INEC declare Soludo of APGA winner of Anambra governorship election
Nigeria election body di Independent National Electoral Commission don announce say Anambra State supplementary election go hold from 10 am to 4 pm today.
Live Coverage
Moseph Ekine and Helen Oyibo
Breaking, Chukwuma Soludo of APGA win Anambra governorship election
Wia dis foto come from, Chukwuma Soludo/Facebook
Nigeria election body, di Independent National Electoral Commission don declare candidate of di All Progressives Grand Alliance Prof Chukwuma Soludo winner of di governorship election wey hold for di state on 6 November, 2021.
Soludo na govnor-elect of Anambra State - Wetin you need to know about him
Final result of wetin di parties score
APC: 43,285
APGA: 112,229
PDP: 53,807
YPP: 21,261
APGA win Ihiala local goment area
APC: 343
APGA: 8,283
PDP: 2,485
YPP: 344
INEC wait for result of Ihiala
Di overall returning officer of Anambra governorship election, Prof Florence Obi don announce say dem still dey wait for results to come in from Ihiala local goment area.
Di Prof tank Nigerians especially pipo of Anambra wey don wait for two days to find out who go be di next governor of di state.
Na today supplementary election hold for Ihiala local goment afta security concerns make am no hold on Saturday 6 November, 2021.
INEC go announce Ihiala results by 8pm?
As voting don end for Ihiala local goment, Inec don announce say State collation centre for Awka, capital of Anambra go open by 9pm.
Na dat time di commission go most likely announce di final declaration of di 2021 governorship election for Anambra
Vote counting don begin for some unit
Counting of votes don start for unit level as voting don end.
For Uzokwa ward 3 unit 8, APGA win wit 29 votes while APC come second wit 21 votes.
Police use helicopter to monitor security for Ihiala local goment
Police use patrol Helicopter to monitor election for Uzokwa ward three as voting dey go on dia.
Anambra State commissioner of Police, Echeng Echeng bin tok say di force don deploy over 1,000 officers go Ihiala to ensure security tanda for every polling unit.
Wetin be BVAS?
BVAS na di new voting device wey dey for cross-checking voters names for di Register of Voters.
E dey authenticate voters wit di use of dia fingerprints or facials.
INEC chairman, Professor Mahmood Yakubu during one stakeholder meeting on di Anambra State Governorship Election on Wednesday bin introduce BVAS device and e tok say di use of incident forms during elections no go dey again.
BVAS wey im full meaning be Bimodal Voter Accreditation System get dual capacity for fingerprint and facial authentication of voters.
Dis one na to guard against voting identity mago-mago. E mean say one pesin fit wan try use anoda pesin Permanent Voter's Card (PVC) to vote but wit dis new machine e no fit dey possible.
According to INEC, incident form no go dey useful again as pesin fit cheat wit am.
Voter wey no get original PVC no go fit vote.
Voter wey no dey successfully accredited electronically wit BVAS no go vote too.
Few pipo turn out for Amorka
Empty polling booths for Amorka ward 3 units 3,6 and 11.
Pipo just dey come in one after di oda.
Voting finally begin for Ihiala local goment
Afta some hours of delay voting don finally start for Ihiala local goment.
Dis supplementary election na im delay di announcement of di winner of November 6 governorship election for di state.
Dis na polling units 2, 4, 5, 11 and 22, ward 1 Amamu A for Ihiala wia election don start proper.
Ihiala voters wait for polls to start
Pipo for Ihiala local goment still dey wait for election to hold hours afta Inec say election suppose start.
As at 11:50am voters for Polling units 7, 9, 15 and 18 Uzuakwa Ward 3 Ihiala LGA, Anambra state pipo dey wait for Inec officials to arrive wit materials
INEC buses deliver election materials
Wetin we call dis foto, So far election never start
Vehicles wey carry election materials don leave Ihiala local goment secretariat to deliver dem to di different polling units for di area.
Yiaga want INEC to fix BVAS issue
Youth Initiative for Advocacy, Growth and Advancement don draw ear
give INEC say make dem make sure dem address di issue of logistics, BVAS
wey no dey function as voters for Anambra State don go vote for today supplementary election.
Executive Director of YIAGA
Africa, Samson Itodo say di first election show how polling units no open on
time and polling officials plus electoral materials no quick reach some
unit sake of logistics.
For dia preliminary
statement, YIAGA say for INEC to improve transparency of di supplementary
election, dem need to publish di total number of di Permanent Voter Cards wey
dem collect for Ihiala LGA and inform di public about dia status.
E also note say make INEC
check all di BVAS and be sure say dem di work well so dat dem no deny oda pipo
make dem no vote
YIAGA say INEC must make sure
e sanction all im staff dem wey don do wuru-wuru for di election.
How security be for Ihiala
Plenty police officers tanda for Ihiala local goment headquarters and oda parts of town as election for di area go hold today.
Over 1,000 officers na im police say dem send to di local goment.
Poll officers sort out election materials
Na just few minutes remain before election go begin for Anambra but materials never leave Ihiala secretariat.
INEC set to begin distribute election materials
Independent National Electoral Commission don ready to begin distribute materials to di polling units.
Polling officers right now don gada for di state secretariate to collect materials before dem go begin go dia different polling units.
'I still hope to be governor of Anambra'
People Democratic Party, Valentine Ozigbo don reveal say im still get hope im fit win di Anambra Govnorship election even though im dey behind di APGA candoidate, Charles Soludo with over fifty thousand votes.
E tok dis one give tori pipo say im dey hope to catch up for di results with di ova 140,000 voters wey go vote for Ihiala today, as well as di polling units across twelve oda local goments wey voting bin no happun on Saturday.
Dis na as im call out Inec say di low turnout of voters for dis election, no be say pipo no wan comot to vote but due to logistical wahala wey spoil tins wen dem bin comot.
Inec bin stop collation of results and neva call winner of di elections till di supplementary polls for Ihiala take place.
How Anambra election results stand, APGA dey lead
So far, Inec don announce 20 results out of di 21 local goment wey dey for Anambra state.
Di only result wey remain na dat of Ihiala local goment wey get about 148,000 registered voters.
E no dey clear if all of dat number go come out come vote today but dis na how di result be so far.
Ihiala Local government area na border town between Anambra and Imo state for southeast Nigeria.
Ihiala alone get 148,000 registered voters, according to Inec.
Dia votes fit decide who be di next govnor of Anambra state because na over 50,000 votes candidate of APGA, Chukwuma Soludo take dey lead PDP candidate, Valentine Ozigbo.
According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast.
Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di States of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election).
Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions.