INEC declare Soludo of APGA winner of Anambra governorship election
Nigeria election body di Independent National Electoral Commission don announce say Anambra State supplementary election go hold from 10 am to 4 pm today.
Live Coverage
Moseph Ekine and Helen Oyibo
Breaking, INEC move announcement of results by one hour
Inec Commissioner wey dey in charge of voter education
Festus Okoye don announce say di collation of result go start proper by
11am instead of 10am wey dem bin announce.
Festus Okoye add say di commission don receive results of several local government areas.
E also say di collation/returning officer na di Vice chancellor of one University for South eastern Nigeria.
Inec set up collation centre as announcement of results time don reach
Every every don set for di announcement of results of di governorship election for Anambra state wey happen on Saturday.
Inec bin anounce say na 10am dem go start to announce di results on Sunday.
So far, Party delegates, Observers and Journalists don tanda for di state collation centre for Awka, capital of Anambra State.
Wetin we call dis foto, Election observers and party delegates don tanda for Inec collation centre dey wait for announcement of results
Wetin we call dis foto, Even journalists don set up dey wait for Inec to announce results
How Chukwuma Soludo of APGA dey lead for Awka South
Wetin we call dis foto, APGA govnorship candidate Chukwuma Soludo
Di All Progressives Grand Alliance (APGA) party candidate for di Anambra Govnorship election, Chukwuma Soludo
don take early lead for Awka South Local goment area.
Di returning officer wey announce di results of
di parties, say di winner neva dey declared yet but dis na for pipo to sabi how
di voting take go.
APGA 12,891
APC – 2, 595
PDP – 5, 498
YPP – 919
Total
valid votes - 22, 802
Rejected
votes – 875
Total
votes cast – 23, 677
Inec go begin announce final results by 10am.
NYSC DG hail corps members wey dey on election duties
Wia dis foto come from, NYSC
Wetin we call dis foto, NYSC DG hail corp members
Di
National Youth Service Corps Director-General don hail di patriotism of Corps
Members wey work during di Governorship Election for Anambra State.
Brigadier
General Shuaibu Ibrahim say di corp members don write dia names for history as dem don contribute towards credible electoral
process.
E
tok dis one wen e dey monitor di election for nine Local Government Areas of
di State.
E
add say make dem no dey partial and perform their duties in line wit di
established rules.
For
all di polling units e visit according to am, di corpers tell am say di conduct of di exercise dey peaceful.
'We don solve technical problems' – INEC
Wetin we call dis foto, Anambra governorship election collation of result
Independent National Electoral
Commission say di collation of results from local government areas for Saturday
govnorship election for Anambra go start on Sunday by 10 am.
INEC Resident Electoral
Commissioner, Nkwachukwu Orji announce
am on Saturday night.
According to Orji, dem don
already upload results for polling units on top dia IRev portal and
registration area. Di registration area collation dey progress well
Orji say di commission dey
satisfied wit di progress of di election, even afta di initial problems wey di Bimodal
Voter Accreditation System machine cause.
Anambra pipo wait for Saturday election results
Good morning.
Welcome to di continuation of our live-text coverage of Anambra 2021 governorship election.Today expectation dey say Nigeria election body di Independent National Electoral Commission go begin announce results of Saturday governorship election.
According to Inec state chairman Nkwachukwu Orji, dem go start by 10am.
Make you stay with us for updates as di results go begin come in.
INEC declare Soludo of APGA winner of Anambra governorship election
Breaking, Inec go begin collate results on Sunday
Anambra state chairman of di Independent National Electoral Commission, Nkwachukwu Orji don announce say collation of results for Saturday governorship election go start by 10am on Sunday 7 Novemver, 2021.
Oga Orji announce dis one afta journalists bin don gada dey wait for wen collation go start for Inec headquarters for Awka,
Di Inec chairman say na because collation still dey go on na im make announcement of results go happun on Sunday
"As e be so, we never receive results for state level as counting still dey go on for local goment level," na so oga Orji tok.
Di Inec chair express shock say di BVAS machine wey dey capture accredited voters experience issues for some polling units.
Im also add say even Adhoc officials wey dem don train for weeks shock dem as dem pull out of di election due to concerns about security for di state.
Wetin be BVAS and wetin e don change for di election process?
Apga candidate Soludo finally vote
Afta some delays candidate of All Progressives Grand Alliance party, Chukwuma Soludo finally cast im vote.
