You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Flights between Beijing and Wuhan don resume

    Pipo go fit take flight from di Chinese city of Wuhan, di city where Covid-19 pandemic bin start go di city capital, Beijing, as flights resume for Tuesday afta Beijing comot im health emergency status from medium to low risk.

    According to di official China Daily, one plane don dey operate for di cities and travellers no quarantine for 14 days.

    Before di pandemic, Wuhan International Airport na one of di ogbonge transport wey dey carry pipo from far and near.

    But during di pandemic, Wuhan dey lockdown for 76 days and dem reduce transport to only wen na emergency.

  2. Coronavirus: Rivers State don review number of worshipers from 50 to 70

    Rivers State Governor Nyesom Ezenwo Wike don review di restriction for number of worshippers during church services from 50 to 70 persons.

    But dem still dey work out modalities for di number of Moslems wey go dey participate for Friday prayers.

    All dis na part of resolutions for di meeting di Governor hold with religious leaders for goment House for Port Harcourt.

    Governor Wike observe say since di last meeting dem hold for 23 March, 2020, di spiritual life of di pipo don go down as dem no dey meet dey pray and strengthen dia faith.

    Im commend di religious leaders for di way dem comply with di 50 pesins per worship sessions to check di spread of Covid 19.

    Di Governor frown for banks, supermarkets and oda institutions wey still dey allow pipo to enter di premises without wearing facemask. Im warn say goment no go hesitate to seal up such premises if dem continue.

    On di executive order on burials, Governor Wike explain say di N10 million naira fine for defaulters no be to make goment rich but na to discourage pipo make dem no break di guidelines wey dem don give.

  3. Kaduna state don lift partial lockdown

    Kaduna state north west Nigeria don lift di partial lockdown of di state.

    Di state govnor, Nasir el-Rufai make di announcement for state television broadcast, say beginning from Wednesday June 10 im don give permission to reopen di state.

    Im also reopen religious centres, supermarkets, hotels, barbing and hair dressing salon.

    Im also lift movement inside di state but put curfew from 8pm to 5am.

  4. South Africa teachers jolly for school closure

    One teachers union for South Africa say dem dey happy afta authority force some schools to close down for di mean time sake of say staff members bin test positive to coronavirus.

    Most of di schools for South Africa don open dia doors for grade 7 and 12 on Monday afta months of lockdown.

    Di educators Union of South Africa wey dey represent more than 27,000 teachers across di kontri, don accuse di education department for court say dem dey play with di health and safety of teachers and students.

    Two schools for Durban bin close down afta teachers test positive for Covid-19 and anoda one for Johannesburg close down afta reports of one positive test.

    On Monday, Gauteng provincial education minister announce say 38 schools for di province bin report cases of coronavirus and dem still dey trace and test those wey bin get contact wit di infected pipo.

  5. Asymptomatic spread of coronavirus “no dey common” - WHO

    One top oga for di World Health Organization, Dr Maria Van Kerkhove say pipo wey get coronavirus and no dey show symptoms no go fit spread di virus.

    Dr Maria Van Kerkhove wey be di technical lead for di health bodi say dos kain patients fit dey show small-small symptoms wey fit no get connection wit coronavirus.

    Di fact say initial studies bin tok say symptoms no dey quick show for pipo wey catch di virus body na di reason why experts say make pipo dey use masks for public spaces.

    Scientists don begin argue dis latest finding as some of dem say di agency fit dey tok about pipo wey neva begin show symptoms.

    While asymptomatic pipo no dey show signs of coronavirus, pre-symptomatic pipo no dey show signs some days afta dem catch di virus.

    As many kontris don begin dey relax lockdown for Africa and for di rest of di world, Dr Van Kerkhove beg goment say make dem focus on how dem go know and isolate patients wey dey show symptoms and begin contract tracing wit anybody wey fit don come in contact wit dem.

  6. Cameroon go experience 'peak' for coronavirus infection for July

      • Author, Bongben Jisi
      • Role, BBC Pidgin, Cameroon

    Cameroon health minister, Manaouda Malachie don tok say from de calculations from sabi pipo, dis moon end to July go bi de worse taim, peak for coronavirus infection .

