Lifting of lockdowns must happun small-small - WHO
As plenti kontris dey look to end or partially end their lockdown. Di World Health Organization don warn say make e be gradual process.
Dem say make dem relax di lockdown small small make e for no lead to another outbreak of new Covid-19 infections.
“At least until vaccine or ogbonge treatment dey, di process go become di new normal thing “ Takeshi Kasai, wey be Regional Director for di Western Pacific tok, e even add am say lockdown measures don work well-well.
Any goment wey dey think to relax lockdown must plan to do am stage by stage as dem dey continue to monitor di situation. "Individuals and society need ready to face di new way of living.” he tok.
Kontris like Japan and Singapore don see recent increase for new infections wey don make us dey concerned over second wave of Covid-19 cases.