Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Trump get ‘high confidence’ say coronavirus come from one 'lab for Wuhan', But US intelligence say di virus no be man made

    President Donald Trump

    Wia dis foto come from, Getty Images

    US President Donald Trump don lash out again, dey accuse both China and di World Health Organization ontop di pandemic.

    Im say im get “high degree” of confidence say di virus come from one Chinese lab – adding say im no dey allowed to tok whether China “make mistake” or do “sometin on purpose”.

    US intelligence officials bin tok before say Covid-19 “no be virus wey man manufacture or genetically modify”.

    Trump bin don suggest say China no warn di US because dem wan dabaru im re-election bid.

    Im also blast WHO say “shame suppose dey catch dem” as dem “be like mouthpiece for China”.

  2. One million pipo don recover from Covid-19 worldwide

    Figures wey dey comot from today headline show say at least one million pipo don recover from coronavirus out of three million cases around di world.

    Covid-19 get low death rate wey mean say almost all di three million cases go later recover, even though for some cases, e fit take long time.

    But how many go really recover?

    Dat one depend on how many pipo wey catch di virus go die - something wey we still no know.

    Medical journal The Lancet dey suggest say di death rate high pass influenza own (0.1%) and e low pass Sars (9.5%).

    But because say testing dey different from kontri to kontri, na only di ratio of deaths to confam infections we fit see.

    Wen dem dey test only pipo wey dia symptoms dey strong well- well, di death rate go normally high pass 1%.

    For reality, e dey likely say many pipo go catch di virus and dem no go even record am – meaning say di death rate dey lower dan wetin “official” ratios fit dey suggest.

  3. Sports round-up: Premier League players dey 'fear'

    Sergio Aguero in action

    Wia dis foto come from, Getty Images

    • Manchester City striker Sergio Aguero say players dey 'fear' say dem go need to return to action in di middle of di coronavirus palava. Dem suspend Premier League since 13 March - but clubs say dem remain committed to play di season 92 remaining fixtures
    • Paris St Germain don collect di award of di Liguw 1 title afta dem announce say di season no go resume.
    • Rugby league for England go collect £16m in government loans to help dem recover from di impact of di pandemic
  4. South Africa dey relax some lockdown restrictions

    South Africa police for road

    Wia dis foto come from, Getty Images

    South Africa dey relax some of im lockdown restrictions today.

    Some businesses go dey allowed to reopen, restaurants go fit deliver food, and families go dey allowed to leave dia house go exercise.

    But in some areas, South Africa five-week lockdown go remain just as strict as e dey before.

    Di sale of alcohol go still dey banned. Dis restriction don help keep di kontri hospital wards empty.

    Goment go also deploy more troops for di streets and impose overnight curfew.

    Security forces don face tok say dem dey do anyhow. Now, dem fit deploy tens of thousands of extra troops to patrol di streets.

    Goment – wey so far don collect accolade say dem move fast to fight di virus – go now need to balance di need to keep di infection rate down with di risk of growing frustration and hunger inside kontri wey already dey face issue of inequality and get economic struggles.

  5. NCDC report 204 new Covid-19 cases in a day

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Di Nigeria Centre for Disease Control report 204 new cases of Covid 19 for di kontri, to make di total confam cases 1932.

    According to di NCDC, 71 percent of all di cases na from three states, wit di highest number from Kano state wey get 80 new cases, Lagos wey get 45 new cases and Gombe wey just record 12 cases.

    So far, 319 pipo wey bin get di virus for Nigeria don recover and 58 don die.

  6. Una good morning!

    Welcome to our every day live coverage ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    Make dis proverb ginger you today.

    Proverb of di day

    Wia dis foto come from, Getty Images

  7. Una na Good Night!

    Na here we go march break ontop Thursday 30 April, 2020 coverage of coronavirus. Friday 1 May, 2020 na anoday day.

    Make we leave una wit dis Twitter post from NCDC & remember to wash your hands always.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    From Moseph, Annette, Ronke, Yemisi and Daniel, una bye-bye.

  8. Coronavirus: Kenya surprise widow wey cook stones for her children

    Peninah Bahati Kitsao say di help she don receive na "miracle"

    Wia dis foto come from, CAROLINE MWAWASI/TUKO

    Wetin we call dis foto, Peninah Bahati Kitsao say di help she don receive na "miracle"

    Kenyans don rally round one widow wey dey cook stones for her eight children to make dem believe say she dey cook food for dem.

    Peninah Bahati Kitsao wey dey live for Mombasa hope say, sleep go catch dem as dem dey wait for dia food.

    Na one of her neigbhour wey di mata shock, call tori pipo to come see wetin her eyes dey see.

    Madam Kitsao dey always wash cloth for pipo, but di lockdown and social distancing sake of coronavirus no gree her fit get work again.

    Afta Kenya NTV interview her, di widow don receive money through fone and for bank account wey Ms Momanyi helep her open as she no sabi read and write.

    Di widow dey live wit her eight children inside two-bedroom house wey no get water or electricity.

    She say di generosity wey she receive na "miracle".

  9. "Many pipo for Lagos wey test positive to Covid-19 no fall sick" - Lagos Deputy Govnor

    Lagos deputy govnorHamzat on tok your own
    Wetin we call dis foto, Lagos deputy govnorHamzat on tok your own

    Lagos goment don tel pipo for di state make dem follow guidelines wey dem release to stay safe as dem dey try relax di lockdown.

    Deputy govnor, Babajide Hamzat naim tok dis one wen BBC Pidgin do tok tok wit am on Thursday to hia update ontop Covid19 mata for di state.

    E say di number wey dey increase now for people wey test positive na sake of say dia health workers dey do plenti testing, and dey cover plenti areas.

    Ontop face mask mata, E tell Lagos pipo say if pesin get enough face mask, make dem share give others as di one wey goment go share no go fit reach every body.

    E add say "many pipo for Lagos wey test positive to Covid-19 no fall sick".

    Oga Hamzat say goment go share safety equipment give market pipo so dem go dey protected to sale dia good.

  10. Coronavirus: Russian PM Mishustin test positive for virus

  11. Breaking, Cameroon relax rules even as Coronavirus cases hit ceiling

      • Author, Leocadia Bongben
      • Role, BBC Pidgin, Yaounde
  12. Coronavirus: Los Angeles offer free virus testing for all dia residents

  13. Nigeria election office no go resume for 4th May

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  14. "We get for know weti di make pipo well afta deh take Archbishop COVID-19 concoction"

  15. DR Congo confam cases of COVID- 19 for Prison

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
    Di eastern part of di kontri don reopen

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Di eastern part of di kontri don reopen

    Di Democratic Republic of Congo don confam dia first case of COVID-19 for inside prison.

    At least four inmates test positive and many more dey quarantine for Ndolo prison wey dey di capital city, Kinshasa.

    Di overcrowded prison dey carry inmates wey pass im power four times.

    Human rights organisations dey worry say di virus fit spread among prisoners and even to di families wey go visit dem.

    Rights groups dey ask make dem release prisoners wey dem accuse of small crimes to take decongest di prison.

    Health officials don send one team go di prison to torchlight how di outbreak take happun.

    DR Congo don confam cases of di new coronavirus inside at least seven provinces, but di majority of cases na for Kinshasa wey be di epic centre of di virus for di kontri.

    Di eastern part of di country, wey no get any active case for now don open dia border make pipo fit dey travel for di cities wey dey those provinces.

  16. Di rare picture of minister wey back him baby during Zoom meeting

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
    AISSATOU BAH

    Wia dis foto come from, AISSATOU BAH

    At first e look like one cute Twitter picture to make pipo happy for dis uncertain times.

    But as di man share di image of im 10-month-old daughter wey im tie for back during one online meeting and im be Sierra Leone Education Minister, di conversation turn to gender roles.

    David Moinina Sengeh say im wan set example for other men.

    Im tell BBC say e dey rare to see a child for Im papa back for Im kontri.

    Of course, picture of woman wit baby for her back no go make pipo blink eye, dis na wetin di 33 year old minister agree.

