Egypt doctors accuse goment for di death of dia colleagues
Egypt Health Minister, Hala Zayd, don order say make dem torchlight how one doctor wey catch coronavirus for duty take die as pipo dey worry say di number of health workers wey dey die don dey increase.
Tori pipo for Egypt say di order to torchlight di death of Dr Walid Yehia na from di President Abdul Fattah al-Sisi.
Dis dey come afta doctors union for di kontri issue statement for Monday wia dey claim say di ministry of health na dem dey responsible for di deaths of 19 doctors and more dan 350 doctors wey don catch di virus.
Di union, di Egyptian Medical Syndicate wey dey represent plenty doctors interest tok say di whole health system fit collapse if di health ministry continue to dey neglect wetin dem suppose do and meet di needs and dem no change how dem take dey relate wit medical staff.
Egypt don record nearly 18,000 coronavirus cases and 783 deaths according to John Hopkins University figures.