dis foto come from, Facebook
INEC don go on break from di national collation of di presidential election results wey just happun ova di weekend.
So far for di four states na APC Bola Ahmed Tinubu and PDP Atiku Abubakar dey lead.
Tinubu dey lead for Ondo, Ekiti and Kwara States while Atiku win for Osun state.
See di breakdown of di results wey INEC chairman Yakubu Mahmood don recieve so far:
Ondo State
- APC 369,924
- LP 4,405
- NNPP 930
- PDP 115,463
- Valid votes 548063
- Rejected votes: 19009
- Total votes cast 570017
- Registered voters 1,991,344
- Accredited voters 571,402
Osun State
- APC 343,945
- LP 23,283
- PDP 354,366
- NNPP 713
- Valid votes 733,202
- Rejected votes 23,541
Ekiti State
- APC 201,494
- PDP 89,554
- LP 11,397
- NNPP 264
Kwara State
- APC 263,572
- LP 31,116
- NNPP 3,141
- PDP 136,909
- Registered voters: 1,695,927
- Accredited voters: 497,519
Ogun State
- APC: 341,554
- PDP: 123,831
- NNPP: 2,200
- LP: 85, 829
- ACCREDITED VOTERS: 612,341
- TOTAL VOTES CAST: 611,448
- TOTAL VALID VOTES: 580,124
- TOTAL REJECTED VOTES: 31,324
Oyo State
- APC: 449,884
- PDP: 182,977
- NNPP: 4,095
- LP: 99,110
- ACCREDITED VOTERS: 854,439
- TOTAL VOTES CAST: 851,956
- TOTAL VALID VOTES: 809,485
- TOTAL REJECTED VOTES: 42,471
Yobe State
- APC: 151,459
- PDP: 198,567
- NNPP: 18,270
- LP: 2,406
- ACCREDITED VOTERS: 398874
- TOTAL VOTES CAST: 397,331
- TOTAL VALID VOTES: 378,397
- TOTAL REJECTED VOTES: 18,934
Enugu State
- APC: 4,772
- PDP: 15,749
- NNPP: 1,808
- LP: 428,640
- TOTAL VOTES CAST: 468,891
- TOTAL VALID VOTES: 456,424
- TOTAL REJECTED VOTES: 12,467
Lagos State
- APC: 572,606
- PDP: 75,750
- NNPP: 8442
- LP: 582,454
- TOTAL VOTES CAST: 1,335,729
- TOTAL VALID VOTES: 1,271,451
- TOTAL REJECTED VOTES: 64,278
Gombe State
- APC: 146,977
- PDP: 319,123
- NNPP: 10,520
- LP: 26,160
- TOTAL VOTES CAST: 533,778
- TOTAL VALID VOTES: 510,043
- TOTAL REJECTED VOTES: 23,735
Jigawa State
- APC: 421,390
- PDP: 386,587
- NNPP: 98,234
- LP: 1,889
- TOTAL VOTES CAST: 954,805
- TOTAL VALID VOTES: 920,531
- TOTAL REJECTED VOTES: 34,274
Adamawa State
- APC: 182,881
- PDP: 417,611
- NNPP: 8,006
- LP: 105,648
- TOTAL VOTES CAST: 761,621
- TOTAL VALID VOTES: 731,140
- TOTAL REJECTED VOTES: 30,481
Katsina State
- APC: 482,283
- PDP: 489,045
- NNPP: 69,386
- LP: 6,376
- TOTAL VOTES CAST: 1,091,187
- TOTAL VALID VOTES: 1,058,673
- TOTAL REJECTED VOTES: 32,514
Tinubu performance for presidential election for Ondo state
From di result wey di state returning officer for Ondo state Fashina Abayomi Sunday present to di INEC chairman on Monday, na di candidate of di All Progressives Congress Bola Ahmed Tinubu win for di presidential election for Ondo state.
Di number of votes wey im poll dey below:
Registered voters 1, 991,344
Accredited 571402
APC 369,924
PDP 115,463
LP4405
NNPP 930
Breaking, INEC take one hour break
Di Independent National Electoral Commission National Collation Center for Abuja don take one hour break.
INEC Chairman, Mahmood Yakubu announce di break afta e accept di presidential results from Kwara, Osun and Ondo states.
E say dem go resume afta oda states results don enta.
So far, INEC don receive presidential results from Ekiti, Osun, Ondo and Kwara states.
Read more: Full results announced so far
Atiku lead Tinubu, Obi, odas for Osun state
Di Independent National Electoral Commission don receive di presidential election results of Osun state.
See di result as di returning officer present to di INEC chairman for di national collation centre, Abuja.
APC 343,945
LP 23,283
PDP 354,366
NNPP 713
Valid votes 733202
Rejected votes
23541
Prof Folashade Ogunsola (SCOPE)
- Full results announced so far
'I hear di sound of gunshot, den I feel blood dey flow for my face'
APC performance for presidential election for Kwara state
Inec don accept di result wey di returning officer for Kwara state present for di national collation centre, Abuja.
Agent of di PDP, Dino Melaye raise objections, and want discontinuation of di process until im party views dey heard.
Check below for di result:
Registered voters: 1695927
Accredited voters: 497519
APC 263,572
LP31,116
NNPP 3141
PDP 136,909
More results from Rivers state
Latest from Rivers state Inec.
Na Inec go announce di final winner of di states and general winner.
GOKANA LGA (Re-presented)
Registered voters: 140870
Accredited voters: 27866
APC - 10122
LP - 2215
NNPP – 31
PDP - 8484
Valid votes: 25331
Rejected votes: 2204
Total votes cast: 27535
LGA Collation Officer: Prof. Robinson Monday Oruru
Even though di figures no balance and e different from wetin e bin present yesterday, di SCOPE still accept am
OMUMA LGA:
Registered voters: 65289
Accreditedvoters: 10226
APC - 6328
LP - 2154
NNPP – 15
PDP - 1293
Valid votes: 9971
Rejected votes: 236
Total votes cast: 10207
EMOHUA LGA:(Re-presented)
Registered voters: 118221
Accreditedvoters: 21092
APC - 9145
LP - 4239
NNPP – 18
PDP - 5242
Valid votes: 19149
Rejected votes: 1896
Total votes cast: 21045
BONNY LGA
Registered voters: 83378
Accreditedvoters: 17496
APC - 2708
LP - 10488
NNPP – 87
PDP - 2406
Valid votes: 16365
Rejected votes: 1131
Total votes cast: 17496
Ogba Egbema Ndoni
APC - 6057
LP - 21883
NNPP – 109
PDP - 4099
Akuku Toru
APC - 3182
LP - 1700
NNPP – 14
PDP - 3131
Andoni
APC - 3306
LP - 2324
NNPP – 18
PDP - 4614
Ikwerre LGA
APC - 9609
LP - 8752
NNPP – 58
PDP – 4869
Okrika LGA
APC - 2729
LP - 4018
NNPP – 34
PDP - 8476
Ogu/Bolo LGA
APC - 2428
LP - 1209
NNPP – 7
PDP - 3187
ABUA/ODUAL LGA - (RE-PRESENTED)
APC - 5653
LP - 1663
NNPP – 9
PDP - 4685
OYIGBO LGA:
APC - 16630
LP - 10784
NNPP – 107
PDP - 1046
ASARI TORU LGA:
APC - 14483
LP - 2094
NNPP – 9
PDP - 4476
Port Harcourt LGA
APC - 5562
LP - 62,451
NNPP – 301
PDP – 7203
Ahoada East LGA
APC - 8066
LP - 5379
NNPP – 58
PDP - 2358
Provisional result by INEC for Oyo State
Provisional result wey INEC don announce for Oyo state presidential election show say na APC take di lead for di state.
But INEC for national level go need ratify di result from di state before dem go declare di official winner for Oyo State.
Registered Voters: 3,237,310
Accredited Voters: 854,439
APC - 449,884
PDP -182,977
LP - 99,110
NNPP - 4,095
Dis na provisional result wey di state INEC go carry go di national collation centre for Abuja for ratification.
Kano state INEC collation centre don go break

Wetin we call dis foto, Kano collation center Meanwhile for Kano state, INEC don go on break as some oda local goment areas neva show for di collation centre.
Meawhile, di latest dem announce na from Fagge and Nasarawa LGAs in addition to di one wey dem don announce before.
Na Inec go announce di final winner of di states and general winner.
Fagge LGA
Total registered of voters: 274031
Accredited: 49816
APC 4060
PDP 5416
LP14896
NNPP23162
Nasarawa LGA
APC 10218
PDP 10599
NNPP 61053
LP 3863
Breaking, PDP, ADC, Action Alliance odas reject Ekiti election
PDP, Action Alliance, ADC allege overvoting, reject Ekiti state election wey Inec oga call for APC.
Breaking, Inec national collation centre don open for today
Inec national collation centre don open for today.
Di final announcement from di collation centre for Abuja today dey start with di presentation and ratification of results from Kwara, Ondo, Osun.
