Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. IMF don gree borrow Cameroon 136 billion

      • Author, Leocadia Bongben
      • Role, BBC Pidgin, Yaounde

    IMF don gree borrow Cameroon $226 million (FCFA 136billion) for address Covid-19 shocks IMF, under Rapid Credit Facility, RCF don gree for borrow Cameroon FCFA 136billion for tackle effects of Coronavirus especially as price for oil drop sharply.

    Just now don confirm more dan 2000 cases for Covid-19, 953 don well and 67 pipo don die.

    Cameroon goment take plenti measures for reduce effects of Covid-19, laik, spend for more moni for health, fortify protection networks weh deh di exit before, support business and households, IMF tok.

    For April 30, goment relax measures, allow make deh open drinking spots and restaurants afta 6:pm, make taxi carri normal load instead of three pipo for de past one moon.

    Mr. Mitsuhiro Furusawa, weh na Deputy Managing Director and Acting Chair say Cameroon di face double and big challenges from Covid-19 and trade shocks.

    E explain say de kontri di experience weak demand for de world, price for products drop di cause big hostile economic and social effects.

    For make sure say Cameroon use de moni well, IMF say e bi important for tighten budget control and make sure say transparency dey how deh di spend de moni.

  2. 550 new Covid-19 cases push Ghana total go 2,719

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin
    Ghana

    Ghana record 550 new Covid-19 cases health officials reveal.

    Dis latest infections push de total case count go 2,719.

    Meanwhile, 65 more people recover from de virus which push de total go 294 wey one more person die.

    From de latest confirmed cases, Greater Accra alone record 480 out of 550 new infections which push total cases to Accra go 2,332.

    Dis be one of de highest confirmed infections wey Ghana record.

    Meanwhile, Prez Akufo-Addo extend traveling ban on land, sea and air borders throughout de month of May.

  3. Six important tips to survive di relaxed lockdown for Nigeria

  4. US Vice President face gbas-gbos say im no wear mask as e visit hospital

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    US Vice-President Mike Pence don agree say im suppose don wear face mask wen he visit one US hospital wey dey treat Coronavirus patients last week.

    Pipo bin dey criticise I'm visit to di Mayo Clinic for Minnesota on April 28 afta dem see di video where Im be di only pesin for di ward wey no wear face mask as e dey meet with patients and doctors.

    “I bin dey think say e no dey necessary, but I for don wear mask for di Mayo Clinic but I wear an wen I visit di ventilator plant for Indiana” two days later, Pence tell Fox News ON Sunday.

    He bin don earlier defend im decision not to wear mask - even as dem tell am of di hospital requirements. He tok say im dey receive coronavirus testing regularly.

    Di clinic bin tweet after di visit to say dem ask evrybodi to wear mask but dem later delete di tweet.

  5. Pipo struggle to collect moni from banks afta Nigeria relax lockdown

    Many still dey wonder kain transaction really make pipo waka go banks wey be say dem ignore social distance rule go jampack for bank as soon as Nigeria relax lockdown for Lagos & Abuja on Monday.

    BBC News Pidgin tok to some pipo wey dey frustrated.

    Wetin we call dis Video, Pipo struggle to collect moni from banks afta Nigeria relax lockdown
  6. Lack of protection kit don expose Cameroon health workers for Covid-19

      • Author, Leocadia Bongben
      • Role, BBC Pidgin, Yaounde

    Sylvain Nga Onana, President of Cameroon Health Personnel Trade Union, (Cap-Sante) say more and more Cameroon health personnel di contract Coronavirus for de kontri because deh no get enough protection kit.

    Cameroon don confam over 2000 cases for Covid-19 and 93 of dem na health workers and 45 new cases by end of April, seven don die.

    Out of de 93 health workers weh deh get dis sick, 31 dey for centre region, 25 for Littoral, 30 for West, 3 for East and 3 for Southwest and one for Far North region.

    For de whole world including Africa, plenti health workers don get Covid-19 laik for Cameroon and some don die

    “Health personnel lack correct protection kit and na one of de reasons weh plenti don get de sick”, Sylvain Nga Onana tell BBC News Pidgin.

    For Onana, e bi important for give health workers correct equipment for protect dem as deh di take care for sick pipo, make deh no bi exposed laik now.

    Dr. Mokolo weh e di work wit Covid-19 patients for Douala Laquintini hospital tell BBC News Pidgin say, de fact say 93 health workers don get dis sick mean say, ”any man fit get dis sick, no bi only for hospital health workers di catch Covid-19”.

    “Make all sick pesin wear mask and observe barrier measures and go for hospital weh e get protection material for personnel”, doctors di advice.

    Goment say deh don already command and go send protection equipment for health workers for protect demselves.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    “Goment don make available stock for protective equipment for health personnel, 50,000 overcoats, 40,000 surgical masks, …” health minister, Malachie Manaouda tok.

