You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. 'No fear if goment official visit your area or house sake of covid-19' -NCDC

    Nigeria Centre for Disease Control don advise Nigerians not to fear if goment officials visit dia area or house.

    NCDC say dis na because goment officials dey try identify pipo wey fit don get contact with those wey test positive for coronavirus and so make Nigerians no discriminate those pipo wey dem visit or fear if dem see di officials.

    For one video wey NCDC do to sensitize pipo, dem say dis visit na for di good of di citizens.

    "Please make una no fear and no discriminate against those pipo wey di goment officials visit.

    Dis na for your own good, dis na so dat goment go test and treat those wey dey infected with covid-19."

    NCDC add for di video say coronavirus no be death sentence, because all of di world pipo of different background wey get di virus don get treatment and dem well plus go back home.

    "No discriminate those wey dey deal with di virus because dem need di support of everybody to support and care." NCDC tok.

  2. Governor Wike demolish two hotels wey no obey lockdown order

  3. How to take care of dreadlock for lockdown

  4. China dey offer help to North Korea for Coronavirus

    China Presido Xi Jinping don express worry give North Korea on top di threat of North Korea.

    Dis na as e bin dey respond to message im bin receive from di North Korean oga Kim Jong-um afta e bin congratulate China on top how dem dey deal with di coronavirus situation.

    North Korea neva announce any case of di virus for dia kontri but plenti sabi pipo tok say cases fit still dey di hermit Kingdom as dem dey near China wia di virus from start.

    However, North Korea na one of di first kontris to close down dia borders and end tourism on top di pandemic palava for January.

    Di fear now be say, if di virus enta di kontri, dia medical system no fit accommodate am even if di outbreak small.

  5. Cameroon confirm 2579 cases for Covid-19

      • Author, Bongben Jisi
      • Role, BBC Pidgin, Cameroon

    Cameroon Health Minister, Malachie Manaouda say as of today, Cameroon don confirm 2579 Covid-19 cases.

    From de statistics weh e tweet dis morning, out of 2579 cases since March 6 weh Cameroon announce first case,

    1465 pipo don recover, 121 pipo dey for hospital, 28 for oxygen, and 114 piipo don die.

    As de number of cases continue for rise, Manaouda di advice kontri pipo for stop stigma for pipo weh deh get dis sick .

    ‘Corona’ as no bi some kana sick for shame and e no suppose make we hide for house”, Mnaouda tok.

    Minister say make pipo no fear for go hospital for oda sick for fear say deh go get Coronavirus and also vaccinate pikin dem.

    “Make we protect we selves, families and odas, respect barrier measures or stay for house”. E add.

    Dis night, 139 Cameroonians weh deh stock for Dubai some weeks afta goment lock border for March 17 don turn back for kontri.

    Deh go enta quarantine, den deh test dem before deh fit go back for dia houses or hospital if deh test positive.

  6. Coronavirus: Dis nine year old pikin come up with ogbonge way to wash hand easy

  7. No open borders or lift ban on public gatherings - Ghana Medical Association to govment, Ghana Covid-19 cases reach 4,263 after de country record 251 new cases.

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    Ghana Medical Association (GMA) dey urge Ghana govment not to lift de ban on public gatherings.Dem explain say given de number of cases wey de country still dey record, things go fit get worse if churches, marriage ceremonies then other public gatherings start dey happen.A cross section of de public start dey speculate say in de days to come, Prez Akufo-Addo go lift de ban on public gathering.

    Dis be after some churches for Ghana start dey mount pressure on govment say make dem lift ban on public gatherings.

    De GMA reacting to de speculations dey argue say “non-adherence to Covid-19 preventive measures go fit erode de gains wey Ghana make in de collective fight against de disease.”

    Dem also add for statement wey dem issue inside say make govment no open international borders to travelers. Ghana Covid-19 cases reach 4,263 after de country record 251 new cases.

    De country also record 55 new recoveries which dey take de total to 378.

    Meanwhile, de death toll catch 22 after 4 people die.

  8. Coronavirus cases for world don pass four million

    More dan four million confam coronavirus cases don dey reported around di world, according to informate wey John Hopkins University collect.

    Di number of death around di world don also rise to more dan 277,000.

    Di US still be di kontri wey get di biggest blow, as only dem get over one quarter of di confam cases and one third of total deaths.

    Sabi pipo dey warn say di number of infections fit dey higher as low rate of testing for many kontries fit make di data no dey accurate.

    Daily number of deaths still dey drop for some kontries including Spain but some pipo dey worry say if dem ease lockdowns, e fit lead to “second wave” of infections.

    Goments dey also prepare for economic fallouts as di pandemic dey hit global markets and supply chain.

    Di director of China National Health Commission, Li Bin tell local media say di pandemic na “big test” wey don expose di weakness for di China public health system wia di pandemic bin start.

  9. Una good morning!

    Welcome to our live coverage of di coronavirus and how e dey affect di world.

    But before we go on, check out our proverb for today from Emeka Uchendu.

  10. Una Goodnight

    Na for here we go gbab break with our today live coverage ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    No forget to scroll down for Saturday tori dem and no also forget to join us tomorrow.

    Goodnight!

  11. Lagos residents fit experience anoda lockdown- Gov Sanwolu

    Lagos state governor, Babajide Sanwolu don tok say Lagosians fit experience anoda lockdown if dem continue to disobey goment directives to control di spread of covid19.

    Di governor tok dis one today during di press conference wey im do.

    "Di easing of dis lockdown depend on di compliance of each and everyone of us wey be di #takereponsibility.

