How voting go across Nigeria during di 2023 presidential election
Nigeria vote who dia next leaders go be inside presidential and legislative elections.
Live Coverage
Helen Oyibo and Victor Ezeama
APC Presidential candidate Bola Tinubu win im polling unit

Wetin we call dis foto, Bola Tinubu win im polling unit Results from di polling units of some of di presidential candidates don begin show.
Di All Progressives Congress Presidential Flag bearer, Bola Ahmed Tinubu win im polling unit.
APC 33
LP 8
PDP 1
Number of voters 324
INEC no postpone general elections for di first time in 12 years
EFCC catch woman wit 18 voter cards for Kaduna, plus odas wey dey allegedly buy votes

Wia dis foto come from, EFCC
Wetin we call dis foto, EFCC gbab three pipo for election mago mago for Kaduna, Abuja and Kano states Di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) don catch one woman wit 18 voter cards for one sting operation for Badarwa area of Kaduna state.
Di woman wey be member of di support group of one of di leading political parties, also get for her possession, one list wey contain 17 names of eligible voters, dia bank details and phone numbers as accredited to Badarwa/Malali Ward 01 and 08, Kaduna North Local Government Area for di state.
Officials of di Nigeria corruption police bin catch her as dem dey pretend say dem get voter cards wey dem dey desperate to sell.
Dem don begin investigate to get informate on oda pipo she claim say dem dey work together, dey buy voter cards and pay di owners money through POS or direct money transfer.
EFCC also gbab one man for alleged vote buying wit N194,000 for Gidan Zakka polling unit, for Goron Dutse area for Kano state Municipla Local Goment Area.
Dem also arrest party agents wey dey buy votes through bank transfers for Abaji, Abuja.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
First time voters tok wetin dem want from presidential election winner
Article Information - Author, Tunde Ososanya
- Role, Journalist, BBC News Pidgin
Voters for Etoi 1, 040 polling unit for Uyo Local Goment Area of Akwa Ibom State still dey exercise dia franchise.
Voting start around 10:12am and first time voter follow BBC Pidgin tok wetin dem expect from di presidential election winner.
Utibe Etim say wetin im want be say make di winner of di presidential election build di economy and strengthen all goment institutions.
“I want make di presidential election winner stand by di pipo. A lot of pipo decide to come out to vote dia preferred candidates. I want make di winner build di economy and strengthen all goment institutions,” Etim tok.

Wetin we call dis foto, Utibe Etim na first time voter One Nigerian student identified as Dera Ezechukwu say im want di price of fuel to come down and make di winner of di presidential election to solve di issue of naira scarcity.
She also say she want di pesin to eliminate strike for higher institutions and provide employment for youths.

Wetin we call dis foto, Dera Ezechukwu no want higher institutions to dey go on strike again Semma Abasi na fresh graduate and all she want na beta Nigeria.

Wetin we call dis foto, Sema Abasi na fresh graduate Precious Mathew wey be student say she want di presidential election winner to fix di education sector and bring end to higher institution strike.

Wetin we call dis foto, Precious Mathew na student Otobong Imoh na student wey also want di presidential election winner to put an end to school strike, fix di education sector and provide employment for di youths.

Wetin we call dis foto, Otobong Imoh Samson John say all im want na beta president wey go make Nigeria great.

Wetin we call dis foto, Samson John pose wit im voter card Nigeria general elections 2023: ‘I no wan begin suspect foul play’ - Wike
Rivers State govnor, Nyesom Wike say di slow performance of di Bi-Modal Voters Accreditation Machine System (Bvas) na evidence of poor level of preparation on di part of Independent Electoral National Commission (Inec) concerning di 2023 general election.
Oga Wike express im displeasure afta e cast im vote by 12.42pm for im polling unit 7 in Ward 9, Rumueprikom of Obio/Akpor LGA.
Di govnor and im wife, Justice Suzzette Eberechi Nyesom-Wike bin return two hours afta dem bin no fit cast dia vote due to failure of Bvas to accredit dem.
Govnor Wike say despite di promise of fixing di identified problem wey bin delay voting at im polling unit, INEC still no dey in full control in order to ensure say di Bvas machine operate well.
"Of all di promises dem make since I leave dis place 2 hours ago, di Bvas still no dey very functional. I no wan suspect foul play.
"But from reports I don receive from oda local goments, e appear to me say na di same experience. Dis go make you wonder why na so e go be for Rivers pipo. E no dey encouraging at all.” Wike tok

Wia dis foto come from, RVGH Press
Wetin we call dis foto, Wike finally cast im vote for Rumuepirikom Ward 9 unit 7 
Wia dis foto come from, RVGH Press
Wetin we call dis foto, Wike finally do accreditation with di BVAS machine 2 hours after e bin first come out to vote NIGERIAN ELECTIONS: Update on voting for South-east NIGERIA

