Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Covid-19 test reagents wey finish don hang 300 suspected cases for Oyo

      • Author, Moseph Ekine
      • Role, Broadcast Journalist Pidgin
    Seyi Makinde

    Wia dis foto come from, @seyimakinde/Twitter

    Govnor Seyi Makinde of Oyo State south west Nigeria, don tok say di reagents wey dem need to process covid-19 tests don finish.

    Di govnor say because of dis, 300 suspected cases wey dem don collect dia samples still dey wait for dia result.

    Im tok dis one for im daily Covid-19 task force update of Wednesday 29, April.

    Govnor Makinde add say di state dey in di process to acquire more reagents in di shortest possible time.

    As of Wednesday 29, April Oyo state don record 21 cases of coronavirus eit no death.

  2. Di Italian wey carri first case of Coronavirus enta Lagos Nigeria bin also go Ogun State

  3. See wetin dis Nigerian state dey do to dey free from coronavirus

  4. Ghana go resume domestic flights by weekend

    Pesin dey use scanner check temperature

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Strict rules dey for anyone wey wan use aeroplane travel

    Domestic flights for Ghana go resume by di weekend, according to di aviation minister.

    Joseph Kofi Adda tok say Kotoka airport for di capital, Accra, don dey disinfected and dem don clean oda airports, including di one for Kumasi to ready dem for passengers.

    Oga Adda tok say social distancing of passengers, di use of masks and sanitisers go dey compulsory when operations begin again.

    Health officials go also dey di airport to monitor all passengers.

    Domestic airlines never get instructions from di government about di exact date wey flights go resume, na so Thomas Naadi of BBC bin report from Accra.

    Ghana bin suspend domestic flights on 30 March, when di goment order partial lockdown.

    Last week, di goment remove di lockdown, although borders for di kontri still dey closed.

    Motor wey Ghana dey use Ghana dey disinfecting public areas

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Ghana dey disinfecting public areas
  5. Uganda president blast MPs over coronavirus money

    Uganda Presido Yoweri Museveni don blast im lawmakers say dem share give demselves $2.6m to use go raise awareness on top coronavirus.

    Museveni say na yeye tin dem do to share di money instead of to give district committees wey dem create for di purpose.

    Each MP suppose get more dan $5,000.

    President Museveni said he go ask di auditor general to investigate MPs wey don already spend di money to buy relief items for their constituents.

    He bin don earlier ban di individuals from distributing relief items and tell those wey wish to do so to give di items to di district committees so crowd no go gada.

    ��

  6. Hundreds of Moroccan prisoners don test positive to Covid 19

    Dem don report more dan 300 cases for inside prisons

    Wia dis foto come from, AFP

    Hundreds of Moroccan prisoners don test positive to Covid-19.

    Authorities confam say 313 prisoners get di virus afta dem do mass testing for Morocco prisons dem.

    Authorities say dem find 303 cases for one Ouarzazate prison wey dey central Morocco and di oda 10 cases for Oudaya prison for Marrakesh and Ksar Kebir prison for north-west.

    Di mass testing bin start afta one pesin test positive for Ouarzazate prison last week.

  7. Man wey apply for unemployment benefit for US as 'Tupac Shakur' name cause confusion

    Late rapper Tupac Shakur

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, No be dis Tupac

    Govnor of Kentucky for US don tok sorry to one man wey im name na Tupac Shakur sake of say dem bin tink im dey whine dem wit di name wey im use apply for umemployment benefits.

    “We get pesin wey apply for unemployment for Tupac Shakur. Dem bin tink say di pesin dey try crack joke,” Govnor Andy Beshear tell tori pipo.

    But di man, wey dey share im name wit di ogbonge American rapper wey die for 1996, actually be Tupac Malik Shakur.

    “Shame dey really catch me. Na my name be dat,” Shakur tell local tori pipo the Lexington Herald-Leader. Im say im be apply for unemployment on March 13 as di virus make millions of Americans to dey jobless.

    “I don dey struggle since like last month to find way to pay bills,” Shakur tok.

  8. Coronavirus: See di tins you fit do or no do for Delta state afta goment relax lockdown

  9. How to know face mask wey go fit protect you from coronavirus

  10. 'Our testing beta pass any oda kontri ' - Trump

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    President Donald Trump say di only reason U.S. don report one million cases of coronavirus na because dia testing beta pass any oda kontri for di world.

    Trump tweet say oda kontries dey behind dem for testing dat na why dem dey show fewer cases.

    More dan 58,000 pipo don die from di virus for kontri, dis don pass di number of pipo wey die for di Vietnam War.

  11. Una goomorning oh!

    Checkout our proverb for today.

    BBC proverb
  12. Una good night!

    Na here we go end Tuesday 28 April, 2020 our live coverage of all di tori about coronavirus.

    You fit take your time scroll down read all di tori we don torchlight since morning ontop dis Covid-19 palava around di world.

    Make we leave una wit dis Twitter post from di US Embassy inside Nigeria about wetin President Donald Trump tell President Muhammadu Buhari wen dem two tok for phone earlier today.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    From Yemisi, Annette, Moseph, Ronke, Damilola and Daniel una bye-bye!

  13. Ghana Covid-19 death toll hit 16, total cases rise catch 1,671

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    Coronavirus death cases for Ghana rise catch 16 afta five more people wey get Covid-19 die.

