Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Rivers Lockdown: Governor Wike arrest 14 pipo wey hide inside two trailers wey carry cattle

    Pipo wey smuggle demsef enta Rivers

    Wia dis foto come from, RSGH Press

    Wetin we call dis foto, Pipo wey smuggle demsef enta Rivers

    Governor, Nyesom Ezenwo Wike on Thursday 7 April, arrest 14 pipo wey hide inside two trailers wey carry cattle from Adamawa State to Port Harcourt.

    Governor Wike say dem catch di trailers after dem get intelligence from well meaning Nigerians wey see as some of dem dey enter and arrest dem for Rumuigbo, Obio/Akpor Local Goment Area.

    Di governor bin don give order make dem prosecute di 14 pesins for di Mobile Court under Executive Order 6 wey im sign for di declaration of di lockdown, come also direct di State Ministry of Health to conduct tests on di 14 pesins to ascertain dia coronavirus status.

    β€œDis fight get nothing to do with individuals. Di law must take im course. You dey aware of wetin dey happen and then some people wan illegally smuggle pipo into di state. Port Harcourt and Obio/Akpor dey under lockdown and we must obey law so di trailers and di cows, dem go auction dem tomorrow."

    Pipo wey smuggle demsef enta Rivers

    Wia dis foto come from, RSGH Press

    Wetin we call dis foto, Pipo wey smuggle demsef enta Rivers

    One of di defaulters, Ahmed Aliyu say dem contract dem to bring di cattle from Adamawa State to one Alhaji for di new slaughter for Oyigbo and im think say di lockdown go start by 10pm.

    Meanwhile, Mobile Court don convict 170 pipo wey violate di lockdown of Port Harcourt and Obio Akpor.

  2. Nigerian- British rapper Ty, don die of Coronavirus

    Rapper, Ty

    Wia dis foto come from, Getty Images

    On UK hiphop artist wey dem dey call Ty don die of coronavirus at di age of 47.

    Di Nigerian- British musician, wey im goment name na Ben Chijioke bin contract di virus earlier in di year and e bad sotay dem induce coma for am for April.

    Even for di same April, dem bin set up fund raising page wey tok about his medically induced coma.

    However, e recently comot intensive care and di word for mouth be say im condition bin dey improve. But on Thursday, im press team come out to say im don die.

    Ty, don dey nominated for di Mecury award for UK before and na one of di artist wey im rap dey follow di old school gang.

    Plenti of im celeb friends enta social media to mourn di man wey dem call, UK Legend

  3. Bangladesh open mosques as lockdown reduce

    Muslims dey pray for one mosque for Bangladesh afta officials relaxe rules

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Muslims dey pray for one mosque for Bangladesh afta officials relaxe rules

    Bangladesh don open dia mosques to allow pipo to fit gada do prayer.

    But one tori pesin find out say plenty of di mosques for di kontri capital, Dhaka, no follow di rules wey goment put down as dem open dia doors for di first on Thursday, one month afta dem dey lockdown.

    President of one of di mosques for di city Fazlul Haque say some arrangements for di guidelines no add up but dem dey try dia best to enforce di rules.

    Bangladesh get more dan 12,000 cases of Covid- 19 and nearly 200 pipo don die wit di disease.

  4. Wetin fit make Nigeria return to anoda total lockdown

  5. Nigeria confam 381 cases, di highest since coronavirus enta di kontri

    Una good morning! Di Nigeria centre for disease control don announce di highest number of coronavirus case for one day and dis na 381.

    Lagos na im still cari di highest number of 183 new cases.

    For di NCDC twitter page, 601 pipo don dey discharged and 107 don kpai.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  6. Ten aides to Lagos state govnor test positive

    Authorities for Lagos, Nigeria don confirm say ten aides for di state house don test positive for coronavirus.

    Di state commissioner of health Prof Akin Abayomi confirm di tori, im say dem dey receive treatment for di state isolation center.

    Oga Abayomi also add say di state govnor, Babajide Sanwo-olu and di First Lady Joke Sanwo-olu don consistently test negative to Covid-19 afta dem do three straight tests.

    Babajide Sanwo-olu

    Wia dis foto come from, Lagos State Government

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  7. International tourism go drop by 80% - UN

      • Author, Ogechi Obidiebube
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Di number of international tourists wey dey arrive different kontries fit drop by 60-80 percent for 2020 sake of di coronavirus, World Tourism Organisation tok on Thursday.

    Travel restrictions and di closure of airports and national borders to reduce di spread of di virus don force di international tourism sector to face di worst crisis since 1950, di UN joinbodi tok inside statement.

    Airlines don suffer no be small since di outbreak start as dem gats cancel most flights but hotel groups, pipo wey dey operate cruise ships and tour operators dey also feel di heat.

    Di UN joinbodi say for dem to know wetin di full effect di fall of international tourism go be, go depend on how fast international borders open again.

  8. Free online consultation fit helep patients, limit infection for doctors

    Cameroon di struggle for block de spread of Covid-19, especially as about 100 health workers don contract Coronavirus.

