How voting go across Nigeria during di 2023 presidential election
Nigeria vote who dia next leaders go be inside presidential and legislative elections.
Live Coverage
Helen Oyibo and Victor Ezeama
Voting don start for Peter Obi polling centre
Article Information
Author, Chris Ewokor
Role, BBC News, Awka, Anambra state
Voting don start
for polling unit 019, Ward 2 for Amatutu, Agulu town for Nigeria south-eastern
Anambra state.
One
81-year-old, Peter Nedum, na di first pesin to cast im ballot here.
Dis na di
polling centre wia di presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi, dey
vote.
Despite
security concerns dey for di south-east region but voters appear eager to exercise dia
civic obligation.
Security
agencies don assure say dem dey on top of di situation and ask pipo to go about
dia lawful activities.
Breaking, Atiku cast im vote
Di presidential candidate of di People's Democratic Party, Atiku Abubakar don cast im vote for Yola, Adamawa state early on Saturday.
E arrive im polling unit for Ajiya ward 12 wia e cast im ballot at about 9:00am.
Wetin we call dis foto, Voters for Ajiya 12 polling unit Yola dey check dia names on INEC voters list
Mewanwhile former House of Representatives member Awwal Tukur bin tell BBC say im don dey vote for Atiku polling unit Ajiya 12 for di past two decades.
"Usually by dis time we dey get more voters," e tok.
"Also, I no see any women." E tok say im fear say di naira cash crunch fit don cause low turnout.
Pipo dey wait for APC presidential candidate Bola Tinubu polling unit
Di polling station wia di ruling APC Presidential Candidate, Bla Ahmed Tinubu neva ready for election.
Di polling unit for Alausa still dey half empty almost half an hour enta voting time.
INEC officials neva really show face and no body don see election materials.
Meawnhile, many tori pipo with cameramen don arrange demselves dey wait.
Nigerian celebrities dey ginger for election on social media
Article Information
Author, Olaronke Alo
Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
Nigerian celebrities don take to social media to share details of wetin dey happun for dia polling unit.
Dis na to ginger pipo to comot and exercise dia rights to vote.
Across di kontri, plenty pipo bin wake up early mor-mor to go queue. According to di Independent National Electoral Commission, Inec, polls open at 8:30am and e go close by 2:30pm. but anybody wey dey queue before dis time, go still fit vote.
See how some of di actors, actresses, influencers dey ginger for social media wit di hashtag #Nigeriadecides
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post, 2
INEC staff neva show face for polling units as voters dey wait
Article Information
Author, Tunde Ososanya
Role, Journalist, BBC News Pidgin
Voters for Etoi 1, 040 polling unit for Uyo local goment still dey wait for INEC officials despite di fact say many of dem don arrive as early as 6am.
One of di voters wey identify imsef as Paul say dem wonder why INEC neva show face for di polling unit.
Wetin we call dis foto, Paul say im don arrive since 6am.
Streets of Uyo dey deserted as Nigerians elect president and lawmakers
Article Information
Author, Tunde Ososanya
Role, Journalist, BBC News Pidgin
Di streets of Uyo, Akwa Ibom State, south-south Nigeria dey deserted as Nigeria dey vote for presidential and National Assembly elections today.
INEC staff and materials neva reach some of di polling units for di capital city.
Wetin we call dis foto, Streets of Uyo dey deserted as Nigerians elect president and lawmakers
Breaking, Voting don officially open
Voting don officially open for di Nigeria 2023 presidential and federal legislative polls.
According to Inec, voting go start by 8:30am and end by 2:30pm.
Distribution of election materials dey go on for PHALGA
Article Information
Author, Karina Igonikon
Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
Distribution of materials dey go on from dis Registration Area Centre (RAC) for Port Harcourt LGA.
Election officials dey carry both sensitive and non-sensitive materials from here to dia designated polling units for Wards 5 and 7.
Wetin we call dis foto, Election officials don collect materials for onward movement to dia polling units from di RAC Centre
Wetin we call dis foto, We dey wait for BVAS machine to move
Wetin we call dis foto, Election materials rest to move
Peter Obi head out to vote
Watch live: Labour Party Candidate Peter Obi tok to di press as e head out to vote.
Wetin you suppose know as you dey vote
In case you miss am, INEC wan remind you say:
BVAS na by force
No PVC, you no go vote
Mobile Phones still dey banned for voting cubicles
Voting go start by 8:30am for morning and go end by 2:30pm for Afternoon.
But all voters wet dey for queue before 2;00pm go still fit vote.
