You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lagos state goment don relax curfew
Youths for Nigeria protest police brutality and di activities of di Special Anti-Robbery Squad (SARS).
Live Coverage
Why I carry my pikin for back dey do End Sars protest
Presidential panel on police reforms okay 5-point demand of End Sars protesters
Lagos govnor join ENDSARS protesters, assure dem say im dey go meet President Muhammadu Buhari wit dia demands
Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu join di ENDSARS protesters for Alausa area of Lagos wey dey call for di end of police brutality today.
Di govnor for di protest say im dey in support of di protesters agitations and im dey go Abuja to meet wit di President Muhammadu Buhari to present dia demands give am.
Di protesters bin write letter wey dem list their demands give di govnor
Part of di demands na make goment release all arrested protesters, set up independent body wey go torchlight police misconducts, increase police salary, among odas.
For Lagos state, Oga Sanwo-Olu say im don take some steps to meet di demands of di protesters:
- He say im don order make dem immediately set up trust fund to compensate di families of pipo wey don die sake of police brutality. Di govnor say members of di public n aim go appoint di team wey go supervise di trust fund.
- Oga Sanwo-Olu say im don direct di Lagos Commissioner of Police to release all di protesters dem arrest as every citizen get right to peaceful protest.
- He say dem go release di protesters dis night.
Your mustache don tok am finish - Genevieve blast Wike
Ogbonge Niaja actress Genevieve Nnaji don follow oda Nigeria celebs join mouth for di ENDSARS protest as she blast Riivers state govnor Nyesome Wike, for wanting to ban protest for im state.
Genevieve yab di govnor biebie, call am dictator join.
Three reasons why #EndSARS Nigeria protest fit no end soon
Why Aisha Yesufu dey wear hijab protest EndSARS for Nigeria
Five things Buhari fit do now to #EndSARS protest afta e dissolve SARS
Lagos Govnor join SARS Nigeria #EndSARS protests
"I joined di #ENDSARS protesters inside Alausa and receive letter of dia demands and once again I wan show my support."
Na wetin Babajide Sanwo-Olu tweet Tuesday afternoon after e receive Lagos protesters for State House Lagos.
Di Lagos State Govnor say im dey go to Abuja to meet with President Buhari and di goal of di conversation dey clear (To tell am di demands of di protesters).
Dis mama and pikin join Lagos #EndSars protest today as Port Harcourt protesters no look Wike face
End SARS protest still dey go on for Port Harcourt, Aba, Enugu Ibadan, Lagos, Jos, Abuja and some oda places for Nigeria.
Di Protesters want make authorities arrest and prosecute police officers wey dey involved for di deaths and harassment of citizens to show say dem dey serious to reform police.
Meanwhile Kate Henshaw, Falz, Hilda Dokubo, M.I and odas dey among Nigeria Celebs wey come out today to join di Endsars protest for Lekki Toll gate inside Lagos.
Endsars Protester for Lekki don arrive AIG office
Endsars Protester don arrive AIG office today. Celebrity come presents dia demand to di police.
Fotos from EndSars protest for Port Harcourt
EndSars protest still gon for PortHarcourt, Rivers State even though di Governor, Nyesom Wike don ban everi form of protest.
Di demonstrator no send di order wey di executive governor for di state don put.
End SARS protesters tanda near Goment House Port Harcourt, Gov. Wike domot to demand ansas
For di Southern Nigerian city of Port Harcourt End SARS demonstrations don start to happun even though say di Rivers State Governor ban any form of protest.
Yesterday na im goment ban protests for port Harcourt becos di Inspector General of Police, Mohammed Adamu, don already scrapped di Special Anti-Robbery Squad so no need for any form of protest against a Unit of di Police Force wey no longer dey exist.
Endsars Protesters for Lekki Toll Gate
Pipo wey dey protest against police brutality alias #Endsars don gada continue with day 7 of dia protest for Lekki Toll Gate, Lagos.
Celebrities like Kate Henshaw, Falz, Hilda Dokubo, M.I and oads no dey left out for dis protests as dem too join some Nigerian youth to demonstatre.
EndSARS protest live from Port Harcourt
For di Southern Nigerian city of Port Harcourt End SARS demonstrations don start to happun even though say di Rivers State Governor ban any form of protest.
Yesterday na im goment ban protests for port Harcourt becos di Inspector General of Police, Mohammed Adamu, don already scrapped di Special Anti-Robbery Squad so no need for any form of protest against a Unit of di Police Force wey no longer dey exist.
Day 7 of EndSars Protest for Lagos- Demonstrators don ready for anoda waka
Endsars demonstrators wey dey protest against police brutality for Nigeria don dey ginger for day seven of dia protest even though di Inspector General of Police, Mohammed Adamu don dissolve SARS on Sunday 11, October.
Here na fotos of dem;
Wike don ban #EndSars protest for Port Harcourt - See wetin protesters wan do next
Rivers State Govnor Nyesom Wike don ban everi form of protest ahead of today #EndSARS protest wey plan to hold for Port Harcourt.
Di southern Nigeria state draw warning give residents say because di oga patapata of Police don disband SARS division, no reason dey to protest again.
Di Rivers State Goment say don ban all forms of protests throughout di State and so all proposed protests under #EndSARS Campaign dey prohibited.
Goment take di decision becos di Inspector General of Police, Mohammed Adamu, don already scrapped di Special Anti-Robbery Squad so no need for any form of protest against a Unit of di Police Force wey no longer dey exist.
For statement wey di state Commissioner for Information Paulinus Nsirim release, e come advise Parents and Guardians to ensure say dia pikins dem no violate dis order.
Law enforcement agencies also dey directed to ensure say di ban dey enforced and pipo wey violate am face di consequences.
Dis order dey come as pipo for Port Harcourt wan join di #EndSARS campaign on Tuesday 13 October, 2020 in front of di Port Harcourt Pleasure Park along PH-Aba Expressway.
Meanwhile, Chairman of Board of trustees of Port Harcourt Human Rights Advocacy campaign I.B.T. Tariah wit oda bodies like Rivers State Judiciary and oda concerned citizens on 9 October 2020, bin don write to di Commissioner of Police say dem wan do peaceful #EndSars protest for Port Harcourt on 13 October before dis order comot.
BBC Pidgin go monitor weda or not di protest gi still hold for Port Harcourt.
'Na my driver dem shoot die for End Sars protest'
Nigerians react to Davido meeting with police
Plenty reactions don follow Nigerian Singer David Adeleke alias Davido meeting wit police earlier today.
Davido for inside one video wey don go viral tok say im no dey part of di protest wey dey call for di end of di SARS, wey dey go on for Abuja and for oda parts of di kontri.
For di meeting, di singer insist say im want open door meeting wit di IGP as wetin pipo dey reason na say im come for closed doors meeting wit di police oga but di IGP say “How you fit come here for closed door meeting wen you dey protest yesterday and you identify wit di protesters?
Davido reply say,”I no protest, I no dey dia to protest, I dey dia to calm things down” But di IGP tell Davido say im don already take action wey show say im dey speak for young people and e go dey difficult for pipo to tink otherwise.
Di one minute forty four seconds video don cause kasala for social media as pipo begin drag Davido say im deny di #ENDSARS protesters wey dey call for end of police brutality, others say dem no see anything wey wrong for wetin im tok.
End Sars protest spread to University of Lagos
Some students of University of Lagos join di End Sars protest today.
Aside from students, oda pipo also join di End Sars protesters with placards and songs as dem begin demonstrations from di gate of di University of Lagos to Ikorodu road.
See fotos from di protest.