You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Thousands of protesters don enta di streets of central Sydney in solidarity with demonstrations for US over police brutality and di death of African American George Floyd.

    A day to di rally, di New South Wales supreme court decide say make e no go ahead because of concerns over di spread of Covid-19.

    But court of appeal overturn di decision at di last minute

    Authorities dey worried say di mass gatherings fit spoil wetin di kontri don achieve so far in controlling di spread of di virus.

    But organisers and supporters, many from di indigenous Australian community, insist say dem go come out. Not just in solidarity with di protesters for America, but also to draw attention to indigenous deaths for police custody for Australia.

    Marches don dey happun across Australia, including for Brisbane, Melbourne, Hobart, Adelaide and oda places.

  2. Latest updates...

    Dis na di latest coronavirus updates from around di world.

    • Wearing masks for public fit help slow spread of di virus - World Health Organization (WHO)
    • Black Lives Matter protest happun for Sydney afta court dismiss coronavirus restrictions
    • Prince William reveal say he dey volunteer ontop di mental health helpline during lockdown
    • Number of cases for India don overtake Italy as hospitals dey struggle to cope
    • Di number of infections for around di world don pass 6.7 million and 395,000 pipo don die - Johns Hopkins
  3. England Sancho chop fine afta im break coronavirus rule to barb im hair

    Dis wan fit be expensive haircut for England international Jadon Sancho.

    Di Borussia Dortmund forward don collect fine from di German football league afta dem see picture of am as im dey barb im hair for house without wearing mask.

    Di 20-year-old call di decision “an absolute joke” for Twitter post wey e later delete.

    Sancho team-mate Manuel Akanji also collect fine ontop accuse say both of dem break rules, di league say di players "obviously violate general hygiene and infection protection standards".

    Both players receive visits from hairdresser for dia respective homes and neither di stylist nor di player wear masks.

    Dortmund defend di players, say dem no break di Bundesliga health and safety rules.

  4. India don overtake Italy

    India don record close to 10,000 new cases of Covid-19 in di past 24 hours, dis wan don make dia total above dat of Italy.

    Di kontri now get di sixth-highest number of confam cases for di world, 236,657. Dem don record 6,649 deaths.

    Di health system for Mumbai don almost collapse while hospitals for di capital, Delhi, dey run out of space according to reports.

    Meanwhile, shopping centres, places of worship, restaurants and offices go dey allowed to reopen from Monday.

    For weeks, India somehow low Covid-19 numbers bin dey make experts wonder. Despite dia population, disease and public hospitals wey no to dey funded, dem bin no record plenti infections or deaths.

    Although India na di sixth highest number of cases, na di 12th in terms of deaths, according to statistics from Johns Hopkins University.

  5. See WHO new advice ontop di use of facemask

  6. Una good morning!

    Una good morning

    Good morning.

    Welcome to our live page coverage of di latest tori on coronavirus for Africa and across di world.

    check out we today proverb from Peter Ugwu.

    No forget to like and follow us for:

    • Twitter
    • Facebook
    • Instagram
  7. Latest updates...

    In case you just dey join us, see di latest updates from around di world...

    • Di EU Commissioner for Home Affairs say make states reopen internal borders by end of June
    • Some EU states don reopen some borders, but odas remain closed
    • For England, masks go dey compulsory on public transport from 15 June
    • Dem don withdrae article wey say hydroxychloroquine dey increase risk of death in coronavirus patients
    • Peru declare oxygen as 'strategic resource' - meaning say hospitals get priority on supplies
    • Basketball teams for NBA vote to resume matches on 31 July for Disneyworld, Florida
    • Globally, dem don record 6.6m cases since di outbreak begin and 388,000 deaths
  8. Fiji say dem don free from coronavirus

    Pacific island of Fiji don declare say dem don free from coronavirus, afta di last infected patient recover.

    Prime Minister Frank Bainimarama say dia success dey as a result of "answered prayers, hard work and to follow science".

    Fiji bin dey among pacific islands wey coronavirus hit. Dem record dia first virus case fr March, wey come lead to panic across di nation.

    Many bin see di pacific islands as part of wia di virus go cause havoc pass due to dia poor heath infrastructure system. But kontris act quickly to close dia borders and shut down tourism - many don dey successful in handling di virus.

  9. Coronavirus: 'Di lockdown don help mother nature'

  10. Madagascar minister chop sack ova plan to buy $2.2m sweets

    Madagascar education minister don chop sack afta she plan to order sweet wey cost reach $2.2m.

    According to tori pipo AFP news agency, Rijasoa Andriamanana tok last week say she dey order di sweets for children to take reduce di "bitter" taste afta dem drink di Madagascar herbal drink wey dem dey call Covid-Organics.

    Covid-Organics na drink wey dem make from plants and di goment dey promote am as cure for Covid-19. However World Health Organization say sure cure no dey for coronavirus.

    Tori be say each student suppose get like three sweets, according to AFP.

    Dem announce di minister sacking inside statement, her colleague Elia Beatrice Assoumacou go take ova as acting minister.

  11. More pipo don die for Brazil dan for Italy

    Brazil don pass Italy in di number of pipo wey don die with coronavirus.

    On Thursday evening, di kontri report say 1,473 deaths naim dem don record in di past 24 hours. More dan 34,000 pipo now don die and dem don confam more dan 580,000 infections.

    President Jair Bolsonaro no dey tok too much im tok for Facebook live, about im frustration with isolation measures wey state governors impose, say di collateral damage from di virus go dey far worse dan those wey don lose lives.

  12. Uganda prime minister don go into self-isolation

    Uganda Prime Minister Ruhakana Rugunda don go into self-isolation afta some of e contacts test positive for coronavirus.

