Lagos state goment don relax curfew
Youths for Nigeria protest police brutality and di activities of di Special Anti-Robbery Squad (SARS).
Live Coverage
Nigeria protesters new demands afta IGP dissolve SARS
Nigeria protesters no believe say SARS dey dissolved, dem say 'na audio', End SARS protestes block traffic for Lekki Tool Gate

Lekki toll gate for Lagos, Nigeria bizness capital don turn no go area as End SARS protesters don block di road.
Dis time dem tok say make dem retrain SARS officers before dem deploy dem and also prosecute wuru-wuru officers, plus include compensation to di familes of SARS victims.
Musician wey follow BBC Pidgin tok say e no believe di dissolvement of SARS, say na audio, "because if pesin motor no good and e use new paint on am, e no go mak di motor good."

Our demands dey very clear, End SARS! - Timi Dakolo
Wetin we call dis Video, Nigerian Goment neva end SARS -Timi Dakolo See Nigerians #EndSARS quotes as police brutality protest continue
Watch as Lagos Lekki protesters dey ginger as heavy security arrive di protest venue
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Long before all dis wahala start, Nigeria President bin receive report on SARS Reform
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
UK High Commissioner to Nigeria dey watch wetin dey happun
Catriona Laing, di UK High Commissioner to Nigeria say she dey dey watch wetin dey happun.
Madam Laing wey be di UK goment rep for Nigeria tweet say she want authorities to respect di right to protest and protestors to remain peaceful.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Minister of Police Affairs dey trend for Nigeria social media

Wia dis foto come from, Minister of Police Affairs/Twitter
Minister of Police Affairs dey trend for Nigeria.
Im name na Muhammad Maigari Dingyadi.
Tori be say im recent tweet about how Nigerian goment want make citizens see as Police as friends no gel wit some social media users.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Four oda times authorities don ban SARS before IGP finally dissolve am
Lagos protest don start
"Leave our Lagos got to Sambisa" Na wetin di #SARSMustEnd protesters dey sing dis morning as dem begin march for Lekki second toll gate.
See wetin we sabi so far➡️ Nigeria protest
Singer Davido dey call on protesters to follow am meet Inspector General of Police this morning
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
"Dissolved SARS" no stop Nigeria protest against police brutality

Wia dis foto come from, Davido/FORTUN3
Protest against police brutality for Nigeria no end on Sunday even after di Police oga scata alais dissolve di Special Anti Robbery Squad SARS sake of di #EndSARS demands.
Today for most parts of Nigeria, di youths dey plan new protests wey make new demands wey include compensation for di pipo for SARS wey don kill.
Even some dey prepare petition go international criminal court.
Na protest dey shelle for Lagos and Abuja on Monday morning.
See how Nigerians react wen IGP dissolve SARS
Davido list im demands to goment afta e join #ENDSARS protest for Abuja

Wia dis foto come from, DAVIDO/TWITTER
Wetin we call dis foto, Nigerian Singer Davido for #ENDSARS protest Nigeria Singer, Davido don tell di goment say dem want make police release innocent protesters now as dem don dissolve SARS.
Di singer list also say im and oda proteters want executive order, legislative action and judicial panel of inquiry set up to prosecute di SARS officers wey dey guilty.
Dis na di tins wey Davido tweet say im wan goment to do;
Skip X post, 1Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Skip X post, 2Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Skip X post, 3Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Skip X post, 4Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
"I dey fear Police pass tiff"
Breaking, Nigeria Police don dissolve SARS
Five things wey go happun next afta Police IGP dissolve SARS
Ganduje suspend im media adviser for criticising Buhari for #EndSARS
Nigerians no wan believe SARS dissolve

While some End SARS protesters for London dey celebrate di dissolvement of di Special Anti-Robbery Squad wen Wizkid announce di tori give protesters, say "dis one show dsay your voice mata."
Oda protesters for Nigeria dey ask for enforcement before dem go believe because of how Nigerians don show dem pepper fordi kontri.
Pipo wey stay dey protest for Chevron Lekki tok say dem want make Nigerian President, Muhammadu Buhari to tok am for live broadcast before dem go beleive.