You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lagos state goment don relax curfew
Youths for Nigeria protest police brutality and di activities of di Special Anti-Robbery Squad (SARS).
Live Coverage
LCC claim dem no comot security camera before Lekki shooting
Lekki Concession Company Limited (LCC) wey dey manage di Lekki commerical toll gates, wia many End SARS protest don happen for, don comot to explain wetin happen with light on di evening of Tuesday 20 October.
Inside statement, LCC say e just happen say regular light no dey, and because curfew dey in place for Lagos, nobody dey around to on di backup generator.
Di company also deny say dem comot dia security cameras just before di shooting of protesters happun.
"Order no come from ANYONE to comot di perimeter CCTV cameras," company statement bin tok.
Many pipo don accuse LCC say dem remove di cameras around di toll gate area so that evidence no go dey say soldiers shoot live ammunition at unarmed protesters.
Dis wan happen after one photo begin circulate for social media wey show one man wey wear LCC company jacket, carry wetin be like CCTV cameras for di toll gate.
See Nigerian states wey impose curfew for #EndSARS protest
See Lagos properties wey violence destroy afta #EndSARS protest
Breaking, Delta state declare 48 hours curfew
Governor Ifeanyi Okowa don declare 48 hours curfew for di state.
For inside State broadcast, e say make evribodi for di state go sidon for house and after di 48 hours, dem go review di situation to see di next step to take.
Di Governor also close down all public and private schools till Monday 2 November, 2020.
UK shut down Visa application centres for Nigeria
Di United Kingdom don shut down dia visa application centres for Nigeria sake of di kasala wey don burst on top End SARS protests.
Di UK wey make dis one known on top dia website say dem go close di centre for at least 48 hours .
Di statement further explain say di decision na to guarantee di safety of both staff and applicant.
Dis one mean say applicant wey book appointment within dis period gatz reschedule to next week from di 26th October 2020.
Di embassy say dem go dey post regular updates on wen dem go open and urge applicants to kontinu to check.
Meanwhile, di US also don shutdown dia embassy for two days .
AU condemn violence for Nigeria, call for dialogue
Di African Union don "strongly condemn" di violence against anti-police brutality protesters for Nigeria.
Di Chairperson of di AU Commission, Moussa Faki, tell both "political and social actors" to "respect human rights and di rule of law".
He hail di disbandment of di Special Anti-Robbery Squad (SARS) and encourage investigations to ensure "Say dem hold pipo wey carry out di acts of violence to account".
Di regional bloc, Economic Community of West African States (Ecowas), call for dialogue between di Nigerian goment and di protesters.
Ecowas tell both parties to exercise caution as protests continue.
"In dis regard, Ecowas commission call on all protesters to remain peaceful in di conduct of dia demonstrations. E also tell di Nigerian security operatives to exercise caution in di handling of di protests and act professionally," one statement tok.
Why Buhari still remain silent? - Fayose
Former govnor of Ekiti state, Peter Ayodele Fayose, dey wonder why Nigeria president Muhammadu Buhari, still remain silent afta di Lekki Tollgate Plaza shooting.
Di former govnor dey wonder weda Buhari still be di president wey Nigerians elect and weda “a father fit to keep quiet for dis long wen im own security guards kill im children wey dey only beg am for food?”
Im add say, “no true president of any kontri go wait make dem beg am to speak to im pipofor dis kain critical time. As e be so, pesin don begin dey believe say sometin dey wrong somewhere.”
Yemi Osinbajo speak on Lekki toll gate shooting
#EndSARS protesters die for Lekki toll gate shootings - Femi Gbajabiamila
Channels TV do temporary shut down of transmission sake of threat of attack
Oyigbo Divisional police station, Rivers burn, at least one pesin die
Kasala burst for Oyigbo local goment for Rivers State after End sars protest turn violent and at least one pesin don die.
Local tori pesin Allwell Ene BBC Pidgin say youths for Oyigbo bin dey do End Sars Protest come pass di Oyigbo Divisional Police Station wia di police come shoot gun and bullet reach one of di protesters.
