You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Lagos state goment don relax curfew

Youths for Nigeria protest police brutality and di activities of di Special Anti-Robbery Squad (SARS).

Live Coverage

  1. Breaking, Sanwo-Olu dey address Lagosians

    Govnor of Lagos state Babajide Sanwo-Olu dey adress Lagos residents right now as tension full ground day afta at least 30 pipo injure afta security operatives fire dem live bullets.

  2. Armed sojas fire live bullets at thousands of #EndSARS protesters for Lagos

  3. At least 30 injure for Lekki toll gate End SARS shooting - See di latest on di tori

  4. Clinton ask Buhari, Nigeria Army to stop killing #EndSARS protesters

  5. Adamu Garba sue Twitter $1bn damage for #EndSARS protests

  6. Governor Fayemi order 24hr curfew for Ekiti State

  7. IGP order riot police to immediately enta streets over #EndSARS protests

  8. Senate ask Buhari to address Nigerians on EndSARS protests immediately

  9. How EndSARS protest for Kano burst into violence

  10. Lagos state goment declare 24-hour curfew for di state

  11. Hoodlums burn Orile police station for Lagos

  12. Kogi Govnor Yahaya Bello volunteer to lead End Sars Protesters

    Kogi state govnor, Yahaya Bello don volunteer imself to be di leader of di END SARS protesters wey dey protest for two weeks now against police brutality for di kontri.

    Oga Bello wey tok dis one for im address to di youth on Monday announce say on Wednesday 21 October im go lead Kogi State youth and all di End Sars protesters go present dia demands to President Muhammadu Buhari for Abuja.

    He say time don reach for di leaders of di protesters to come out and engage wit goment.

    According to am, “e dey difficult for goment at all levels to solve some of di issue as leaders no dey and goment dey fear make opportunist no hijack di gains of di protest.”

    E warn dos wey dey sponsor di protest outside di kontri to mind dia business and no come scata Nigeria wey get law and order.

    Di govnor still beg di protesters, especially di once wey dey Kogi state make dem no block road for pipo wey dey go about dia lawful business as e go dey against di rights of road users.

  13. See websites Anonymous don claim to hack for Nigeria

  14. Wetin APC national leader Tinubu tell End SARS protesters

  15. See how long Lagos schools go close down for EndSARS protest

  16. See how Benin Prison break take happen

  17. Obaseki don set panel to investigate #EndSARS protests for Edo

  18. Soro Soke FM - Wetin we know about di EndSARS online radio

  19. Obaseki declare 24-hour curfew, hoodlums hijack End Sars protest for Benin - See latest from Edo

  20. Jaguda pipo hijack End Sars protest for Benin, free suspects for police custody,

    Nigeria police say Jaguda pipo wey hijack di #ENDSARS protest for Benin, Edo state don free suspects wey dey custody for Ugbekun Police Station, Oba Market Police Station and Idogbo Police Post and tiff arms and ammunition from di armoury.

    Di Nigeria Police Force wey confam di incident wey happun dis Monday, 19 October for dia Twitter handle say, dem neva dey sure di extent of di damage.

    Police claim say di protesters also set di facilities on fire.

    Di Police Force say dem dey do everything possible to bring di situation under control, protect lives of innocent citizens and prevent further attacks on any serious infrastructure for di state.