How voting go across Nigeria during di 2023 presidential election
Nigeria vote who dia next leaders go be inside presidential and legislative elections.
Live Coverage
Helen Oyibo and Victor Ezeama
Protest for Amuwo Odofin area of Lagos state as pipo no fit vote
Wetin we call dis foto, Woman dey protest
Some pipo for Amuwo Odofin, lagos, South West of Nigeria dey protest as both materials and electoral officials neva arrive as at 12:30pm.
Wetin we call dis foto, Man wey never vote dey protest
Wetin we call dis foto, Man dey protest
E no dey clear why but voting officially start since 8:30 for morning
BBC Pidgin Andrew Gift dey report live from di area.
Wetin we call dis foto, Pipo dey protest for Amuwo Odofin
Elderly pipo tok wetin dem want from presidential election winner
Article Information
Author, Tunde Ososanya
Role, Journalist, BBC News Pidgin
Wetin we call dis foto, Chief Steve
Elderly pipo for Onna Local Goment Area of Akwa Ibom State say anybodi wey win di presidential election gazz remember dem and make dia life easy.
Chief Steve wey follow BBC Pidgin tok say im be 83 years and wetin im want be say make di winner of di election remember im and oda Nigerians so tins go dey easy for dem.
Udia Saturday wey be 73 years say im want di winner to bring good tidings to Nigerians.
Wetin we call dis foto, Udia Saturday na 73 years.
One elderly woman, Joy Saturday, wey also follow BBC Pidgin tok say she want di presidential election winner to provide employment for Nigerians.
Wetin we call dis foto, Joy Saturday say she want di winner to provide employment
One retired Master Warrant for di Nigerian Army, Harford John wey be 80 years old say wetin im want di presidential election winner to do na make e ensure say peace reign for Nigeria.
Wetin we call dis foto, Harford John say im want peace to reign for Nigeria
Anoda elderly man Udo Sam wey be 85 years say na wetin go favour Nigerians di presidential election winner gazz do.
Wetin we call dis foto, Udo Sam na 85 years voter
52-year-old Emma Saturday say she want di presidential election winner to provide housing for Nigerians.
Wetin we call dis foto, Emma Saturday pose wit her PVC
'Bodi dey sweet me as I come vote' - First time young voter, Many young pipo comeout to vote for di first time
Article Information
Author, Tamara Ebiwei
Role, BBC News Pidgin
Twenty-One year old Comfort Ezekiel na first-time voter, she say she wake up early mor-mor to come cast her vote.
"I believe say my vote go count, na why I dey patient dey wait. E dey pain me say uptill now, officials neva come, but I must vote today"
She say belle dey sweet her as she be part of pipo wey go choose leaders for Nigeria.
Wetin we call dis foto, Comfort Ezekiel na first-time voter and she dey 21 years old
'I just pray say di election go well'- Chidera first time voter
Article Information
Author, Princess Igho Williams
Role, BBC Pidgin
Wetin we call dis foto, Juwah Chidera Stella wey be 22 years old dey vote for di first time
Juwah Chidera Stella wey be 22 years old dey vote for di first time.
Di first time voter wey carry her pet follow body to cast her vote dey hope say di election go waka well:
"I just pray say di election go waka well because na wetin we want."
Chidera go vote for ward 4 Asagba Secondary School, Umunkwo Asaba Delta State.
Wetin we call dis foto, Voting dey go on for ward 4 Asagba Secondary School, Umunkwo Asaba Delta State.
Wetin we call dis foto, Voting dey go on for ward 4 Asagba Secondary School, Umunkwo Asaba Delta State.
Breaking, Kwankwaso don cast im vote
Wetin we call dis foto, Kwankwaso as e dey vote
D presidential candidate for di NNPP, Rabiu Kwankwaso don cast im vote.
Di former govnor of Kano state vote for im polling unit for Madobi local govt, Kano state.
'Uptil now we neva see election materials and officers' - Abuja voters
Article Information
Author, Tamara Ebiwei
Role, BBC News Pidgin
Some voters for Abuja, Nigeria capital dey vex say uptil past 11:00a.m, dem neva still see Inec official.