    "Many women dey do am daily, but e dey so normal, we no dey tok about am at all, if na my wife do am e no go become viral tweet,” he tell BBC Newsday programme from Sierra Leone capital, Freetown, wia partial lockdown dey to prevent di spread of coronavirus.

    Di Education Minister dey kitchen for im home dey feed Peynina wen he start to take part for one Zoom meeting.

    He notice say she wan sleep so he tie am for back make he fit continue di meeting.

  17. COVID-19 Latest updates

    • Nigeria Health Minister say make kontri pipo wey get empty buidings wey dem no dey use borrow goment to take keep and treat Covid- 19 patients. Dr Osagie Ehanire tok dis one as di director general of Nigeria Centre for Disease Control tok say dem dey struggle to get bed spaces for some areas.
    • Di Democratic Republic of Congo don confam dia first cases of COVID-19 for inside prison. At least four inmates test positive and many more dey for wuarantine for Ndolo prison wey dey di capital city, Kinshasa.
    • UK Prime Minister, Boris Johnson say for di first time, say di high number of pipo wey dey test positive to COVID- 19 for di kontri don dey reduce small-small. E say if dem fit dey record small cases, goment by next week go come out wit plan of how dem fit restart di economy and how chidren fit go back school and how work place fit dey safe.
    • Paris St-Germain don become Champion of di football season for France. Dem chop di title Ligue 1 as dem top di table by 12 points before dem suspend di season sake of covid- 19.
  18. Papa wey reject son become COVID-19 Ambassador

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    Govnor Kayode Fayemi of Ekiti State south west Nigeria don appoint Adeoye as Covid-19 Respond ambassador for di state.

    Dis dey come barely after 24 hours wen viral video of one man forEkiti state, South West Nigeria ask im son wey just travel come from Lagos, anoda state for di region wey be di epicenter of Coronavirus for Nigeria to isolate himself for 14 days.

    For di video, Oga Adeoye bin report im son to local authorities for dem to isolate di boy or he no go allow am follow him go house.

    According to di govnor, Oga Adeoye go helep di enforce di message as active member of di Covid-19 Taskforce for di state.

    Di goment and di good pipo of Ekiti State dey very proud of dis ogbonge act of courage and principle wey be di hallmarks of di Ekiti pesin. Di governor tok for statement.

    Di state don record eightcases of coronavirus.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  19. Coronavirus treatment: I don approve make dem use chloroquine take treat COVID-19 – Bauchi Governor

    Bauchi State Governor

    Wia dis foto come from, Senator Bala Mohammed facebook page

    Wetin we call dis foto, Bauchi State Governor give order for di use of chloroquine to treat Covid-19

    Govnor of Bauchi State, Bala Mohammed don give order for di use of Chloroquine as melecine to take treat COVID- 19.

    Oga Mohammed wey be di index case of COVID- 19 for di state, say na “Chloroquine and Zithromax” dey take treat am wen im catch di virus.

    Di govnor wey tok dis one wen e dey do Coronavirus update for di state say im go take any kasala wey burst on top say im approve di melecine.

    “Our medical team use dia brain, na why dem dey use chloroquine and Zithromax take treat patients, even though e dey against protocol for some places.”

    As e dey follow health officials tok, e tell dem say im don give dem directive say dem must use di drugs wey im use, wey make am well, just as dem dey use am for oda cases wey don well.

    “E tok say make we know follow oyinbo pipo wey tok say di melecine no good.”

    Chloroquine
    Wetin we call dis foto, Chloroquine

    “We dey used to dey take chloroquine for Nigeria. We go use am. We don take responsibility and I don take responsibility.

    “Zithromax and chloroquine no go wunjure our body, our physiological system don adapt to am. If fever dey worry you, use chloroquine.”

    E say dis drugs na di reason why Bauchi neva record any death.

    “Nobody get any serious symptoms for Bauchi, even though di number of cases for di state be 23.”

    Oga Mohammed statement on top chloroquine don join di debate wey dey happun for di world if make dem recommend am.

    While di drug don dey effective in some cases to treat COVID-19, di World Health Organisation and other experts warn say e neva go through essential clinical trials wey go fit make dem recommend am to dey use treat di disease, and e fit get bad effect.