You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Nigeria goment don reduce petrol price to between N121.50 to N123.50. See wetin dis mean

  2. Kogi state declare lockdown for Kabba-Bunu LGA

  3. South Africans start to jolly dia way to enta alcohol shops

    Long queue don dey form for di outside wia dem dey sell alcohol for South Africa as dem comot restrictions from im sale on Sunday.

    E don reach two months since dem ban di sale of alcohol for di kontri to reduce di spread of coronavirus.

    Social media show say plenti pipo don dey form long queue to buy am and di queue fit don start since last night.

    For social media, tops wey be di name of alcohol shop just dey trend.

    Tori be say dem introduce di ban to free police and hospital workers from alcohol violence to fit face di coronavirus palava. And e work even as coronavirus cases for di kontri still dey rise.

    For now di rule be say, pipo go fit buy alcohol to drink for dia house and na from Monday to Thursday dem go fit buy am.

  4. Most pipo for Malawi dey fear hunger pass Coronavirus

    One recent poll don show say 81% of Malawians no dey fear coronavirus but dem dey more worried about hunger.

    Those wey dey above di age of 55 dey less worried of di virus upon say na dem dey for higher risks than di younger population.

    About 60% of those wey dem ask question say dem dey more concern about di collapse of di healthcare system.

    Anoda 76% say dem dey afraid of stigma if dem catch di virus.

    Malawi Institute of Public Opinion and Research (Ipor) and Swedish researchers na dem conduct dis poll between 7 and 28 May.

    Di kontri wey dey for southern Africa don record 284 cases of Coronavirus

  5. Ondo don record dia fourth death from coronavirus

    Authorities for Ondo state, south west of Nigeria say two pipo die from coronavirus for di state.

    Dem say di patients die for UNIMED for Ondo town dis morning.

    As e be so, di number of pipo wey don die from Covid-19 for di state na four while 20 pipo don recover from di disease.

    Di state currently get 28 confirmed cases of coronavirus.

  6. Rivers State begin free transport service to support residents

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Rivers State Covid-19 free bus service don begin with 28 luxury buses wey go cover 4 local goment areas: PortHarcourt, ObioAkpor, Eleme and Oyigbo.

    Di free bus service go only pick and drop passengers for proper goment bus-stops for di State and dem go begin work from 6:30am to 7pm evri day for di period of di coronavirus pandemic.

    Commissioner for Transport Sunny Ejekwu say di reason dem choose di four local goment na because na dem get di highest number of pipo wey dey wakabout for business so dat na one way di goment wan take support pipo as dem dey fight di coronavirus.

    Ejekwu advise passengers make dem comply with all di rules wey dem put for dem to benefit wey be:

    • Dem must wear dia facemask before dem enter and even wen dem dey inside di bus
    • Dem must check dia temperature and use hand sanitizer before dem enter
    • Dem must observe social distancing for di bus and siddon one pesin per seat for each row.
    • Di bus wey get capacity to carry 48 passengers go only carry 22 pipo and di one wey be 24 go only carry 12 passengers.
  7. In case you just dey join us...

    In case you just dey join us, see di lates updates form around di world.

    • Some children dey return to primary schools for England but many go stay for home
    • Many European kontries dey lift restrictions further - some dey even open cafes, museums and cinemas
    • South Africans fit buy alcohol for di first time in two months but di reopening of schools dey delayed.
    • The Philippine capital Manila, wey be home to 12 million people, don comot from lockdown wey dey in place since mid-March.
    • The number of confirmed cases for Brazil don passes half a million
    • Globally, dem don confam 6.1m cases and 371,000 deaths wey link to Covid-19
  8. When schools go resume for Ghana? Dis be what we know

  9. Rivers State don extend stay at home lessons for Junior and Senior Secondary School

      • Author, Karina Igonikan
      • Role, BBC Pidgin

    Rivers State don extend stay home lessons for Junior, Senior Secondary classes.

    Rivers State Ministry of Education don begin digital/e-learning Stay home schooling for JS1 and JS2 students for junior secondary and SS1 and SS2 for senior secondary schools.

    For statement wey di Commissioner for Education Prof. Kaniye Ebeku sign, di digital/e-learning schooling dey start from 1 June 2020 and e go show for Raypower radio and AIT.

    Dis one dey join di ongoing e-learning for JS3 and SS3 students wey start since April 2020, for di state owned television RSTV and radio stations, Radio Rivers and Gardencity FM and dis ones go still continue.

    Di join body with Ministry of Information, ICT Department of di Governor Office and BrainFriend Solutions, say na way di state goment dey continue safe learning for school pikin dem for dia house as schools still shutdown for di state sake of di coronavirus outbreak.

  10. South Africans fit begin buy alcohol from Monday

    Pipo for South Africa from today go now dey free to buy alcohol for di first time in two months, as di goment don begin ease lockdown.

    Dem bin introduce di ban on alcohol to help police and hospitals focus on fighting coronavirus.

    Now, pipo dey free to buy alcohol from Monday to Thursday but dem go drink am only for dia houses.

    Di ban bin start for di beginning of South Africa lockdown order, to free up hospital beds and also to reduce domestic fights.

    Fight wey na alcohol cause na big problem for South Africa, particularly for weekends.

    Doctors and police say di impact of di ban don begin show as admissions from such incidents don reduce.