    Pipo get plenti challenges, sometimes call centre 1510 no bi available, some pipo di waka from hospital to anoda as space no dem for receive dem and during dis taim, deh nova tok wit doctor.

    Cameroon don confirm 2265 cases for Covid-19, out of which 93 na health workers and seven don die.

    For change de situation, some doctors, based for economic capital, Douala, don start free online pre-diagnosis for Covid-19 wit doctors for all parts for kontri.

    Dr. Philippe Ohandja wan of de doctors weh deh start e-sante for Cameroon, say dis system di help for limit contact wit sick pesin and doctors because e no good say pesin weh e di sick go straight for hospital as e fit contaminate odas.

    Pipo fit go for website, e-sante Cameroun, press button for tele-medicine for see de application. Den press create account, afta deh di receive mail wit dia identity and password. Any taim deh wan consult deh enta dis info den connect wit doctor.

    Wit de app de 50 voluntary doctors weh deh join dis initiative di answer de patient online, for virtual consultation room.

    Doctors get questionnaire for Covid-19 weh deh di use for ask questions den orientate dem for centre or Covid-19 centres, or tell dem weti deh fit do.

    But for now pipo for villages, no go fit use dis application because internet no dey and even wen deh get internet, e deh need permanent connection.

    Roger Nga Onana, president for health workers trade union, Cap-Sante, di doubt how dis fit work wen electricity even for big cities no bi very stable.

    De group weh e di do e-sante sign agreement wit health minister dis January, objective for promote tele medicine and deh start wit Covid-19 for helep pipo weh deh di sick.

  9. Up to 190,000 pipo fit die with Covid-19 for Africa - WHO

    World Health Organisation

    Wia dis foto come from, WHO

    New study from di World Health Organization (WHO) don show say 83,000 to 190,000 pipo fit die with coronavirus if di measures to contain di virus fail.

    For di research wey WHO do wey cover 47 kontris, dem say up to 29 million to 44 million pipo go dey infected wit di disease dis year.

    WHO Regional Director for Africa, Dr Matshidiso Moeti announce dis new projection during di WHO Africa Media Leader online press conference today.

    Oga Moeti say "Covid-19 fit become normal tin for our life for di next several years unless many goments take proactive approach. We need to test, trace and isolate and treat."

    Di study also show say smaller African kontris alongside Algeria, South Africa and Cameroon dey at high risk if dem no prioritize containment measures.

  10. "We go charge over 200 pipo wey fail to obey total lockdown orders for Rivers", - Gov. Wike

    Rivers State arrest over 200 pipo wey break lockdown

    Wia dis foto come from, Rivers State Government House press

    Govnor Nyesom Wike don hail pipo as dem comply wit di lockdown for Port Harcourt and Obio Akpor local goment areas to check di spread of coronavirus for di oil rich Rivers State inside southern Nigeria.

    Total lockdown till further notice wey di govnor anounce, start on Thursday 7 May, 2020 for di two local goment areas wey be di main bizness area for Port Harcourt metropolis.

    Governor Wike hail Rivers pipo as im move round dey monitor come say do level of compliance dey up to 95 percent for di two local goment dem.

    Im come vex say Deputy Commissioner of Police for Rivers State DCP, Adamu Abubakar give some companies illegal letters to allow dem waka.

    Di govnor come say dat one na to sabotage di lockdown.

    Im add say any approvals weypolice or any oda authority outside di one wey office of di Rivers State Govnor give, dey illegal.

    Sake of dat, di Govnor call emergency State security council meeting to hold on Thursday.

    Wike join di state taskforce to inspect pipo wey go break lockdown.

    Wia dis foto come from, Rivers State Government House Press

    Wetin we call dis foto, Wike join di state taskforce to inspect pipo wey go break lockdown.

    "E dey unfortunate to see di level of sabotage we dey get from di police, particularly, di Deputy Commissioner of Police,Operations,Rivers State Police Command. Di Deputy Commissioner of Police go sign approvals for companies because im wan collect money. I be di Govnor of dis state and we no fit get two govnors.”

    Di Govnor say all di pipo wey dem arrest because dem violate di lockdown, di State Goment go charge to di mobile court dem set up for dat purpose and dem go sell evri motor wey dem arrest too.

    For di Elekahia Isolation Centre wey dey di Yakubu Gowon Stadium ( 22.12 km from Port Harcourt International Airport) dem arrest over 200 pipo and impound over 20 vehicles wey no gree obey di lockdown order.

    Governor Wike come give assurance say dem go lift dilockdown as soon as dem achieve di objective wey make dem put am and dem see say compliance of pipo dey reasonable.

  11. More dan 33 million pipo file for US unemployment benefits in di last six weeks

    3.2 million more Americans file for unemployment benefits last week as di economic toll from di coronavirus pandemic continue to dey rise.

    Di new applications bring di total number of jobless claims since mid-March to 33.3 million.

    Dat one amount to more dan 15% of di US workforce.