  7. Govnor Wike don place Port Harcourt on total lockdown till further notice

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Govnor Wike

    Wia dis foto come from, Govnor Wike

    Port Harcourt and Obio Akpor local goments wey be di two main bizness districts for Rivers State southern Nigeria go dey on total lockdown from May 7th until further notice.

    Govnor Nyesom Wike na im tok dis one for inside state broadcast today.

    Di Rivers State Govnor say di decision na to further stop di spread of Coronavirus for di oil rich state inside di Niger Delta region.

    E add say hotels, guest houses and beer parlours go remain closed.

    For broadcast on Monday, Governor Wike also declare say:

    • On no account wey any motor go waka or more than two pesons gada for dis two local goment, except pipo wey dey on essential services with appropriate authorization and all shops, trading or business activities, including currency exchange, must also close until further notice odawise Goment go seize di property.

    • Any pesin, group or institution wey violate di lockdown and curfew for dis Local Goment Areas go face di law come direct di immediate arrest and prosecution of Chief B.A. Worgu and Mr. Isaiah Abraka say dem organize night markets and disobey Goment order.

    •Because of di threat by oil and gas company workers for di State as di newest case of Covid19 for di State na oil worker wey just come in from Akwa Ibom State on 29 April, dem don review all entry waivers and permits wey dem bin grant Oil and Gas Companies say from now onwards dem go look such request on case by case basis, come add say workers for crew change or oda essential operations must first submit details of dia manifests to di State taskforce on COVID-19 for proper vetting of dia virus status before they fit allow dem to enter di State.

    •Evri pesin must wear face mask before dem comot for dia house.

    • Ban all private motor parks and taxi come order say no commercial taxi driver go carry more than three passengers per trip and no commercial bus driver go carry more than 40% of di full capacity of di bus while Keke NAPEP must carry only two passengers. Private vehicle go carry only three pesins for di car and evribodi go wear face mask and carry hand sanitizer.

    • Taskforce dey wey go arrest and prosecute any pesin wey no wear face mask and impound and auction any motor with pipo or passengers wey nowear facemasks and pick or drop passengers for private parks wey dem don ban.

    • Goment go give one hundred thousand naira (N100,000.00) to any whistle blower who give informate wey go help dem arrest and prosecute of any pesin, hotelier or motorist wey violate these directives.

    All dis dey di latest Executive order im sign sake of Corona virus disease.

  8. See how you fit use T-shirt take do face mask

  9. Uganda Kontri pipo donate $6m to goment for coronavirus fight

    Uganda

    Wia dis foto come from, AFP

    Kontri pipo for Uganda don contribute total of $6m to support goment pay for moto and medical supplies wey go helep fight coronavirus.

    Many African kontries get weak health systems wit poor funding but Uganda dey use di lessons wey dem learn from how dem take contain outbreaks like Ebola, to prevent di spread of coronavirus.

    Covid-19 no dey only threaten pipo health, but di national lockdown don cause insecurity and shortage of bacis supplies wey don ginger di average Ugandan to begin do food donations.

    Uganda Presido Yoweri Museveni bin hail di efforts to provide food, wey come ginger pipo to begin donate moni, moto and medical equipment like protective cloth wey doctors and nurses need.

    Kontri pipo and companies don give di goment more dan 50 4x4 moto and some ambulance, wey di authorities dey plan to expand into emergency fleet of 1,300 vehicles across di kontri.

    As di donation moni dey increase dey go, dem go use di extra moni to buy more moto.

  10. South Africa don begin dia level four lockdown relaxation

    Pipo dey queue to enta taxi for South Africa as di kontri enta level four for lockdown relaxation.

    Dey don allow make pipo return to work but they still have to keep dia distance from each other, wear masks and wash dia hands.

    Local media shared photos and videos of commuters wey dey enta taxis:

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

    Under di level-four lockdown, public transport dey allowed to operate but must to follow rules on carrying less passengers.

    Di goment dey still advise those wey fit work from home to do so.

  11. How Lagos, Abuja dey observe relaxation of coronavirus lockdown

  12. Which African kontris dey test well well?

  13. Italy, Spain, Germany, European kontris wey follow Nigeria relax lockdown

    About four million pipo dey go back to work

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, About four million pipo dey go back to work

    No be only Nigeria dey relax lockdown, oda kontris for Europe sef dey relax lockdown restrictions today after di kontris don dey total lockdown sake of coronavirus.

    • After eight weeks for lockdown, Italy don finally lift some of im restrictions. Pipo go be able to visit relatives, parks don dey reopen, and bars and restaurants fit do takeaway. E go reach like four million people wey go return to work, although face masks go dey compulsory at work and for public transport.
    From today, Italians go be able to move more freely within dia region, visit relatives, go to re-opened parks and get food takeaways.