    But di kontri wine and beer makers don complain say dem dey make dem lose business. And di goment don lose big money from tax.

  11. Una welcome!

    Good morning.

    Welcome to our live page coverage of all di latest tori on coronavirus for Africa and across di world.

    Before we begin tell una about di big big tori dem, check out we today proverb from Reuben Otue.

    No forget to like and follow us for:

    • Twitter
    • Facebook
    • Instagram
  12. Una goodnight!

    Dis na wia we go march break ontop our live coverage today.

    No forget to join us tomorrow again.

    You fit scroll down for Sunday tori dem.

    Remember, make you dey wash your hands. Covid-19 dey real.

  13. Coronavirus cases for Cameroon don pass 6000 as hospital no get space again

    Coronavirus cases for Cameroon di da so climb ceiling as informate from public health emergency Centre di show.

    Situation for dis number 31 day for May show say Cameroon don confirm 6143 cases, 239 for one day.

    For today, 10 pipo recover for total 3578 pipo weh deh don well so far, but 191 pipo don die, six (06) inside 24 hours.

    Just now Cameroon no get space again for hospital, and goment di tell kontri pipo for respect barrier measures.

    Coronavirus situation in Cameroon on 31/05/2020

    • Confirmed cases 6143239 in 24 hrs
    • Recovered 357810 in 24hrs
    • Deaths19706 in 24hrs

    Source: Ministry of Public Health/Minsante

  14. South Africans fit buy alcohol from Monday

    South Africans go fit buy alcohol from Monday for di first time in two months, as di goment don ease one of di toughest lockdowns for di world.

    Dem introduce di alcohol ban to enable di police and hospitals to fit focus on fighting coronavirus.

    As e be, dem fit sell Alcohol from Monday to Thursday and dem only fit drink am at house.

    Di goment bin introduce di ban at di start of the lockdown to also free hospital beds and reduce domestic violence.

    Violence as a result of alcohol dey really cause gbege for South Africa, especially for weekends.

    Doctors and police dem tok say di ban help well well, as e help to reduce casualty admissions for hospital and station.

    But di pipo wey dey manufacture alcohol don too complain say e dey affect business. Goment sef don lost moni from tax revenues.

    South Africa dey ease some lockdown restrictions, as dem dey hope to revive dia economy even as infection rate dey rise.

  15. Nigeria 'digital Imam' wey dey preach for lockdown

  16. ''Pa Jerome bi don paralyse, e bi diabetic but hospital force we for sign Covid-19 wen e die''

  17. Rwanda don record dia first coronavirus death

    One 65-year-old driver for Rwanda don die with coronavirus – dis na di kontri first official death from di virus.

    Di kontri health health ministry tok for inside statement say di driver just return to Rwanda from one neighbouring kontri, wia im bin dey live, afta im fall seriously sick.

    Im die from severe respiratory complications as im dey receive treatment for di specialised Covid-19 facility.

    Di East African kontri get 359 confirmed cases of di virus.

  18. Di latest from around di world

    If you just dey join us see di latest headlines ontop Covid-19:

    • Di number of confirmed cases of di virus worldwide don pass six million, according to informate from US-based Johns Hopkins University. More than 369,000 pipo don die globally.
    • US President Donald Trump don postpone di G7 summit wey suppose hold for June. Im bin hope to host some pipo for Camp David and di White House, but German Chancellor Angela Merkel say she no dey go because of di outbreak
    • New York Govnor Andrew Cuomo say di katakata wey dey happun for America, sake of di death of George Floyd by policemen for Minneapolis, dey linked to many-many deaths of African-Americans of coronavirus. Minnesota Govnor Tim Walz tell protesters to wear masks and try to observe social distance.
    • Dem don open al-Aqsa mosque for Jerusalem, wey be third holiest site for Islam afta dem close am for two months. Hundreds of worshippers – wear masks - dey shout “god is great” as dem enter di mosque, while some kiss di ground.
    • Rio de Janeiro dey plan six-phase easing of lockdown restrictions, according to local media. Brazil na di epicentre of di virus for Latin America, with di second-highest number of confirmed cases for di world. Dia death toll don pass France own.
    • Belgian Prince Joachim, 28, don catch coronavirus afta im go party for Córdoba, Spain during lockdown. Spanish police don launch investigation into di party – anybody wey dem catch wey break di lockdown rules fit chop fine of up to €10,000 (£9,000; $11,100).
  19. Pipo react as Lagos record 378 news cases of coronavirus

    Nigerians react as Lagos record dia highest cases of coronavirus in one day on Saturday.

    According to di latest report wey Nigeria Centre for Disease Control, NCDC give, Nigeria record 553 new cases of Covid-19 disease for di kontri.

    Out of dat number wey NCDC report Lagos get 378.

    Dis na di highest number of cases di state don record in one day and dis bring di total number of infection for di kontri to 9855 cases with 273 death.

    As e be so Lagos get 4,755 confirmed cases of Covid-19, na dem get di highest number of Covid-19 cases for kontri.

    Di total number of pipo wey don recover from di disease for di kontri na 2856.

    See some of dia tweets on di latest NCDC report for social media.

  20. Una Good morning!

    We go begin our coverage wit dis better proverb. you agree with am?

    Oya go drop your own for we comment section on our Facebook, Twitter and Instagram page @BBCNewsPidgin. Make you also follow us and continue di conversation.