Govnor Okezie Ikpeazu don test positive for coronavirus making him di fourth governor to test positive for di virus.
Govnor Ikpeazu of Abia State, south east Nigeria, na di number four govnor inside di kontri to catch di COVID-19 disease.
Onyebuchi Ememanka, di govnor Im tok-tok pesin, na im confam dis tori give BBC.
Di Commissioner for Information inside di state, John Okiyi Kalu, tok for one statement say di govnor don go isolation before dem confam im result positive.
And im don order di deputy governor, to act on im behalf until di time e resume dut, di Commissioner add.
On Saturday, 30th May, 2020, di Govnor bin volunteer im sample for COVID-19 test and direct members of di state Executive Council (EXCO) and those of di inter ministerial committee on COVID-19 to submit demsef for di same test.
On Tuesday, 2nd June, 2020 di result of Govrnor Ikpeazu test return back negative.
Then on Thursday, 4th June, 2020, di Governor submit anoda sample for di Nigeria Center For Disease Control (NCDC) lab for confirmation and di result return back positive.