    As a goment, dem elect me to take care of di security of all citizens and dis include health security also.

    Make I clear una, say we no go waste time to re-look into di lockdown, if we no see improvement for di next couple of days.

    I wan re-emphasise say if we no see improvement, we go dey forced to invoke again very-very painful decision of bring di entire state under lockdown again again."

    Lagos state na im get di highest cases of coronavirus inside Nigeria with record of 1,667 cases as at yesterday.

  12. Nigeria Center for Disease control say dem don do 25,015 covid-19 test

    Di Nigeria center for disease control (NCDC) say dem don do 25,015 coronavirus tests for di kontri.

    NCDC tok dis wan for dia situation report of May 8th. According to di report, 3,912 pipo get di virus while dem don discharge 679 pipo and 117 don die.

    NCDC say for Federal Capital Territory, dem dey worked with authorities for dia to set up covid-19 sample collection centres as part of community-level testing Through active case finding.

    Dem add say dem dey implement dia strategy to quick-quick detect new cases, isolate and manage dem to recovery.

  13. "Goment no send us"- Nigerian sex worker

      • Author, BBC OS

    One sex worker for northern Nigeria don tell BBC how coronavirus don affect her livelihood.

    She dey live for di mainly Muslim state of Kano, wey dey in di fourth week of a lockdown.

    No-one dey allowed to leave dia houses, except on Mondays and Thursdays between 10:00 and 16:00 to get food.

    And despite say na di holy month of Ramadan, Muslims no dey allowed to gather for prayers or for iftar meal to break fast.

    Aisha, no be her real name, say she dey struggle to survive because of di restrictions:

    Dem introduce Islamic law known as Sharia law for Kano state for 2000 and to oda areas of di north.

    Since den, prostitution, gambling ann di consumption of alcohol dey banned for Kano.

    Aisha say she never receive any form of official welfare support during di lockdown.

  14. In case you just dey join us...

    Dis an di latest from around di world.

    • Reports say UK goment dey plan 14-day quarantine for pipo wey land from anywhere except di Republic of Ireland.
    • Moscow celebrate Victory Day with flypast afta dem cancel di parade but full commemoration happun for Belarus.
    • China president express concern about di threat of di coronavirus to North Korea and offer dia help.
    • For South Korea, dem impose restrictions ontop bars and clubs afta transmissions dem link to Seoul leisure district
    • Di global confiam cases of Covid-19 don near 4 million, with 275,000 deaths
  15. Slovakia no record any new case for first time in months

    Slovakia no record any new case of di coronavirus for di first time in more dan two months, as di kontri begin dey reduce restrictions on life.

    As of 9 May, Slovakia don confam 1,455 cases and 26 deaths from di outbreak.

    At 0.5% per 100,000 people, di death rate for Slovakia na di lowest for di EU,according to data wey di European Centre for Disease Prevention and Control collect.

    Experts say Slovakia success in stopping di spread of di virus na sake of how dem quick-quick introduce lockdown, comply with am, and di effective messaging wey di media, do among oda factors.

    On Wednesday, Slovakia begin dey restart dia economy, by allowing shops outside shopping malls, hotels, museums, galleries and outdoor tourist attractions to reopen.

    Schools still remain closed and international passenger travel still never dey possible.

  16. Travellers to UK go face quarantine

    Di Uk goment plan to bring in one 14- day quarantine rule for pipo wey land from anywhere except di Republic of Ireland according to di airlines

    Di policy dey expected to come into force by di end of May and go require self-isolation for private residence.

    Tori be say di Prime Minister Boris Johnson go announce di two-week quarantine for international arrivals.

  17. Remdesivir drug, how scientists plan to use am treat COVID-19

  18. How Nasarawa beggars dey cope ontop coronavirus fear

  19. Ogbonge magician Roy Horn die afta im catch coronavirus

    Roy Horn, wey be di long time member of di magic group Siegfried and Roy don die at 75 afta im catch coronavirus.

    Pipo sabi Horn and im German partner, Siegfried Fischbacher for dia acts wia dem dey include white tigers and oda animals.

    Horn bin stop im tiger performance for 2003 afta di wild cat attack am during one dia shows.

    “Today, di world don lose one of di ogbonge pipo for magic but I don lose my best friend,” oga Fischbacher tok inside statement. “From di moment wey we meet, I know say me and Roy go change di world.”

    Di two bin meet wen dem dey work for one cruise ship but dem later sack dem afta dem bring real live cheetah inside di ship.

    Siegfried and Roy bin continue to dey perform wit white lions and tigers.

    Horn suffer serious injury afta one of dia tigers bite am for neck, drag am comot for stage during performance. Im also suffer stroke.

    Di injury bin affect how im dey waka and how im dey tok forever.

  20. Ogun state don extend lockdown again

    Ogun state Govnor, Dapo Abiodun don order extension of di lockdown by anoda one week.

    Im say di relaxation of di lockdown go still continue on Monday, Wednesday and Friday.

    Di Govnor wey announce di extension as im dey follow tori pipo tok, say, “Una, di entire pipo of Ogun state no elect me to make soft decisions. And tough decisions, we gats make.

    “Now, to make sure say pipo no die, we dey forced to extend di current lockdown wey we don ease small by anoda one week. We go review dis one base on normal level on weekly basis.”

    Abiodun threaten say im go deal wit those wey dey disobey di closure of interstate travel, to dey smuggle pipo in and out of di state.

    “Make I tok am as e be say we no take am easy wit any disobedience of di ban ontop interstate travel. We go treat anybodi wey we catch like say dem commit crime against Ogun state and dem go face di full weight of di law.”