256 Nigerians return for abroad land Lagos from Dubai
- Author, Moseph Ekine
- Role, Broadcast Journalist Pidgin

Wia dis foto come from, Emirates
Nigeria goment don bring back 256 Nigerians from Dubai for di first batch of Nigerians decide to return home sake of Covid-19.
Di Emriates Airline flight wey carry di Nigerians land for Murtala Mohammed airport for Lagos on Wednesday night.
Dis returnees dey part of di 4,000 pipo wey Nigeria Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama bin tok on Monday 4, April say dey ready tp return home as a result of di Covid-19 pandemic.
According to di Foreign Ministry, dem don make arrengements to bring back more Nigerians from London and New York in di coming days.
All returnees dey expected to enter 14 days quarantine for select hotels once dem arrive, na so di Foreign Ministry tok on Tuesday.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post














