Di prime minister of Mauritius don announce di lifting of di strict coronavirus lockdown from Sunday.
Since 20 March di Indian Ocean island nation, wey be popular tourist destination, dey only allow pipo to leave dia house if dem get work permit.
Dem dey also allow residents to go to supermarkets on some days depending on di first letter of dia surname.
But Prime Minister Pravind Jugnauth tok say supermarkets and shops go dey allowed to operate normally from 31 May.
Dem go also open restaurants, cafes and markets if dem follow certain conditions to prevent di spread of coronavirus. Dem fit also open place or worship.
However, beaches, nightclubs and cinemas go dey closed and di kontri border.
Mauritius don record 335 cases of Covid-19, including 10 deaths.