    Local tori pipo say dem don begin test e cabinet members for di virus.

    Prime Minister Ruguda make e announcement on Twitter.

  13. Sabi pipo do U-Turn with hydroxychloroquine study

    Sabi pipo don withdraw one ogbonge study wey show say hydroxychloroquine dey increase di risk of death with coronavirus patients.

    Three of di study authors say dem no longer fit vouch for di study because Surgisphere, di healthcare firm behind di data, no gree make dem do independent review of di study data.

    Di study findings bin make WHO to suspend di testing on di controversial drug, wey America President Donald Trump don sing im praise tire. =

    See weyin di study bin tok:

    • Na ogbonge study wey involve 96,000 coronavirus patients across 671 hospitals worldwide. Nearly 15,000 of dem mnaim dem give hydroxychloroquine
    • E conclude say di drug show no benefits against di virus, and actually increase di risk of patients to develop irregular heart rhythms and to even die.

    As of yet, evidence no dey say di drug dey work against di virus.

  14. Una good morning

    Good morning.

    Welcome to our live page coverage of di latest tori on coronavirus for Africa and across di world.

    check out we today proverb from Peter Ugwu.

    No forget to like and follow us for:

    • Twitter
    • Facebook
    • Instagram
  15. Una Goodnight!

    Dis na wia we go march break ontop our live coverage today.

    No forget to join us tomorrow again.

    You fit scroll down for Thursday tori dem.

    Remember, make you dey wash your hands. Covid-19 dey real.

  16. South Africa hospitals fit dey buried under coronavirus

    Coronavirus fly pass di power of South African hospitals in a few weeks time, according to di kontri top sabi pesin for vaccine.

    Doctors for Cape Town say some hospitals go soon start to dey struggle to cope.

    One of di kontri coronavirus sabi pesin Prof Shabir Madhi, say di way wey di virus dey rise aroud di kontri dey alarming when you compare am to wetin di testing system bin tok.

    E say anyone wey think say Africa no go too suffer for coronavirus because our population dey young dey suffer from wishful thinking.

  17. Ghana COVID-19 recoveries cross 3,000 mark

    Coronavirus recovery cases hit 3,189 today, Ghana health officials reveal.

    De recovery cases dey put current total active Covid-19 cases at 5,658.

    Total COVID-19 infectious wey health officials record be 8,885 based on de latest update from Ghana COVID-19 website.

    So far the number of deaths dey remain at 38.

    Regional breakdown

    Epicenter of Covid-19 cases dey Greater Accra Region which record 6,102 cases out of de total 8,885.

    Regional Distribution of cases

    Greater Accra Region – 6,102

    Ashanti Region – 1,452

    Western Region – 456

    Central Region – 445

    Eastern Region – 134

    Volta Region – 86

    Western North Region – 73

    Upper East Region – 42

    Northern Region – 37

    Oti Region – 26

    Upper West Region – 22

    Bono East Region – 6

    North East Region – 2

    Savannah Region – 1

    Bono Region – 1

    Ahafo Region – 0

  18. US warn kontri pipo about travel to Tanzania

    Di US embassy for Tanzania don issue fresh travel advisory for American citizens concerning di coronavirus pandemic for di kontri.

    For statement, di embassy suggest say di risk of catching di virus for di commercial hub, Dar es Salaam, bin high, but give no evidence to support dia claims.

    Dem suggest to dia citizens to avoid parties and make dem no leave dia homes.

    “Healthcare facilities for Tanzania fit become quickly overwhelmed for dis healthcare crisis,” di statement tok.

    Di advisory dey come days after Tanzania foreign ministry summon di acting US ambassador, Inmi Patterson, to protest against same advisory wey dem issue by di embassy last month.

    According to di statement wey di ministry release after di meeting, Permanent Secretary Wilbert Ibuge tell di US diplomat say dia advisory contain fake information.

    For email response to di BBC, the US embassy say dey get nothing to add to what di ministry say.

    Unlike many kontris for East African region, Tanzania adopt relax strategy for dia approach towards coronavirus, avoiding lockdown and instead emphasising protection of the economy.

    For Monday, Health Minister Ummy Mwalimu say dia be only four Covid-19 patients for hospitals for Dar es Salaam.

  19. Child abuse dey rise for Ethiopia ontop Covid-19 restrictions

    Child abuse dey really rise for Ethiopia capital, Addis Ababa, and report show say na di restrictions wey dem put for mid-March sake of coronavirus cause am.

    Data from hospitals show say dem rape more than 100 children and some na family members do am.

    Dem add say 50 women dem report assault.

    Sexual abuse of children na serious issue for Addis Ababa, and now wey schools dey closed and dem tell pipo to stay for home due to di Covid-19 pandemic, cases dey increase.

    One official for di city’s children and women’s affairs office tell BBC say dem dey treat victims for three facilities across di city.

    Dem no tok if anyone don dey arrested.

    Ethiopia don witness sharp rise for di number of pipo wey dey catch coronavirus in di past two weeks - plus 65 front-line health workers.

  20. Coronavirus spread go some schools for Israel

    Almost 7,000 students and teaching staff for Israel don dey quarantine and more dan 40,000 schools close sake of coronavirus outbreak according to official figures.

    But goment say make schools and kindagartens still dey open for now.

    These days, Jerusalem Gymnasia High School don get plenty new cases of coronavirus as 130 pipo test positive.

    Local media report say na one teacher wey sick begin dey spread di virus.

    For Tuesday, di health ministry record 116 new cases, di biggest figure dem see inside one day.

    Israel don report 17,342 cases and a total of 290 deaths.