Di Aleyita Primary School Polling Unit don almost fill up wit plenti voters dey don dey wait since early mor-mor.
Some women say dem leave dia children for house to come vote while oda nursing mothers tie dia pikin for back dey wait.
Some voters para say na almost 12:00 noon dem neva see any official.
"Until now, we neva see election materials, no official, di ones wey come say here say no be di place, say dem make mistake, dem waka go back" one voter tok.
Inec Oga Prof Mahood Yakuby say voting suppose start by 8.30 but na almost 12 pm and no official don show face.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Breaking, Peter Obi cast im vote for Agulu
Di Labour Party Presidential candidate Peter Obi don cast im vote for Agulu town, Anambra.
E arrive im polling unit 019, Ward 2 for Amatutu, at about 11:30am on Saturday.
Im vote alongside wit im wife, Margaret Brownson Obi.
E be like business as usual for some polling stations for Kaduna
Article Information
Author, Onyinye Chime
Role, BBC News, Kaduna
E be like business as usual for many of di polling stations for Kaduna metropolis.
Pipo gada for much of di polling units but Inec official neva come.
For some oda pipo, na business as usual as petty traders particularly food sellers dey sell dia market, odas set dey wait for buyers.
'I dey excited as first time voter'
Article Information
Author, Princess Igho Williams
Role, BBC Pidgin
Wetin we call dis foto, Chiamaka wey be first time voter say she dey excited
First time voter, Chiamaka say she dey excited to vote for di Nigeria 2023 general elections.
Chiamaka wey be 23 years old tell BBC Pidgin say she come di polling unit as early as 8:30 am but voting neva start.
She go vote for Ward 5 Abuato Primary school Asaba, Delta State and dey hopeful say di election go Waka well without any palava.
BVAS machine no allow Wike vote
Di Govnor of
Rivers State, Nyesom Wike never fit cast im vote sake of challenge wit di BVAS
machine for im Polling unit for Ward 7 unit 9 Rumuepirikom, Obio Akpor LGA.
INEC
officials advise am make im return later as dem don invite dia technical team to
check di device.
Di Govnor
bin dey dia wit im wife, Justice Eberechi Suzzette Nyesom-Wike to cast dia
votes.
E express
disappointment wit di inability of di BVAS machine to function well and advise
INEC to make sure say dia machines function well before election day.
How di election dey waka for Asaba, Delta State
Article Information
Author, Princess Igho Williams
Role, BBC Pidgin
Wetin we call dis foto, Ward 9 Uzoigwe Primary School Asaba, Delta State
Pipo don tanda to cast dia votes for different wards for Asaba Delta State on top di presidential and National Assembly election wey dey take place today all ova di kontri.
For ward 5 and 9 for Asaba, voters bin start to dey queue up as early as 7:00am but voting neva start.
Dis na as INEC staff neva land di polling units.
Wetin we call dis foto, Ward 5 Abuato Primary School Asaba
One voter for Ward 5 Abuato Primary School Asaba, Chinedu follow BBC Pidgin tok say im don dey wait since around past 7:00am.
"Since afta 7:00 am wey I come till now wey be 8:48am, INEC neva still set up dia cubicle wey pipo go take vote."
Wetin we call dis foto, Chindeu for ward 5 Abuato Primary School Asaba
"Na only di NYSC adhoc staff don come but we dey still dey wait for voting to start so dat we go fit exercise our franchise," oga Chinedu tok.
Meanwhile, security operatives dey on ground to make sure say di voting waka smoothly.
Akwa Ibom Govnor Udom Emmanuel cast im vote
Article Information
Author, Tunde Ososanya
Role, Journalist, BBC News Pidgin
Govnor Udom Emmanuel of Akwa Ibom State don cast im vote for Awa Ward 1, unit 1 and 2, Onna Local Goment Are of di state.