Wetin we call dis foto, Pipo dey ready to vote for Anambra state Plenty pipo turn out to vote for Anambra state and across di southeast of Nigeria.
As early as 7am, voters don begin waka go dia polling centres dey wait for electoral officers to land, set up dia equipment for di exercise to start.
By noon, di centers don dey busy as hundreds of voters dey fall in to exercise dia right. Many of di voters say dem dey encouraged to come out becos of di heavy presence of security dem deploy across the region.
Dem mount security checks for major road intersections both for di towns and rural communities. Movements dey restricted today across di kontri. Major roads still dey empty for Anambra state.
Anambra na di home state of di presidential candidate of di Labour Party Mr. Peter Obi wey don already vote plus im wife for di polling unit near dia house.
E describe di voting process for im center as peaceful and well organized and note say di e security concerns for di southeast na exaggeration.
for neighbouring Imo state, Electoral Officers and voting materials neva arrive some polling centres as at 2pm local time. Hundreds of voters say dem don dey wait for hours to cast their vote, but so far, no show.
Enugu state don also see massive voters turn out. But most voters complain say di process of accreditation dey slow.
Voting don end for some polling units for Abuja
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin
Voting for di 2023 Presidential and National Assembly elections don end for some polling units for Abuja, di Nigeria capital.
Inec officials don begin dey sort di votes while counting dey go on for oda polling units.
Election observers and security personnel stand gidigba dey monitor di sorting and counting.
Di voters demsefs dey on ground to protect dia votes and watch di sorting and counting from start to finish.

Wetin we call dis foto, Counting of votes dey go on for polling unit for Abuja Municipal Area Council 
Wetin we call dis foto, Voters dey monitor di vote counting for dia polling unit for Abuja Voting and counting don start for some polling units

Wetin we call dis foto, Voting and sorting don start for some polling unites Election don end for some polling units across Nigeria and voting and counting don start for those polling units.
For polling unit 03, Enu Owa / Muhammed Azikiwe in Idumota axis of Lagos, sorting and counting of votes dey in progress.
For polling unit 03, Idumota Oke ward Lagos Island wia election don end, sorting and counting dey go on.
For Central Area Abuja, sorting and and counting of votes done start.
Watch: Moment APC Presidential candidate Bola Tinubu vote
Watch di moment di All Progressives Congress, APC candidate Bola Tinubu vote for di election.
Wetin we call dis Video, Tinubu cast im vote for Lagos Electoral boss tok sorry for delays in voting

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Mahmood Yakubu promise to dey give regular updates Nigeria electoral oga don tok sorry for di for delays wey some voters experience for some parts of di kontri.
Mahmood Yakubu wey follow tori pipo tok for central collation centre for di capital, Abuja, afta plenty reports say voting materials and electoral officers no quick reach some states.
Di head of di Independent National Electoral Commission (Inec) say some delays na sake of di advice wey security agencies give dem for di safety of personnel and materials.
E say armed men bin attack some polling units for di southern state of Delta, wia jaguda pipo tiff at least two voter card verification machines.
Oga Yakubu say dem don replace di stolen items and don boost security to allow voting to take place.
For di northern state of Katsina, suspected criminal gangs bin attack one voting location, dem snatch at least six of di voter card checking devices, wey dey known as Bvas. Dem recover three and don replace di odas, di Inec boss tok.
For di north-eastern state of Borno, wia one Islamist insurgency don dey fight for more dan a decade, oga Yakubu confirm say insurgents bin open fire on di electoral officers from di top of one mountain for di Gwoza area.
Reports say some electoral officers injure for di shooting, e tok.
Di electoral commission go kontinu to review di situation and provide regular updates, e conclude.
Vice President Yemi Osinbajo don vote

Wia dis foto come from, Tolani Alli
Nigerian Vice President Yemi Osinbajo don cast im vote today togeda wit im wife Dolapo.
Im vote for di Polling Unit 14, Awolowo road, egunrege, Ikenne in Ogun State.

Wia dis foto come from, Tolani Alli

Wia dis foto come from, Tolani Alii

Wia dis foto come from, Tolani Alli
Wetin dey happun for Surulere?

Voters for Nuru Oniwo Ward polling unit 081 and 082 run for dia lives as gun men storm di area, dey shoot for air and dem carri di ballot boxes.
Eye witness Barrister Yomi Fagbayi tell BBC Pidgin say di “voting dey go smoothly wen di gun men arrive and we begin run. Some fall for gutter, some lose dia phones”.
Our reporter sight ballot papers for ground, di INEC officials no dey ground and di ballot boxes dey miss



Wia dis foto come from, bbc
WTO DG Okonjo Iweala cast her vote afta initial delay

Wia dis foto come from, Dr. Ngozi Okonjo Iweala
Wetin we call dis foto, Director General of di World Trade Organization don cast her vote Di Director General of di World Trade Organization Dr Ngozi Okonjo-Iweala don finally cast her vote for her polling station for Umuda Isingwu Village for Umuahia, Abia state.
Dis na afta she wait for some hours before INEC officials show for her polling unit.
Dr. Okonjo-Iweala for her Twitter account lament say plenty voters bin don gada for di polling station as early as 7:00am, but as at 11:23am, no INEC officers bin show.

