APGA clear Idemili North local goment
Idemili North
APC – 2,291
APGA – 5,358
PDP – 2,312
YPP – 902
Nigeria election body di Independent National Electoral Commission don announce say Anambra State supplementary election go hold from 10 am to 4 pm today.
Moseph Ekine and Helen Oyibo
Idemili North
APC – 2,291
APGA – 5,358
PDP – 2,312
YPP – 902
Returning officer for Ihiala don announce say no election hold for di local goment wey get over 300 polling units.
Inec never tok wetin go happun for dat local goment.
Aguata
APC – 4,773
APGA – 9,136
PDP – 3,792
YPP – 1,070
Onitsha North
APC – 3,909
APGA – 5587
PDP – 3,781
YPP – 682
Ogbaru
APC – 1,178
APGA – 3,051
PDP – 3,445
YPP – 484
Candidate of People's Democratic party, Valentine Ozigbo na im win di election for Ogbaru local goment area.
Out of 12 local goment areas wey Inec don announce so far, na di first time wey PDP go record win for any local goment.
Di Independent National Electoral Commission never resume announcement of results afta dem bin go on break.
Returning Officer for di election, Prof Florence Obi bin announce say dem go go on break come resume by 3:30pm. Over 30mins don pass since dat time and pipo still dey wait for continuation of di process.
So far dem don announce 11 out of di 21 local goment areas for di state.
APGA candidate don win 10 of di local goment wey dem don announce.
Ifeanyi Ubah win di oda one wey be Nnewi North local goment.

Di returning officer for di ongoing announcement of election results for Anambra State don announce say dem go go on break from announcing results.
Prof Florence Obi so far don receive results of 11 local goments from di electoral officers. She say dem go gather again by 3:30pm wia dem go take di oda results wey dey available.
Orumba South
APC – 2,060
APGA – 4,394
PDP – 1,672
YPP – 887
Nnewi North
APC – 1,278
APGA – 3,369
PDP – 1,511
YPP – 6,485
Candidate of Young Progressives Party, Ifeanyi Ubah na im win di election for Nnewi South local goment area.
Out of 10 local goment areas wey Inec don announce so far, na di first time wey anoda party other dan APGA go win.
Njikoka
APC – 3,216
APGA – 8,803
PDP – 3,409
YPP – 924
Onitsha South
APC – 2,050
APGA – 4,281
PDP – 2,253
YPP – 271
Idemili South
APC – 1,039
APGA – 2,312
PDP – 2,016
YPP – 752
Incident of no election happun for three RAs.

Afta six electoral officers don announce results for di local government wey dem serve, di candidate of di All Progressives Grand Alliance na im don record early lead.
APGA candidate, Chukwuma Soludo don win for six out of 21 local goments so far.
Di six LGAs include:
Anambra East
APC – 2,034
APGA – 9,746
PDP – 1,380
YPP – 559
Anaocha
APC – 2,085
APGA – 6,911
PDP – 5,108
YPP – 868
Di returning officer say two RACs suffer issues as deployment of materials to di areas fail. Dis affect two polling units.
Ayamelum
APC – 2,409
APGA – 3,424
PDP – 2,804
YPP – 407
Di returning offcer, Mrs Florence Obi don ask di electoral officer for Ayamelum to go reconcile im figures.
After some minutes, di electoral officers read di results again and e show say nothing really change for di figures wey dem read before.
Oyi
APC – 2,830
APGA – 6,133
PDP – 2,484
YPP – 900
Di returning officer don ask make dem re-read di result for Oyi Local Goment Area
Awka South
APC – 2,595
APGA – 12,891
PDP – 5,498
YPP – 919
Dunukofia
APC – 1,991
APGA – 4,124
PDP – 1,680
YPP – 1,360

Officials of Nigeria election body, di Independent National Electoral Commission don take dia seats ahead of announcement of Anambra State governorship election results.
Di commission bin announce say di process go start by 11am but so far nothing really don start.
Na 21 local goments dey for di start and the returning officers for local goment level go come one by one to announce di results from dia LGAs