How voting go across Nigeria during di 2023 presidential election

Nigeria vote who dia next leaders go be inside presidential and legislative elections.

Live Coverage

Helen Oyibo and Victor Ezeama

  1. Wetin don happun so far?

    Angry protesters wey no fit vote early for Amuwo Odofin

    Inec make good dia promise to conduct presidential and parliamentary elections on Saturday for Nigeria.

    Dis na a summary of wetin don happun so far.

    • Polls officially open at about 8:30am across Nigeria
    • Reports of late arrival of electoral officers dey across di kontri
    • Some polling units no start election till past di time, 2:30pm wey Inec say election suppose start
    • Reports of ballot box snatching and destruction, voter intimidation and attacks dey recorded for some places for Lagos state including Lekki and Surulere
    • Inec Oga Yakubu say armed men also attack some polling units for di southern state of Delta and di northern state of Katsina, wia dem tiff voter card verification machines
    • Inec postpone 141 polling stations for Bayelsa because of katakata
    • Oga Yakubu say militant Islamists bin open fire on electoral officers from a mountain top for Gwoza area for Borno, north east Nigeria and dem injure some officials
    • Voting go continue for some states for di kontri today
  2. Una good morning!

    We don come back.

    Una welcome to our live coverage of di 2023 Nigeria elections wey begin wit di presidential and parliamentary elections on Saturday, 25 February.

    Our reporters dey across Nigeria and dey give us all di latest as dem dey land.

    As we dey get dem, we go dey give una.

    But first, take dis proverb take cool body.

    Picture of a chicken

    Wia dis foto come from, Getty Images

  3. Una good night!

    Na here we go march break wit our live election updates.

    Join us again tomorrow by 7:00am as we go bring una tori as e dey happun across Nigeria.

    Meanwhile, you fit scroll down for all di tori wey you fit don miss.

  4. Charly Boy meet Davido for election wakawaka

    Nigerian musician, Charly Boy express excitement as e meet popular artiste Davido wen e dey do im election waka-waka.

    Di singer enta social media to share im happiness.

    “Meeting one of my favourite artiste OBO as I dey scooter for Bourdillon today.

    I dey so star struck, e even help me take dis foto on my phone.

    Na so my hand dey shake as I see Davido,” e write

    Davido no dey active on social media again afta e lose im son for October last year.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  5. Rabiu Musa Kwankwaso win polling unit

    Rabiu Musa Kwankwaso win polling unit

    Wia dis foto come from, Rabiu Musa Kwankwaso

    Wetin we call dis foto, Rabiu Musa Kwankwaso win polling unit

    Di Presidential candidate for New Nigeria Party, Rabiu Musa Kwankwaso don win im polling unit for Tandu 005, Kwankwaso ward.

    NNPP = 284

    APC=113

    Labour party – 0

    PDP - 0

  6. PDP win one polling unit for Kaduna state goment house

    Kaduna state govnor dey go vote

    Wia dis foto come from, Nasir El-Rufai

    Wetin we call dis foto, Kaduna state govnor dey go vote

    Peoples Democratic Party Presidential Candidate, Atiku Abubakar don win for one polling unit inside Kaduna state goment house.

    Kaduna state na one stronghold of di ruling All Progressives Party and di govnor, Nasir El-Rufai na strong APC stakeholder.

    Dis na di result from Sir Kashim Ibrahim House polling unit for Badiko, Kaduna South.

    APC – 40

    APGA – 01

    LP – 48

    PDP – 69

    YPP – 1

    Total valid votes – 170

  7. Peter Obi vice, Datti-Ahmed lose for im polling unit

    Labour party vice president candidate ready to cast im vote

    Wia dis foto come from, Labour Party

    Wetin we call dis foto, Labour party vice president candidate lose for im polling unit

    Di vice-presidential candidate of di Labour Party Yusuf Datti Baba-Ahmed lose im polling unit to Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party for Zaria LGA of Kaduna state.

    For inside di result wey di Presiding Officer for polling unit 021 for Tudun Wada ward announce, PDP win di polling unit wit 102 votes.

