You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Lagos state goment don relax curfew

Youths for Nigeria protest police brutality and di activities of di Special Anti-Robbery Squad (SARS).

Live Coverage

  1. Ogun State govnor free #EndSARS protesters

    Ogun state govnor, Dapo Abiodun don announce say police don free protesters for End SARS.

    Tori be say some vandals enta about three police statiions for di states tiff tins.

    However, oga Abiodun tok for statement, say make dem free all di protesters wey dey bin arrest and only investigate di pipo wey do vandalism.

    Dis na as e tok say freedom of peaceful assembly na di right of every Ogun citizzen.

  2. #EndSARS protesters for UK enta Nigerian Embassy

    Protesters for di #EndSARS don pack demselves land for di Nigerian Embassy fro London.

    Tori be say Nigerian star, Wizkid go show face for di protest even as ex Big Brother Naija housemate, Mike Aireyys don already dey di grounds.

  3. Lagos Protesters don gada for govnor house

    #EndSARS protesters don gada for front of di govnor's house for Marina, Lagos Island, South West Nigeria.

    Dis na some pictures from di protest wey dem dey do.

  4. Aso Rock guard chase away #EndSARS protesters wey wan enta demonstrate go presidential palace

    Aso Rock guard chase away #EndSARS protesters wey wan enta demonstrate go presidential palace on Sunday morning.

  5. More pictures from protests today

    See some pictures from di #EndSars protest from Lagos and Abuja today.

  6. Ondo governorship election result

    To see Ondo State governorship election result make you enter di link below.

    • Ondo State Governorship election result
    • Live-text commentary on Ondo State governorship election
  7. Buhari, Osinbajo daughters tweet support for #EndSars

    Nigeria President Muhammadu Buhari daughter Zahra Buhari and di Vice President Yemi Osinbajo daughter Kiki Osinbajo don speak out about di anti-police brutality protests.

    While di first daughter Zahra put up post for her Instagram story wey say #EndPoliceBrutality, Kiki post ontop Instagram same picture wey say #EndPoliceBrutality and #EndSars.

  8. Timeline of #EndSars mata, ...how e start and wia e dey now

    End SARS be like ring tone wey Nigerians don dey sing for long time.

    But how we take reach here?

    • Saturday 3rd September, tori start to dey trend on top social media say SARS officials, shoot and kill pesin for Ughelli, Delta state. Dat tori even though police later confam say nobody die, make Nigerians begin dey tok wetin dem face for Police hand ova di years.
    • Sunday 4th February, celebrities and influential personalities, like Wizkid, Naira Marley, Teni and odas dem start to dey add dia own influence ontop di mata. In fact controversial musician, Naira Marley announce say im dey comot on Tuesday to do protest ova di police brutality.
    • Same day, Nigerian police announce di ban on F-SARS patrol duty.
    • Monday 5th September, Naira Marley comot for social media say e don follow police tok and e no go run im protest again. E follow di tok-tok pesin for police Frank Mba tok on top how police wan take carry out reforms.
    • Thursday 8th September, Runtown and Falz organize protests for Lekki, Lagos to police command for Onikan.
    • Social media stars like Mr Macaroni also follow sleep for di front of House of Assembly to chook di mata enta goment ear. Buhari respond say na Nigerians right to protest and e dey tok with di IGP to see how dem go fit reform di Police Force.
    • Friday 9th September Anoda peaceful protest happun for Lagos, as even mothers join di protest for police ot stop dey kill dia pikin. However, for Abuja na different tori we hear, say di protesters jam police officers wey spray dem with tear gas even as president Buhari say dat one bin no dey necessary.
  9. Social media reactions and more about #EndSars day three protests

    Nigerian youths enta road for di third day to shout end sars for different states across di kontri to call for di end of police brutality.

    From Awka, ogbomoso to Lagos, dia message dey very clear. Dem want di goment to scrap Sars and stop police brutality.

    But no be only road dem raise dia voice.

    Even for social media, di #EndSARS na di number one trend for di kontri and many of dem dey use am to tok dia mind about di mata.

  10. Wetin Nigeria goment don tok?

    Yesterday night Nigeria President Muhammadu Buhari receive briefing from National Security Adviser ontop di mata.

    President Muhammadu Buhari receive briefing from National Security Adviser Maj. Gen. Babagana Monguno (Rtd), wey Coordinate di Presidential Amnesty Programme.

    Col. Milland Dixon Dikio (Rtd) escort am to State House, Abuja on Friday.

    Di presido say dem dey give am regular updates ontop dia plans to end police brutality and unethical conduct to make sure say police dey fully accountable to di pipo.

  11. Nigerians for Canada join di #EndSars protest

    Nigerians for Canada don join di End SARS Protests wey don enta di third day for across Nigeria and di world.

    Some Nigerian gada for inside Dundas Square for Toronto Canada today dey protest say “Benz no be yahoo-yahoo”, even as dem dey play Afrobeat music.

    Some Nigerians don plan multiple oda protests for di coming days for di London, United Kingdom and Berlin, Germany.

    See more fotos from di demonstration.

  12. Burna Boy create 'fund' for #EndSars prtotesters

    Nigerian Musician Burna Boy don come out to say why im never chook im mouth for di end SARS mata since e start na say im don create fund for protesters wey don dey harassed or arrested by SARS during or even afta di protest.

    E also say im create di Miseducation foundation wey go teach Nigerians dem about dia history so dat everything go fit clear.

    Burna boy tok for di statement say di major wahala wey young pipo dey face na profiling,

    Dis go be di first time di 'Twice As Tall' star go chook mouth for di End SARS protest since im start dis time.

  13. Some background informate to understand di end sars mata

    Di Special Anti-Robbery Squad (SARS) na unit within di Nigerian Police.

    Dem form am for 1992 to end cases of armed robbery and kidnapping for di kontri.

    Dia operations extend to dey burst internet fraud gangs and cult groups for inside public universities.

    But many youths don accuse di unit say dem dey do selective justice, disregard rule of law and dey harrass pipo.

    Dis no be di first time #endsars go trend as youths dey demand and end to di activities of di special unit but dis na di first time di hashtag go trend for one week straight, enta streets as e don enta and cath di attention of di international community.

    Dis latest round of protests start on Saturday 2, October, 2020.

  14. Una welcome!

    Una welcome to our live page about di #EndSars protests wey dey happun across Nigeria and around di world.

    Stay with us as we give una live updates of all di actions as dem dey happun as youths for Nigeria dey call on goment to end police brutality and di Special Anti-Robbery Squad (SARS).