Nigeria Govnors Forum say
each state go set up panel for di compensation to all di victims of police
brutality and make sure say dem give compensation to di pipo wey deserve am.
Di govnors tok dis one for dia
meeting wey dem do wit IGP on Wednesday October 14.
Di govnors also pledge dia
support to the kontri Inspector General of Police, Mohammed Adamu, plan to
reform police and make am more effective, accountable and transparent.
While dem pledge dia support,
di govnors also raise some concerns including di timing wey dem take introduce Special
Weapons and Tactics (SWAT) squad fit make pipo dey suspicious say dem just wan
dress FSARS wit anoda dress.
Dem add say e go fine if di
IGP consult di public before dem take any decision. Therefore dem advice am to
do meeting wit stakeholders to agree on format wey di reforms go take.
Consultation na one tin wey
dem enphasize for di IGP becos according to dem, police no go fit use one “single
solution” for all di 36 states and di Federal Capital Territory.
Police salary na anoda tin di
forum discuss, as dem recommend make di
IGP, di Police Service Commission and di Police Council review di salary of di
officers.
Di IGP say dem go send about
50 SWAT officers to each state.