Dem rush am go hospital but di hospital pipo no gree treat am, dey demand police report and di pesin come die from di gunshot injuries.
Dis make dem burn di hospital wey refuse to treat and di Oyigbo Divisional Police Station too.
Tok tok pesin for Rivers State Police Command, Nnamdi Omoni confam di burning of di Oyigbo
Divisional Police Station but say dem wan go investigate to see wetin really happen.
Meanwhile tension also dey di Mile One to Three Diobu area of Port Harcourt as some youths dey burn tyres, block di popular Ikoku junction too ontop EndSars Protest.
Kano dey calm as security pipo dey go round
Article Information - Author, Mansur Abubakar
- Role, BBC Pidgin, Kano
A day afta violence happun for some parts of Kano state for northern Nigeria, tins dey calm on Wednesday morning as sounds of police sirens na im some pipo dey hear from dia house as security pipo dey go round to monitor tins.
Kano, commissioner of Police Habu Sani wey speak with tori pipo say di report wey dem get na 26 injured, some properties and cars burnt but no get report about any death.
Di End SARS protest wey start for Kano on Monday hold peacefully but on Tuesday na im kata kata start as di protesters tok say na some thugs first come attack dem.
Sani tell BBC say dem don arrest 28 pipo for for di violence wey happun.
Di commissioner add say dem don recover some of di items wey dem loot from shops as di violence dey happun.
Who be DJ Switch, di Nigerian Disc Jockey wey feem Lekki toll gate End SARS shooting?
Hoodlums set fire burn TVC news station
Nigeria president silent on top Lekki toll gate shootings
Hours afta military open fire on top protesters for Lekki Toll gate for Lagos state, Nigeria president neva tok pim on top di mata.
Na 30 pipo wey di Lagos goment announce say don wunjure for di attack and dat dem dey hospital dey receive treatment.
Di armless protesters bin enta street since early October to call on goment to end di notorious Special Anti-Robbery Squad-SARS.
Di only statement wey presidency release na to say goment welcome di establishment of di judicial panel wey dey chook eye inside police brutality mata.
President tok -tok pesin, Femi Adesina say about 13 states don set up di Judicial panel of inquiry and dem go make sure say victims of police brutality get justice.
E say since di protest goment don dey try do everytin to make sure say dem cari out beta reform on top police mata for di kontri.
Di National Human Rights Commission (NHRC) and di Police Service Commission (PSC) don begin work on di report of abuses wey pipo submit.
E ask Nigerians make dem calm down as goment kontinu work to reform police.
Meanwhile, many Nigerians don enta social media to ask president Buhari to address Nigerians on top di endsars protest-even di leader of di senate, Ahmed Lawan don also join call presido to tok something.
How di world react to Lekki toll gate End SARS protest shooting
Wetin else Gov Sanwo-olu tok?, Im tok about military presence for Lekki Toll-Gate on day of shooting
In reaction to the Lekki shootings, Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu give public address on live TV di morning afta, wia im reference soldiers presence for di incident on 20 October.
"Make pipo know, no sitting govnor get control over di military," to reference di attack wia video evidence show say soldiers open fire ontop unarmed and peaceful protesters around di Lekki toll gate.
Meanwhile late on Tuesday, di Nigeria Army release four tweets on social media, wia dem label about 12 newspaper (both local and international) say dia report about soldiers wey shoot protesters na "fake news".
Ontop di report of local tori pipo Sahara Reporters, di Nigerian Army put "No soldiers dey present dia" ontop screenshot.
Wetin Sanwo-Olu tell Lagosians afta Lekki toll gate shootings
Lagos state govnor Sanwo-Olu apologise for Lekki Toll gate shooting
Lagos state Govnor Babajide Sanwo-olu don apologise for di shootings wey happun for Lekki Toll gate area of di state on Tuesday.
Di govnor wey again confam di number of pipo wey injure say im go round hospitals and mortuaries yesterday too.
Sanwo-Olu wey say e no get control of di military say e know say blood dey hot but make di youth give peace a chance.
Di govnor also confam say hoodlums don burn some other properties today but e no mention di names.