    Cameroon na de kontri wit highest cases for Central Africa wit 8312 cases, 4794 pip recover, 208 don die.

    For June 8, out of 1627 test, 252 bi positive, 46 recover and two pipo die.

    For enta dis kana wowo period mean say plenti pipo go fit die for one day, plenti cases for one day, space no go bi for hospital and oda tins for dis taim.

    For make sure say pipo no di die laik for oda kontris abroad Italy, America, goment di take some actions.

    • Five private clinics don join for test pipo fast, two for Yaoundé and three for Douala, before na only public hospitals di do test.
    • More labs too di test, CPC Yaoundé, Chantal Biya research centre, Central hospital, CRESA for Yaounde and for Douala, Laquintini, Garoua, Bamenda and Bertoua.
    • Goment open plenti centres for collect samples for de whole kontri. For Yaoundé na about ten centres go test now, CSi Simbock, Omisport, CMA Oyomabang, CMA Ahaha, CSI Ekounou, Warda sport complex and specialised centre for police and army health units.

    More dan half for coronavirus cases dey na for Yaoundé.

    Cameroon di test about 800 pipo for one day now and kontri don 30,000 pipo, since weh kontri confirm de first case for March 6.

    “We target na for hit 50,000 tests for June 15”. Manaouda Malachie tok.

    For reach dia target, health boss say deh don buy 100,000 quick test for add to de 45,000 weh deh don first buy’am.

  7. Submit yoursef for Covid-19 test, if you go buy 'okrikra' for dis Nigerian market

      • Author, Princess Igho Williams
      • Role, BBC Pidgin

    Authorities don sama warning give pipo wey go buy 'okrika' (second hand or reused) cloths and shoes for one main town market for south west Nigeria, to shaperly submit demsef for covid-19 test.

    Rotimi Akeredolu, di Govnor of Ondo State post for im twitter handle say na from one store, Oja Oba market for central Akure na im di state pick dia number 43rd case of coronavirus.

    Govnor Akeredolu advise di pipo wey don go di market to come out for dia own interest and for di good of di society.

    • How e happun

    Health Commissioner for Ondo State, Wahab Adegbenro, tok say one lady afta dem diagnose her wit coronavirus for lmo State - south east Nigeria, she come run go Ondo State upon di interstate lockdown.

    Oga Adegbenro add say both Imo and Ondo goments come begin look for di woman and dem come finally pick her up wia she for dey sell okrika for Oja Oba market.

    As at today, Ondo state get 42 cases of covid-19 and di governor don advise im state pipo to make dia choice to choose between "life and death."

    "As a pipo, we must make a choice now, between life and death, between health and wealth and between stability and unhappiness.

    We must find a balance between our pleasure and daily freedom on di one hand and di survival and self preservation of our society on di oda hand."

  8. School reopening: See how some children dey learn without radio, TV or internet

  9. BBC Pidgin Minute

  10. 60% of nearly 1,000 death wey dem no fit explain for Kano na sake of covid-19

      • Author, Princess Igho Williams
      • Role, BBC Pidgin

    Nigeria health minister Osagie Ehanire don tok say up to 60% of nearly 1,000 deaths wey dem no fit explain for Kano, north west part of di kontri na probably sake of Covid-19.

    One investigative team reach di conclusion afta dem look into di increase in deaths across Kano state for April and early May - mostly among elderly pipo wey bin get issues with dia health before.

    Some of dem die for hospitals but more than half die for dia home. Di same kind of death wey nobody fit explain alsodey increase for oda states across northern Nigeria.

    Sake of di low testing rates and on top say Nigeria get di largest population for Africa, experts dey fear day di virus fit spread without no detection for Nigeria.

    So far 12,801 coronavirus cases na im Nigeria don confam and 361 deaths.

  11. Malaysia record dia lowest coronavirus cases in three months

      • Author, Fiona Equere
      • Role, BBC Pidgin

    Like many of dia South East Asian neighbours, Malaysia don avoid large Covid-19 outbreak.