    Total number of COVID-19 cases hit 1,671 after some 121 people test positive for de virus.

    Director-General of the Ghana Health Service, Dr Patrick Aboagye, reveal say additional 33 patients recover which push de recoveries go 188.

    Ghana Health Service say out of de total number of cases 1,461 no dey show any symptoms wey dem dey respond to treatment, while be critically ill.

  14. Cameroon confam 101 new cases of Covid-19, 110 pipo recover

      • Author, Leocadia Bongben
      • Role, BBC Pidgin, Yaounde

    Cameroon don confirm 101 new cases, 110 pipo recover and one pesin don die from Covid-19.

    Dis wan na infomate public health emergency centre for today daily briefing.

    Since weh Cameroon announce first case for March 6, kontri don hit 1806 cases, 915 recover, 59 don die and odas dey for hospital.

    Goment di frown say social media di share some kana informate weh e fit make adults for panic.

    Pikin dem too even if dis sick nova touch dem plenti di also fear for seka weti deh di hear di read, deh add.

    Authorities continue for all on population for respect rules, wear masks, wash hands wit soap and running wata or use hand sanitisers.

  15. Coronavirus lockdown: Court remand former Police sergeant wey allegedly kill im female colleague for SCID Cell

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Court for Port Harcourt don don remand for prison one Police Sergeant wey chop sack last week, Bitrud Hosea sake of accuse say im shoot im colleague late Warrant Sergeant Lovender Elekwechi dead

    Hosea wey police authorities don already dismiss from service dey face one count charge of murder, and now e dey for for Port Harvourt Correctional Centre.

    Di former sergent deny di accuse say im no even dey for di place wia di incident happun as im bin dey duty for Eliozu.

    But im no fit take plea becos di Magistrate Court no get jurisdiction to hear di matter since na capital offence.

    Di police IPO say investigation show say di Bitrud Hosea book 29 rounds of magazine but na 15 rounds remain and im no fit account for di oda 14 rounds of magazine.

    Matthew Elekwechi wey be papa to di late Lovender, say na justice im want for di death of im daughter.

    Lawyer to Elekwechi family, Jerome Okere dey ask for di welfare of di 18 months old pikin of di late Lovender come add say Police suppose compensate di family even as di case dey go on.

  16. Breaking, US confam cases of coronavirus don pass one million

      • Author, Moseph Ekine
      • Role, Broadcast Journalist Pidgin

    Confam cases of coronavirus for America now don pass one million, according to Johns Hopkins University.

    Di US pass China for March for di most confam cases of coronavirus than any other kontri.

    Pipo wey don die don reach 56,749 nationwide, also di highest for di world.

  17. IMF dey give Nigeria $3.4 billion helep moni for Covid-19, International Monetary Fund don approve $3.4 billion for Nigeria as coronavirus relief moni

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
    Buhari and pipo wey wear PPE for Covid-19

    Wia dis foto come from, Nigerian goment

    Di International Monetary Fund don approve di RFI moni of $3.4 billion to support Nigeria fight against di spread Covid-19.

    Rapid Financing Instrument (RFI), na grants wey dem dey give to member kontris wey no dey under any IMF programme.

    Di grant to Nigeria na di highest COVID-19 financial assistance moni so far wey dem go give to support any member kontri till date.

    Earlier in April, di Executive Board bin approve debt service relief to 25 of im member kontris for a period of six months make dem for fit use di moni fight di coronavirus pandemic.

    Di member kontris wey benefit from dis relief na di poorest and vulnerable members of di organization.

  18. Di main reason behind France decision to suspend Ligue 1 & 2

  19. Wearing of glove fit protect you from COVID-19?

  20. Latest Covid-19 updates

    Nigeria Centre for Disease Control don announce say dem don get additional two new coronavirus testing laboratories for Lagos and Ogun state Dis don bring di total number of testing labs for Nigeria to 17.

    Dis go help NCDC increase di number of pipo wey dem go test everyday.

    Di Archbishop of Camerooncommercial capital, Douala, don deny report say im don find cure for Covid-19.

    Local tori pipo bin report say last week Bishop Samuel Kleda bin offer to treat pipo for free. Kleda say na lie, even though im don dey study some plants for long time.

    New Zealand don begin ease some restrictions after dem spend almost five weeks for lockdown. Schools and businesses fit reopen now but must observe social distancing.

    For di second time in two weeks, High court for Malawi don stop di goment from putting lockdown order to prevent di spread of coronavirus.

    Malawi currently get 36 cases of coronavirus and three pipo also don die.

    France go soon make wearing of face masks compulsory wen pipo wan enter public transport and for secondary schools wen dem reopen.

    According to Prime Minister Edouard Philippe, Schools go open again on 11 May starting with primary schools and kindergarten. Shops and markets go also reopn on di same date.

    Still on France, di kontri don ban all sporting events including playing without fans until September.

    Dis one mean say di top two divisions for France wey bin dey hope to resume on 17 June don end.

    If di Tokyo Olympics games no happun for 2021 we go cancel am, na so di games oga Yoshiro Mori tok.

    Health experts dey fear if di Games fit hold without any vaccine or cure wey dem don find to treat covid-19.