Jaguda pipo don take ova End Sars protest – Lai Mohammed
Nigeria goment say dem no go sidon look while di kontri become lawless sake of di violence wey dey happun for di End Sars protest.
Di kontri minister of information and Culture. Lai Mohammed, say as tins dey so, jaguda pipo plus pipo wey get oda agenda don hijack di protest and dia plan a to destabilise di kotri.
Di Minister tok dis one for di late night programme “Weekend File” wey local tori pipo Nigeria Television Authority do Sunday night.
Oga Mohammed say as e be so, federal goment don meet di demands of di group and don begin implement am sef.
Im add say, true-true di original conveners bin mean well but e dey obvious say dem no dey in control again.
E say, “peaceful protest na important part of democracy and dat na why since di last 11 days federal goment dey treat protesters well.
“But if you look wetin happun to di govnor of Osun state, e don comot from peaceful protest against excesses and abuse of power by police.