Di former Head of Nigeria Central Bank cast im vote for Unit 2 for Isuofia ward well afta di 4pm closing time for voting.
Soludo bin don complain about how slow di device wey dem dey take accredit voters bin delay di process of voting.
Im ask Inec to improve dia technology so registered voters no go face dis kind delay again.
Wait continue for PDP governorship candidate polling unit
Pipo still dey wait to find out which candidate win di election for Amesi inside Aguata local goment area.
Dat na di polling unit of di People's Democratic Party candidate, Valentine Ozigbo.
Wetin BBC Pidgin use eye see na say voters complain say di process dey slow as di Inec officials tell dem say dia laptop battery low and network dey poor.
Result sheets from Anambra governorship election
Vote counting still dey go on for some polling units for Anambra state.
Dis na some of di result sheets wey we don sight.
Wia dis foto come from, bb
Why Inec extend voting time
Nigeria election bodi Inec don announce say dem fit continue di election voting process on Sunday sake of some challenges wey dem dey face for field on Saturday.
For statement for dia official social media handle, dem announce extension of voting time from 2:30 pm to 4pm sake of challenges wey di BVAS machine dey cause for some polling units for di state.
Di statement say dem dey investigate why di machine work for some places but no work for odas.
Inec say, “Our technicians don build update for di devise to avoid repeat of di situation and dey upload di update “.
Di statement further tok say if di BVAS machine continue to dey malfunction, dem go move di election process for dose units to Sunday or any oda time wey di commission go tok.
Inec also admit for di statement say transportation mata affect dia work for some areas as some local media bin report.
E say “some of our transporters cancel dia trip sake of fear of security afta dem don collect 50% of dia moni, dem leave some of adhoc staff stranded"
Di statement further tok say some Inec adhoc staff back out from dia assignments at last moment.
Meanwhile, voting done end for most polling units and counting don start.
In fotos: Vote counting don start for some polling units
Voting don end for Ward 2, units 1,2 and 10 for Community primary school Amawbia, Awka.
Sorting and counting of votes don start for di ward.
See as di mata dey go.
Wetin we call dis foto, INEC officials dey sort vote for Community primary school Amawbia, Awka.
Wetin we call dis foto, INEC official dey count vote for ward 2, Akwa
Wetin we call dis foto, INEC official dey count vote for ward 2, Akwa
Wetin we call dis foto, INEC official dey count vote for ward 2, Akwa
Wetin we call dis foto, INEC official dey count vote for ward 2, Akwa
Breaking, Andy Uba win im polling unit
Andy Uba win im polling Unit with 81 votes for im ward for Aguata, ward 16 Polling Unit 10 for Uga.
APGA poll 10, YPP 5, while PDP get 2.
Wetin we call dis foto, Andy Uba poling unit result sheet
Breaking, INEC extend voting till 4:00pm
INEC Resident Electoral Commissioner for Anambra State, Nwachukwu Orji don announce extension of voting to 4pm.
Dis na sake of di challenge wey Bvas cause for some polling units for di state.
Meanwhile, voting done end for most polling units for Awka, di Anambra state capital
'I wan become di official fish supplier to goment house'
Dis fish seller for one of di polling units for di Anambra election tok why she carry her market go polling unit to hustle and vote.
Di fish seller wey say she go vote and do her business too say she get interest for di election because she want di next govnor to come from her town Amesi so dat by God's grace she go get contact to supply her fish to goment house as the official fish supplier if her broda win.
Former Anambra govnor arrive polling unit
Former Anambra state Govnor Peter Obi don land im polling unit for im hometown Ugulu to vote.
Obi bin govern Anambra state between 2007 -2014.
'Smile for di BVAS'
Despite di complains by voters wey say di Bimodal Voter Accreditation System no dey work some centres no dey experience di same tin.
Like dis one for Amesi wia everitin dey work fine.
Apga candidate Soludo complain of BVAS
Candidate of di All Progressives Grand Alliance, Chukwuma Soludo don ask Nigeria election body to sort out di issues wey dey happun wit di Bimodal Voter Accreditation System.
For Isuofia wey im suppose vote as at di time of dis report, na only seven pipo out of di over 700 registered voters for im unit don vote.
Oga Soludo wey never fir vote say "e go good make Inec extend di election time because e dey shcoking say di BVAS machine no dey work".
Dis complain of di new machine from Inec na one wey BBC Pidgin don notice across di state.
Na few hours remain before voting time of 2:30pm go reach