    Followed by di All Progressives Congress wey score 98 votes. While LP come third wit 54 votes and NNPP secure 11 votes.

  8. Police dey investigate allege video threat to voters by suspected thug

    Authorities say dem dey investigate one viral video wia some pipo dey threathen voters for Lagos.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    For di video wey be 28s di man dey tell voters say If dem no fit vote for APC here make dem go dia house

    Dis na di tins wey im tok inside di video e say “nobody force you come here, go your house oh. "

    “If I see you vote anoda party you go enta Asun. "e kontinu.

    Di video end wit as e say “We no come joke for here, dis territory wey u dey na APC, go your house, go relax."

    Benjamin Hundeyin tok-tok pesin for Lagos state command di video dey criminal and e dey against di Electoral act 2022

    Hundeyin say “investigation and prosecution go begin."

  9. Fotos of how pipo dey vote for night for Amuwo-Odofin for Lagos

    Pipo dey use torchlight dey vote for Amuwo Odofin polling unit 53 and 54 for Lagos South West of Nigeria.

    Dis na as di election don turn to night affair.

    Protest bin happun earlier for di area as both materials and electoral officials no quick come.

    Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
    Wetin we call dis foto, Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
    Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit

    Wia dis foto come from, Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit

    Wetin we call dis foto, Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
    Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit

    Wia dis foto come from, Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit

    Wetin we call dis foto, Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
    Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
    Wetin we call dis foto, Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
    Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
    Wetin we call dis foto, Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
    Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
    Wetin we call dis foto, Pipo dey queue to vote for Amuwo Odofin polling unit
  10. Rain mark di end of voting for Abuja on election day

    Pipo for dia polling unit

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Pipo turn out to vote

    Now, na heavy rain dey fall for di capital, Abuja – di first time dis year and symbolically, e dey mark di official end to voting.

    Pipo wey dey superstitious dey read meaning to di rain, while those wey hang around during di sorting of ballots for polling stations don run for cover.

    Today don be one of those eventful days wia dem blame security fears and logistical problems for di delays wit voting – pipo still dey queues for some parts of di kontri.

    Some fotos show di ginger of young voters, like di bride wey turn up to vote wit her wedding dress:

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Inside di violence wey happun for one polling station for Lagos state, one woman wey dem stab but later return to vote with her face wey dem don patch up make oda voters begin hail her.

    All eyes go now dey on di central collation centre for Abuja wia dem go send di results from di hundreds of thousands of polling units to.

  11. We go hold INEC responsible for all di mago-mago for dis election - NLC, NLC dey vex sake of alleged voter suppression, violence and thuggery wey happun for some polling units for Nigeria today

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin
    NLC

    Wia dis foto come from, NLC

    Di Nigeria Labour congress don react to di way wey Inec conduct di 2023 Presidential and National Assembly elections wey happun today 25 February across di kontri.

    Di Labour Union say dem bin dey hopes say di election wey happun today go beta pass di previous ones but sadly, Inec crash dia hopes.

    President of di Labour Union for Nigeria, Comrade Joe Ajaero, for inside statement tok say "We bin hope say voting materials go reach dia destination early, so dat dem go keep strictly to di voting time frame to prevent disenfranchisement of potential voters, but di report wey dey reach us from differnt prts of di kontri dey contrary to di high hopes wey we bin get before today's exercise"

    "Di experiences of yesterday suppose to don prepare Inec to conduct beta election dis year"

    E para say as late as 12 noon voting materials neva reach some polling units. NLC add say dem dey worried by di katakata wey happun for some polling units, and di way wey thugs dey operate even for security pipo front.

    "Di NLC go directly hold Inec responsible for all di mago-mago wey dey associated wit dis election," e tok.

  12. IGP supervise security arrangements for Abuja polling units

    IGP supervise security arrangements for Abuja polling units

    Wia dis foto come from, NPF

    Wetin we call dis foto, IGP supervise security arrangements for Abuja polling units

    Di inspector General of Police, Usman Aalkali Baba dey supervise security arrangements and conduct of di 2023 general elections.

    Dis na as e visit several polling units within di Federal Capital Territory, Abuja on Saturday.

