As di Independent National Electoral Commission continue to dey announce di result of di just concluded governorship election for Anambra state local goment by local goment collation officer for Orumba North local goment area draw di attention of di Independent National Electoral Commission say even though election hold for di area, im sign result sheet under duress.
Di officer make allegations say some security operatives hold am hostage and even fire tear gas for di area.
Returning Officer of Orumba north Dr. Michael Otu, of university of Calabar say im experience for di local government "no too sweet" but im thank God say e still dey alive.
Prof Florence Obi, wey be Anambra electoral officer, come ask am to submit im report as everytin wey e dey tok dey inside don dey documented.
Wetin happun for Orumba North local gomment?
Oga Michael Otu narrate say im fit tok am wit im full chest and evidence say election no happen for Orumba North local gomment as dem force am to sign di ballot paper, something e say im do to save im life.
Di returning officer add say criminals bin allegedly join hands wit police to beat am during di election.
Im drag di Election officer and oda officials for di area enter di matter as e allege say di EO sef get hand for di matter.
"Even di assistant collation officer wey I think say eh… I no know say I dey surrounded by enemies wey bring thugs to kill me," Michael tok.
E tok about police crisis wey happun for di local gomment, BVAS kasala plus how dem tear almost all di score sheets.
Meanwhile di Electoral officer of Orumba North local gomment, Comfort Omoruwa bin explain say returning officer Micahel Otu no dey composed.
She say di man no get experience of how to collate election result and she take charge sake of she go fit save dia lives.
Madam Florence add say she no join hand wit thugs as she no sabi any thug for di area.