    Di kontri health ministry just announce dia lowest number of new cases for two months – but dem get anoda threat from dengue wey dem don warn pipo about.

  12. Wetin you gatz sabi about checking, printing Jamb results 2020 free

  13. Una Goodnight!

    Dis na wia we go march break ontop our live coverage today.

    No forget to join us tomorrow again.

    You fit scroll down for Monday tori dem. But make we leave you with dis video from NCDC on how coronavirus take start.

    Remember, make you dey wash your hands. Covid-19 dey real.

  14. Nigeria go resume evacuation of nationals from abroad

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja

    Nearly four thousand Nigerians wey dey stranded abroad sake of covid 19 don get green light to return home- as goment approve new protocol to epp dia journey.

    Di National Coordinator of di taskforce, Dr. Aliyu Sani for di taskfoce briefing on Monday say any Nigerian wey wan come back must first get valid covid 19 test result within 14 days before dem go fit leave dia kontri back to Naija.

    E further explain say di evacuees gatz also sign undertaking say dem go get demselves accommodation for both Lagos and Abuja to stay do dia mandatory 14 days self isolation.

    Di Nigerian goment in di past weeks don evacuate close to one thousand Nigerians from Dubai, Uk, Lebanon, Saudi Arabia but later come stop di process sake of say goment bin dey spend so much for di process.

    Wen goment realise say e no fit carry di burden, e decide to suspend di whole evacuation process to enable am design better protocol wey go epp di kontri beta.

    For dis new protocol, 72 hours afta dem land di kontri, dem go do dem anoda PCR test to ensure say dem no get virus and afta di testing dem go find dia way.

    Dem go make sure say dem leave dia travel document wit immigration officials before dem leave di airport.

    Dem go pay for dia accommodation and make sure say dem dey within Abuja to do dia 14 days self-isolation.

    Oga Aliyu say about four thousand Nigerians dey outside di kontri wey wan come home and dat wit dis arrangement, dem fit bring back one thousand every week to clear di backlog wey dem get.

  15. Latest updates ...

    See di latest updates ontop coronavirus around di world.

    • Tanzania president say di kontri don dey 'free of coronavirus'
    • More dan 100,000 new cases don dey for nine out of di past 10 days - WHO chief
    • UK record dia lowest daily rise for coronavirus deaths since before lockdown on 23 March
    • New York City start to reopen, with as many as 400,000 pipo wey go go back to work
    • South African don reopen schools
    • Abia state govnor don test positive for coronavirus
    • South Sudan vice-president don recover from Covid-19
  16. School resumption: PTF say goment no ready to risk di lives of children

    Di Presidential Task Force on Covid- 19 don tell parents wey dey worry about wen dia pikins go resume school say make dem relax as goment neva dey ready to take any type of risk.

    Di minister of state for education, Chukwuemeka Nwajiuba say dem neva ready to lead di kontri into danger and e no wan experiment wit pipo pikin by opening schools.

    E say e don hold meeting wit NECO, WAEC oda exam bodies dem and dat dia plan na to see how safe e be to bring in those wey dey classes wey dem suppose write dia final exams.

    E further yarn say even if school resume, di teachers wey go teach di pikin dem no go fit come class because of di ban for interstate travel for di kontri.

    Di taskforce chairmo, Boss Mustapha say concerning school opening, dem wan thread wit care.

    E say some school get up to three thousand school pikin dem and dat e no go easy for any teacher to control dia play-play nature and by dat dem fit spread di virus among themselves fast-fast.

  17. See did rules pipo must obey to do burial for Rivers State

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Pipo for Rivers State Nigeria fit begin do burials as di State goment don bring out guidelines for pipo to follow to do burials for di State.

    Dis one dey come after plenti complaints saymortuaries for di State don full with deadibody after Governor Nyesom Wike ban all publicburials for di State since March 2020 sake of coronavirus outbreak.