Wia dis foto come from, Dr. Ngozi Okonjo Iweala
Wetin we call dis foto, Dr Okonjo-Iweala for her polling unit dey wait for INEC officials She later tok say di INEC official arrive later and she don vote alongside her husband.
Di WTO Director add say di turnout dey unbelievable, as na di largest she don ever see for all di years she bin don dey vote for di village.
Group of physically challenged pipo vote
Article Information - Author, Onyinye Chime
- Role, BBC News, Kaduna

One group of physically challenged pipo come out to vote for Angwan Sarki ward, polling unit 024 for Kaduna north LGA.
Dem say dem dey follow dem sef from one unit to anoda as all of dem no belong to di same polling unit.
Voting no give dem any wahala di group tok as Inec officials dey give dem opportunity to vote once each pesin reach di polling unit wia im register to vote.

Electoral malpractice observed for Onna local goment area of Akwa Ibom
Article Information - Author, Tunde Ososanya
- Role, Journalist, BBC News Pidgin

Wetin we call dis foto, Party agent dey stuff ballot box for Ward 1, unit 5, Onna Local Goment Area of Akwa Ibom Malpractice dey go on for Awa Ward 1, unit 5, Onna Local Goment Area of Akwa Ibom State wia party agents dey tell pipo who to vote for.
BBC Pidgin tori pesin observe say some party agents dey close to di polling boots and dem dey tell voters who to cast dia votes for.
Some oda party agents dey in front of queues dey collect and check pipo PVC before dem finally go vote.

Wetin we call dis foto, Na one of di party agents dey direct di queue One voter tell BBC Pidgin say one party agent tell am to cast her vote for one particular candidate but she refuse.
Wen BBC Pidgin follow di INEC representative for di polling unit tok, im claim ignorance of wetin dey go on and later observe wen BBC Pidgin ask am to observe.
Afta di observation, di INEC representative inform party agents say dem no get right to dey check voters PVC but before im komot from di polling unit, di electoral malpractice continue.

Wetin we call dis foto, Party agent dey stuff ballot boxes Govnor Abdullahi Ganduje don cast im vote
Article Information - Author, Mansur Abubakar
- Role, BBC Pidgin, Kano

Wia dis foto come from, Clem Oloye
Wetin we call dis foto, Govnor Abdullahi Ganduje as e dey cast im vote Govnor Abdullahi Ganduje of Kano state don cast im vote for di ongoing presidential/national assembly elections wey dey go on for Nigeria.
Di govnor vote for im local goment Dawakin Tofa wia e go to im ward Ganduje 008 to cast im vote.
Di outgoing govnor na one of di Nigerian politicians wey go step down from dia office on May 29 2023 afta spending di maximum 8 years in office.
Obasanjo hail di use of BVAS as e cast im vote for Ogun state
Article Information - Author, Olaronke Alo
- Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

Wia dis foto come from, Olusegun Obasanjo Media
Fomer Nigeria President Olusegun Obasanjo cast im vote for Abeokuta, Ogun state for south west of di kontri.
Wen im dey follow tori pipo tok, e hail di use of di BVAS machine by INEC.
“We must encourage any new tin wey go help di credibility and integrity of di electoral process.” E tok.

Wia dis foto come from, Olusegun Obasanjo Media
Wetin we call dis foto, Olusegun Obasanjo dey tok to tori pipo 'Even wit my disability I get right to vote' - Sani Ibrahim
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin

Wetin we call dis foto, Mr Sani Ibrahim wey dey physically challenged cari im tricye to come vote Mr Sani Ibrahim na one of di Nigerian voters wey come out even though im dey physically challenged.
42 years old Mr Sani draw attention for di Post Office polling Unit Garki, Abuja wia im showface wit im branded customised tricycle.
Wetin im write for di back of im tricycle catch attention as e write "One Nigeria"
Im hope say di kontri go become in dream nation wia goment go give pipo wey dey physically challenged inclusion.


Voting don start for some parts of Abuja, women come out to vote
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin

Wetin we call dis foto, Women wey come out to vote Voting don start for Area 2 National Library Polling Unit. Plenti pipo queue for Accreditation, while di ones dem accredit don vote.
One 71-year-old papa say "my bodi dey do me paulina paulina as I come vote for di sake of my small pikin dem, evritin dey go smoothly and I believe say my vote go count"
BBC Pidgin capture some women for diferent polling units for di Nigeria capital.

Wetin we call dis foto, Elderly woman wey don cast her vote