How to vote for Nigeria general election
ICPC arrest man wey dey cari N2m go meet politician for Bauchi
Article Information
Author, Olaronke Alo
Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
Wia dis foto come from, ICPC
Di Bauchi
State Office of di Independent Corrupt Practice Commission, ICPC say dem arrest one
man dem catch wit a sum of two million naira cash on Friday.
According to dem, di suspect confess
say dem dey move di funds to Gombe State for one politician.
ICPC say Ahmad
bin dey in possession of N900,000 cash for new naira notes and N1.1 million for
old naira notes and dem dey cari di money inside one tinted black Hilux motor
Di funds dey
packed inside one "Ghana Must Go" bag, ICPC tok.
ICPC say dem
don hand di suspect to di anti-graft agency for di state.
'I no sleep well last night becos I dey ginger to vote'
Wetin we call dis foto, Ibrahim Uba say e no sleep well as e wan vote
Some voters wey wan participate for di 2023 presidential elections wey dey happun today don already begin gada for Kano state northwest Nigeria.
BBC Pidgin meet some of dem for Shagari Quarters polling station and dem tok say dem wan play part in changing Nigeria na why dem comot early.
72-year-old Ibrahim Uba comot since 6am and tok say e no sleep well last night as e just wan cast im vote.
“Dis voting na wetin dey my mind all night, I wan exercise my right to better di kontri.”
Hadiza Sani also comot early and tok say she wan make her vote count na why she comot.
Voting go start officially at 8:30 Nigerian time
Millions dey vote for tightest-ever poll
Article Information
Author, Nduka Orjinmo
Role, BBC News, Abuja
Wia dis foto come from, Reuters
Millions of
Nigerians dey due to vote for di most competitive presidential election since
military rule end.
Since 1999,
Africa most populous kontri don dey dominated by two parties – di ruling APC
and di PDP.
But dis
time, e also get a strong challenge from one third-party candidate - di Labour
Party Peter Obi, wey dey backed by many young pipo.
Current
President Muhammadu Buhari dey step aside afta e don serve two four-year terms.
Im All
Progressives Congress (APC) dey represented by former Lagos governor Bola
Tinubu, while former Vice-President Atiku Abubakar dey stand for di main
opposition Peoples Democratic Party (PDP). Na total of 18 presidential
candidates dey di ballot.
Di election don
see huge interest from first-time voters and young pipo - one third of di 87
million eligible voters dey below 35 - wey fit lead to high voter turn-out than
di 35% wey dem record for 2019.
Voting dey
expected to begin at 08:30 local time (07:30 GMT), though anybody wey dey di queue
before e ends for 14:30 go still fit vote.
Dem dey also
hold elections for 109 federal senators and 360 members of di house of
representatives, and dat for govnors dey hold in March.
Di
Independent National Electoral Commission (Inec) don promise free and fair
elections, and dem don dismiss tok of postponement as pipo bin fear say insecurity
for parts of di kontri fit affect im preparations.
Dis na di
first time Inec go conduct national elections wit di use di Bimodal Voter
Accreditation System (BVAS), one facial and fingerprints technology wey dem
tink say e go improve transparency as e go make am harder for politicians to
rig di process.
Dem announce
final results on di third day afta voting for di last two elections,
but dem fit come in earlier dis time sake of BVAS, wey also dey upload vote
results directly to di Inec website direct from polling stations.
One
candidate need to get di most votes and 25% of ballots cast for two-thirds of
Nigeria 36 states to be declared as di winner
If no-one
achieve am, run-off go happun within 21 days – and dis go be first for Nigeria
history.
INEC drop election plans for today
Wia dis foto come from, INEC
Di Independent National Electoral Commission, Inec do dia last briefing for Abuja on Friday as to how di election go waka.
Di chairman of di commission, Professor Mahoom Yakubu tok say, di voting go start by 8:30 for morning and go close by 2:30 for afternoon.
Howeva, if pesin don dey queue before 2:00pm, dat pesin go fit still to cast dia vote.
E join add say, you no fit vote without your PVC even as fake news don dey trend on top how o vote without di Permanent voters card.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Wetin you need to know about Nigeria 2023 elections
Di Nigeria election dey come as many kontri pipo no dey happy sake of di insecurity and economic hardship.
From di Boko Haram insurgency for di north east to di banditry for di north west, kidnappings for di south and armed men attacks for di south east, insecurity don spread and become sometin of serious concern.
Di introduction of a new economic policy wey redesign old naira notes of 1,000, 500 and 200 cause serious cash scarcity in di build up o di election and na palava wey kontri pipo still dey face.
Di presidential and federal legislative elections dey happun on Saturday 25 February 2023.
Di state govnors elections go also take place on Saturday 11 March.
A total of 18 candidates dey campaign for di top job, but only three get a high chance of winning, according to opinion polls.