    IGP supervise security arrangements for Abuja polling units

    Wia dis foto come from, NPF

    Wetin we call dis foto, IGP supervise security arrangements for Abuja polling units
    IGP supervise security arrangements for Abuja polling units

    Wia dis foto come from, NPF

    Wetin we call dis foto, IGP supervise security arrangements for Abuja polling units
  13. How presidential candidates win for dia polling units

  14. Pipo happy well-well as election officials finally arrive one polling unit for Lagos

    Voters for Lagos happy well-well as electoral officers land dia polling station for di suburb of Lekki nearly four hours afta polls don officially close.

    Wen BBC visit di polling unit for Dowen College earlier today, election no hold sake of say no election officials, no voting materials or security operatives on ground.

    Ofure Ukhuegbe, one voter wey bin wait there all day, film di arrival. She say pipo dey determined to vote tonight e no mata di time.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  15. EFCC election monitoring team suffer attack for Abuja, Imo

    bus wey im windows don break

    Wia dis foto come from, EFCC/ Twitter

    Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don tok say dia team of operatives wey bin dey monitoring duty for di presidential and national assembly elections today suffer attack by political thugs near Chief palace for Bwari Area council of di Federal Capital Territory.

    Di attack follow di arrest of one man sake of say e allegedly mastermind one well planned vote buying procedure for di polling unit wey dey Science Primary School, Bwari, EFCC post for social media.

    “Di team bin arrest di suspect, wey dem say dey about 30 years old, and retrieve list of beneficiaries wey e already plan to pay money to, through one online banking app from am”.

    Na for di point of moving di suspect away from di polling unit wey di thugs attack.

    Dem smash di windshield of di Commission patrol van, dem add.

    For anoda one wey look like dat, one team of EFCC operatives wey dey election monitoring duty for Unit 001, Mann Primary School behind Cherobim junction dey shoby unknown pesins two black Prado SUVs and one white Hilux outside di polling unit, wey dem suspect say dey buy votes.

    Di EFCC team respond, force dem to run from di scene. Di incident dey formally reported to DCP Operations, Haruna Femi for di Imo State Police Command, di financial crimes joinbodi tok.

  16. Peter Obi win im polling unit as APC, PDP get zero votes

    PDP and APC score zero for Obi polling Unit

    Wia dis foto come from, Peter Obi/Facebook

    Peter Obi wey dey contest di presidential seat under di Labour Party (LP) don win for im polling unit for Anambra state.

    For polling unit 19 for Agulu 2 ward of Anaocha LGA wia Obi vote, di Labour Party bin get 236 votes.

    Both di All Progressives Congress (APC) and di Peoples Democratic Party (PDP) get zero votes for di polling unit.

    Di All Progressives Grand Alliance (APGA) gbab three votes, and di New Nigeria Peoples Party (NNPP) bin dey able to gbab two votes.

  17. Inec suspend election for some Bayelsa polling units

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) don suspend elections for 141 polling units for di oil-rich southern state of Bayelsa.

    Inec boss Mahmood Yakubu say dem postpone di elections sake of say dem scata di voting process.

  18. Official anouncemnt of final results go start tomorrow - INEC

    Nigeria

    Wia dis foto come from, INEC

    Di oga of Nigeria election body say dem go open di collation center for di presidential election midday on Sunday.

    Prof Mahmood Yakubu tok dis one as im bin dey brief tori pipo ontop di election mata for Abuja.

    Dis dey come as voting don end for some places across di kontri for di presidential and national assembly election.

    While some places for di kontri voting still dey go on, as material get to those places late.

    Di winner of di presidential election go take ova from Buhari for May 29 wen im tenure end.

  19. Buhari tok why e show im ballot paper afta voting

  20. PDP Presidential candidate win im polling unit

    Atiku Abubakar dey cast im vote
    Wetin we call dis foto, PDP Presidential candidate win im polling unit

    Peoples Democratic party Presidential Candidate, Atiku Abubakar wim im polling unit for Ajiya ward 12.

    PDP-282

    APC- 57

    LP- 6

    Alliance Party -2

    NNPP 1

    Boot Party 1