    However, e less dan di 3.8 million one week ago and e come down from di ogbonge record of 6.9 million for one week inside March.

    Although di number of pipo wey dey file for claim dey reduce, e still dey very high according to BBC Business correspondent Samira Hussain wey dey for New York.

  12. Port Harcourt lockdown as e dey hot

  13. ...And from across di world

    • America Presido, Donald Trump say di coronavirus pandemic na di worst attack wey US don get.
    • UK goment data dey suggest say black pipo wey go die from Covid- 19 fit double di number of white pipo wey go die from di virus.
    • About 400,000 PPE equipment wey UK buy from Turkey no meet di British Safety Standards, di NHF confam.
    • Brazil report say 615 patients don die wit Covid- 19, di highest di kontri record inside one day.
    • President Trump dey go on wit im plans to reopen US economy even as worry dey say di virus neva dey under control.
    • Moscow Mayor Sergei Sobyanin say di number of coronavirus cases for di state pass di 92,676 tori pipo dey carry. He say di real number dey around 300,000.
    • More than one in five households for America dey struggle to provide enough food for table, dis na according to research by di Brookings Institution think-tank.
  14. If you just dey join us...Dis na di latest tori from Nigeria and di rest of Africa

    • Nigerian authorities dey torchlight why pipo wey die for Jigawa dey increase
    • Di Kano state former commissioner for works, Muaz Mogaji wey chop sack sake of im post for social media say Late Abba Kyari test positive to COVID- 19 don catch di disease too.
    • Kenya goment agree to pay quarantine money
    • Hackers hack South Africa parliamentary virtual meeting
    • Di Africa Centre for Disease Control don comot hand for di allegation say di Tanzania testing kits for coronavirus no good.
  15. Di number of Black pipo for UK wey fit die from Covid- 19 fit double

    Ambulance wey carry patient

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Ambulance wey carry patient

    Di number of black pipo wey go die from COVID- 19 dey likely to double di number of white pipo, according to one new analysis from di Office for National Statistics.

    Di analysis put togeda data wey dem get on pipo wey die sake of Covid- 19, wit informate of wia dey come from from di 2011 census.

    Di data take account of age, wia pipo dey live, some of dia challenges and dia health. Afta dem put all these factors togeda, dia findings show say 90% of black men and women dey more likely to die wit Covid-19 pass white pipo.

    Men and women from Indian, Bangladeshi and Pakistani communities also dey at higher risk pass white pipo, although dia own still beta as di data show say those wey dey at risk na 30-80%.

    But analysis from di census data no give full explanation to di reasons for di higher risk because e no look di current health of di pipo, condition of area dem dey live, maybe dem dey exposed sake of dia work as front line workers or community difference fit increase dia risk.

  16. How di world dey look life afta lockdown?

  17. Coronavirus: India go begin massive evacuation operation from 12 kontris

    India go operate 64 flights from next week

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, India go operate 64 flights from next week

    Di first of more dan 60 flights wey go return thousands of Indians wey dey stranded for oda kontris sake of coronavirus lockdown go begin for Thursday.

    India dey expect close to 15,000 of dia pipo to come back through special Air India flights from 12 kontris for next week.

    Passengers go pay dia own ticket money and dem go quarantine dem for 14 days.

    Flights wey suppose enta from US and UK delay because dem no quick do coronavirus test for di crew, according to local tori report.

    Local tori also report say about 200,000 Indians na im dem go bring back.

    Di flights wey go carry out dis mission and fly plane go US, UK, Saudi Arabia, Singapore, Qatar and Malaysia, among other kontris na Air India, di kontri national airline.

  18. Why Port Harcourt/Obio-Akpor LGA dey total lockdown for Rivers State

  19. Covid-19 cases for Ghana cross 3,000

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin
    COVID- 19 Testing Laboratory
    Wetin we call dis foto, COVID- 19 Testing Lab

    Covid-19 cases for Ghana continue dey rise as total confirmed cases reach 3,091.

    Data wey Ghana Health Service publish dey show say de country record some 372 new cases in de last three days.

    Total number of recoveries currently dey stand at 303 wey deaths remain 18.

    Meanwhile, one new region also record first case of Covid-19 infection which mean say de virus affect 13 out of 16 regions for Ghana.

    De latest region wey record de virus be Bono Region, after officials detect new case for Jaman North District.

    Ghanaian authorities talk say de virus reach en peak sake of dem clear de huge backlog of samples which dey cause high number of cases in de last three weeks.

    But some Ghanaians criticize dis claim, dem argue say e be wrong to make such projections when de country no start dey do tins like mass testing.

  20. Nigeria coronavirus confam cases pass 3,000 mark

    Una good morning.

    The latest figures of 195 new cases of coronavirus wey di Nigeria centre for disease control bin announce Wednesday night don make di total positive cases rise pass 3,000.

    As e be, na Lagos still get di highest confam cases with 82 out of di 195 cases. Kano follow with 30 news cases.

    So far dem done discharge 534 pipo in total.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post