Nigeria, Egypt and oda African kontris don begin vaccine trial for Coronavirus

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Africa Centre for Disease Control (CDC) don put out some of di trials wey dey go on for Covid-19 treatment and vaccination for Africa.
For one joint briefing online with doctors for Shanghai hospital, di CDC tok say in comparison to di rest of di world e get few treatment wey dey happun for di continent.
Dr Taji Rajudeen outline di trials wey dem don do so far:
- In Egypt, e get about 13 trials wey dey happun. Scientists tok say dem still dey conduct about two trials for di vaccine.
- In Zambia, dem get one ongoing trial with hydroxychloroquine.
- South Africa dey part of di WHO solidarity trial, and dem dey chook eye for Chloroquine, Interferon, Remdesivir.
- For Nigeria, e get one trial wey dey in progress-still on wetin fit cure di virus.
- Tunisia get two trials wey dey go on.
Di Africa CDC dey try to bring together di different research consortiums for di continent to see how dem go fit change di narrative so that Africa go dey more involved.
Fifty-two African kontris don confam positive cases of Covid-19 and ova 37,000 patients dey get treatment.