Wia dis foto come from, ANNIEFIOK
Wia dis foto come from, ANNIEFIOK
President Muhammadu Buhari cast im vote for Daura
Article Information
Author, Olaronke Alo
Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
Nigeria
President Muhammadu Buhari don vote for im constituency for Daura town for
Katsina state.
Di president
wey come out at about 9:30 for morning cast im vote togeda wit im wife, Aisha
Buhari.
Muhammadu
Buhari dey complete im eight-year term of office dis year, wia im dey set to
hand ova power on May 29, 2023.
Di kontri national television station tweet di moment Buhari cast im vote
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Okowa don cast im vote
Wia dis foto come from, SAMUEL JIBUNOR
Delta State Govnor and di Vice Presidential Candidate for di PDP don cast im vote.
E vote for Polling Unit017/ Ward 002 for Egbohoa Primary School, Ika North East local government Area, Delta State
Watch: Di moment Atiku vote
Watch di moment di Peoples Democratic Party, PDP candidate Atiku Abubakar vote for di election.
Wetin we call dis Video, Atiku Abubakar cast im vote for Adamawa
Breaking, Tinubu don cast im vote
Presidential candidate of di All Progressive Congress, APC, Bola Tinubu don cast im vote for Ikeja, Lagos state.
E arrive di polling unit alongside im wife, Remi Tinubu. She also don cast her vote.
‘E dey discouraging say INEC staff neva show face’
Article Information
Author, Tunde Ososanya
Role, Journalist, BBC News Pidgin
At 10:00 am voters for Ward 4, unit 018, National Open University for Uyo, Akwa Ibom State voters still dey wait for INEC staff to show face as voting suppose don start.
Some of di voters wey follow BBC Pidgin tok say dem don dey for di polling unit since 7am.
Wetin we call dis foto, Grace tok say e dey discouraging say INEC staff neva show face for her polling unit
First time voter wey identify herself as Grace say e dey discouraging say INEC officials neva show face but e no go discourage am to come back for di govnorship and state house of assembly elections.
Wetin we call dis foto, Young lady with her PVC
EFCC officials spotted for Tinubu polling unit
Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC tanda gidigba for di polling unit of di All progressives Congress, APC presidential candidate, Bola Tinubu.
Di officials of di anti-graft agency also dey across polling units for di kontri as di Nigeria presidential election dey happun.
EFCC deploy staff to monitor di election and stop any financial mago-mago wey fit happun to alter di outcome of di election.
Meanwhile, for Bola Tinubu polling unit, voting neva start.
‘We want our votes to count’, Polling units dey set up for Rumuwoji town hall
Article Information
Author, Karina Igonikon
Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
Wetin we call dis foto, Election officials dey set up voting booths for Rumuwoji townhall
Election materials just arrive Rumuwoji town hall, Port Harcourt LGA Rivers State wey get plenti polling units for award 11, 12 and 13 PHALGA.
Some early voters wey come to cast dia votes tell BBC Pidgin say dem dey determined to cast dia votes becos dem want Nigeria to change.
Benibo na first time voter. E dey disappointed say election materials bin never arrive im polling unit by 8;00am as e come out early to cast im ballot. E dey determined to vote dis time around becos, “di suffering too much! Before, I no boda becos tins dey go well, we dey mange, but now, no. I must vote for tins to change.”
Wetin we call dis foto, Benibo, a first time voter dey determine to cast im ballot becos di suffering too much
Wetin we call dis foto, Ma Victoria Briggs want di new goment to make cost of garri cheap so di ordinary man fit see am chop
Ma Victoria Briggs wan make di new goment make garri cheap so poor man go see am chop. She want make goment look into pensioners mata too, increase di money and bring work for di young ones.
“Dis days, children go school finish no work, e no good na. So we want dis new goment to make life easy for us. We dey suffer.”
For Francis Nwogu wey don voter many times before, e want make goment make sure say dia votes count.
“We don see before wey pipo vote di pesin dem want but na sometin go happen and anoda pesin wey you no expect go enta office. I want make INEC assure us say dis time around, our votes go count.”