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, From today, Italians go be able to move more freely within dia region, visit relatives, go to re-opened parks and get food takeaways.
    • Small businesses like hairdressers go open dia doors forSpain, though they go only fit serve customers wey don book appointments. Some of di island wey dey di kontri go also relax restrictions more dan before, as dem no dey badly affected as di mainland for di kontri.
    • Zoos, museums, hairdressers and even some schools don reopen forGermany. Di youngest students for di kontri don dey return to classrooms.
    • Student wey dey leave schools don dey return to class forAustria, and senior student forHungarydey write dia senior exams - even though schools there go remain closed.
    • Polanddon allow hotels, libraries, museums and shops to reopen, but hairdressers, restaurants and playgrounds go remain closed.
  14. Cameroon don confirm 57 new cases of Coivid-19

    Cameroon don confirm 20,134 cases
    Wetin we call dis foto, Cameroon don confirm 20,134 cases

    Informate for Public Health Emergency Centre, say Cameroon don confirm 57 new cases and three (3) pipo die from Covid-19 for kontri for May 3.

    Since de first case for March 6, Cameroon don confirm 2,134 cases, 953 don recover and 67 pipo don die.

    Just now, 1,060 active cases dey for kontri and 93 doctors contract dis disease wit 45 new cases, seven of dem don die.

    306 pipo weh deh get Coronavirus na woman weh deh dey wit belle or get pikin for hand. Need bi for authorities for fortify plan for care for group of pipo.

    Some health agents strike for seka say deh no pay dia taxi moni for one moon, so health minister and admin officials try for put order, pay dia moni and tins don go back for normal.

    As goment relax measures, open bars and restaurants afta 6:00pm allow taxis for carry normal load dis go increase human contact.

    De advice for kontri pipo na say e bi important for wear masks for public space, respect rules, wash hand wit soap and running wata, keep distance, no gada plenti for one place.

  15. How Lagos, Abuja dey observe relaxation of coronavirus lockdown

  16. 3.5 million pipo get coronavirus for di world

    As new week start for some of pipo wey still dey under tight lockdowns and for odas wey don get small freedom, dis na how cases of Covid- 19 for di world take be.

    As at 4 May, 3,505,761 cases of di new coronavirus na im dey recorded for di whole world.

    Many of dis figures don recover and di number of currently active infections tanda for around 2.4 million.

    Dis na di kontris wit di most confirmed cases:

    • US (1,157,945 total, 939,758 active, 67,680 deaths)
    • Spain (217,466 total, 73,300 active, 25,264 deaths)
    • Italy (210,717 total, 100,179 active, 28,884 deaths)
    • UK (187,842 total, 158,421 active, 28,520 deaths)
    • France (168,925 total, 93,140 active, 24,900 deaths)
    • Germany (165,664 total, 28,198 active, 6,866 deaths)
    • Russia (134,687 total, 116,768 active, 1,280 deaths)
    • Turkey (126,045 total, 59,497 active, 3,397 deaths)
    • Brazil (101,147 total, 51,131 active, 7,025 deaths)

    Dis data na from di Johns Hopkins University and na only di cases wey dey count dey know – plenty kontris own fit dey higher.

  17. Trump believe say coronavirus vaccine go ready by year ending but dat one possible?

    Donald Trump
    Wetin we call dis foto, Donald Trump say vaccine fit ready by year end

    US presido Donald Trump don tok say im believe say coronavirus vaccine go dey ready by ending of dis year.

    But how possible dat one dey? E don pass one month since wen dem do di first human trial of vaccine for Seattle, US.

    But plenti work still dey - even if di safety tests work well, di vaccine go still need to go through clinical trials, melecine regulators go need to approve am and manufacturers go need find way to dey produce am plenti.

    Vaccines dey normally take years, if not decades, to develop.

    Most experts feel say coronavirus vaccine go likely dey available by middle of 2021, about 12-18 months afta di virus start.

    Dis one go be ogbonge achievement for science but e no dey sure say e go work.

    Four types of coronavirus don alredi dey spread for human being bodi. Dem dey cause symptoms wey be like common cold and we still no get vaccines for any of dem.

  18. Civil servants for Lagos no go resume work immediately - See di new rules pipo must obey from 4 May

  19. Una Good morning!

    From today di lockdown wey Federal Goment of Nigeria bin put for Lagos, Abuja and Ogun go ease gradually sake of di coronavirus pandemic.

    Dem bin don put out guidelines on how movements go be, and one major one be say make pipo make sure say dem wear face mask for public.

    As e be dis na di lastest figure of confam cases of coronavirus for di kontri.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  20. Musk vs Zuckerberg: See di Coronavirus quarantine clash between tech giants