    Di guidelines wey Governor Nyesom Wike sign dey under di Executive Order for di Quarantine Act as e concern coronavirus state say:

    • Any person wey wan conduct public burial weda na Christian, traditional or any religious burial, wey pipo go attend for public place for inside Rivers State or outside di State during di Covid-19 period must apply to di Governor for approval through di Commissioner for Health.
    • Di application for approval for di burial of any pesin wey die from 1 February 2020 must include di pesin death certificate wey go show weda di person die of coronavirus or not.
    • Dem go also write undertaking say dem go pay di sum of ten million naira (N10million) to di State goment if dem break or no comply with di conditions, protocols or guidelines wey dem don give.
    • If di pesin die of Covid- 19 and dem go bury am inside Rivers State, di Commissioner for Health go direct make dem do di burial immediately under di supervision of State Ministry of Health officials.
    • Di governor fit approve di application for burial if di Commissioner for Health recommend say di pesin no die of Covid- 19.
    • If dem go bury di pesin inside Rivers State, di burial go hold between 9am to 12pm and e no go pass three hours.Total number of pipo for di burial no go pass 50 pesins.
    • Evri pesin wey dey attend di burial must wear facemask and maintain social distance of 2metres.
    • If dem go bury di pesin outside Rivers State, dem must state am so for di application and di governor go approve accordingly.
    • If di pesin wey dem wan bury outside Rivers State die of coronavirus, dem go transport di deadibody under di supervision of Ministry of Health officials and comply with all oda conditions wey go prevent di spread of Covid-19 as di Commissioner for Health go recommend.
  18. Coronavirus outbreak for di world dey worse - WHO chief

    World Health Organization Director General Tedros Adhanom Ghebreyesus say although coronavirus outbreak cases for Europe don dey reduce but for di world di mata still tie wrapper as e dey worse.

    Oga Gebreyesus tok dis one as im dey brief tori pipo. He say for di last 9 to 10 ten days, dem don report more dan 100,000 cases and 75% of those cases na from 10 kontris and most of dem na Americas and South Asia.

    He say, im dey encouraged, wit di positive signs im dey see from several kontris.

    Di WHO Oga say di biggest gbege now na say kontris dey relax on top how dem don manage di virus. He say result from di studies wey dem do show say many pipo for di world still dey exposed to di virus.

  19. Tanzania President John Magufuli say di kontri don dey free of Covid-19

    Tanzania President John Magufuli tok say coronavirus don commot di kontri patapata.

    Oga Magufuli tell some worshippers for church say na prayers of di kontri pipo make Tanzania free of di virus.

    Di World Health Organization dey worry for di way di goment take dey handle di pandemic.

    Di goment bin stop to dey give informate on di number of coronavirus cases for di kontri.

    Di last time di kontri release official data na 29 April, and that time na 509 cases, wit 21 deaths for Tanzania.

    Oga Magufuli last week tok say only four patients dey receive treatment for Dar es Salaam, di largest city for di kontri.

    Last month, Tanzania goment bin bone one US embassy warning say di virus fit pass di power of dia hospital.

    Di president don tok am for several occasion say dem exaggerate di pandemic and e encourage pipo to attend services for dia mosques and churches, say prayers fit end di virus.

  20. 'Virtual fans' go ginger La Liga games for Spain

    Spain top-flight football competition La Liga go use virtual image dem of stands for television broadcasts plus "fan audio", wen dem resume on Thursday behind closed doors.

    Viewers for Spain go get di choice of normal or ogbonge digital broadcasts while international viewers go receive broadcasts with additional graphics plus atmospheric audio.

    La Liga, wey don work with one Norwegian company and di makers of di Fifa video game, say di technology go "allow make pipo see matches in an attractive way wey go closely resemble how dem bin look and sound like before dem postpone di competition".

    Virtual stands go display to-scale images of fans wey wear di home club colours and wey dem fit adapt to fit di flow of games, copy di reactions from situations likes goals.

    Di league restart with derby match between Sevilla and Real Betis (21:00 GMT), while champions Barcelona visit Real Mallorca on Saturday and Real Madrid host Eibar on Sunday.