Lagos state goment don relax curfew

Youths for Nigeria protest police brutality and di activities of di Special Anti-Robbery Squad (SARS).

Live Coverage

  1. Killings, looting & property destroy for Abuja, Jos, Kano EndSARS protests

  2. #EndSARS & simple explainer of wetin dey happun for Nigeria

  3. President Buhari confam 69 killed for #EndSARS protest violence

  4. Two policemen don die for di Oyigbo violence - Rivers Police Command

    Cars wey dem burn

    Wia dis foto come from, Rivers Police Command

    Rivers State Police Command say two policemen don die for di gbege wey happen for Oyigbo on Wednesday 21 October, 2020.

    For statement wey di police tok- tok pesin SP Nnamdi Omoni sign, four police stations bin dey under attack afta about 500 jaguda boys dem suspect to be members of di Indigenous People of Biafra, IPOB, invade di Oyigbo Area Command, Oyigbo and Afam police stations come burn dem down.

    Di statement say 15 motors and one at more personnel carrier dey damaged and dem collect some arms and ammunition.

    For di Mile One area, Omoni say di IPOB members disguise as End SARS protesters try to burn di Mile One police station and di Eagle Crack Squad Office but dem no succeed although three of dem dey fatally wounded while dem arrest eight of dem wey dey help di State CID for dia investigations.

  5. Sanwo-Olu list 23 police officers wey Lagos State don cari go court

    To assure di public of im commitment to prosecute police officers wey don do bad, di govnor of Lagos State don name 23 officers di state dey prosecute.

    Oga Babajide Sanwo-Olu release one list on Friday 23 October wey contain 'human right violation' offence like kill-kill (murder), armed robbery and involuntary manslaughter.

    Di list also get informate about di court judge wey dey assigned to di cases, di stage di case don reach and wen next di court go hear di case.

    Di two-week protests for Nigeria wey start around 8 October na because youths bin want final-final end to di way police dey brutalize and do anyhow dem like.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  6. Buhari hold emergency meeting wit Obasanjo, Jonathan and odas

    Di ex-presidents for di virtual call

    Wia dis foto come from, Presidency

    President Muhammadu Buhari dey hold emergency meeting wit former Nigerian leaders plus security operatives for di kontri.

    Former president Olusegun Obasanjo, Abdulsalam Abubakar, Goodluck Jonathan, Chief Ernest Shonekan plus General Yakubu Gowon all dey di meeting.

    Di virtual close door meeting wey start around 9:00 am dey connected wit di #endsars protest and di kata-kata wey happun afta soldiers dem fire live bullets wia protesters gada on Tuesday for Lagos state.

    Senior goment officials wey di attend di meeting for di Council Chambers of di Presidential Villa, Abuja, na Vice President Yemi Osinbajo, Secretary to Government of the Federation, Boss Mustapha, Chief of Staff to the President, Ibrahim Gambari and National Security Adviser, Babagana Monguno.

    Oga of security agencies like the police and the SSS also join di meeting.

  7. 'We go continue to support rights of women'

  8. ‘We no sleep throughout di night’ - Oyigbo residents

    Oyigbo Divisional Police Station burning

    Wia dis foto come from, Allwell Ene

    Wetin we call dis foto, Oyigbo Divisional Police Station burning

    Pipo wey dey live for Oil Mill area and Oyigbo local Goment area of Rivers State say dem no sleep throughout Thursday night becos of gunshots wey bin dey fly upandan.

    Dis one dey happen in spite of di 24 hour curfew wey di Rivers State Governor Nyesom Wike declare for di areas since 6:30pm on Wednesday 21 October 2020.

    Charles Akah wey dey live for Oyigbo tell BBC Pidgin say na since Wednesday dem begin experience shootings and e become worse on Thursday after goment declare di curfew.

    “We no sleep yesterday night becos of di gunshots between di boys and security pipo police and army. In fact since Wednesday, dem block evriwia and gunshots dey fly upandan.

    About eight pesins don die from stray bullets wey reach dem. One husband and wife dem kill dem IN front of dia house

    One stray bulletin hit one womAn for my area and dem rush her go hospital but we never know if she survive or not.

    Paul Gabriel wey dey live for Rumuokwurushi, close to di Oilmill area also tell BBC Pidgin say throughout Thursday 22 October 2020 night, na so-SO gunshots dey hala.

    Gabriel add say by di morning of Friday 23 October, di area don calm down small, but say im no fit tok about di casualties as dem fear to come out come see.

    Police never tok put dis tori.

  9. Only di youth go decide way forward - Aisha Yesufu

    End SARS protester Aisha Yesufu raise hand for air

    Wia dis foto come from, Aisha Yesufu/Twitter

    Aisha Yesufu wey be di popular face for Abuja, Nigerian capital say di #EndSARS protest na struggle wey di youth start

    And dat na only di youth go decide wen e go end.

    She tok dis one as she react to di call by Feminist Coalition bin dey offer administrative support plus collect donation to ginger di protest but dem say dem no dey do again hours afta president Muhammadu Buhari speech.

    “ Anytin wey di youth decide, na wetin go happun’, she explain.

    Also Olumide Otitoju wey be one of di conveners of di protest for Abuja say di protest bin start before di feminist coalition dem volunteer to epp and dem do good job

    But dat if need dey for youth to go back to di street, dem go do am and dat di fight to end police brutality na for everi Nigerian.

    E say for now, dem one start to sensitise Nigerians to know say di end sars protest no target anybody but to hold goment accountable.

  10. Wetin go happun next afta Nigeria President Buhari address di nation ontop End SARS mata?

  11. Police clear road blocks for Lagos #EndSARS violence

  12. Super Eagle Players wan shun AFCON qualifier sake of #EndSARS Kasala?

  13. See wetin President Buhari tok for im broadcast on #EndSARS protests

  14. Buhari order security to end violence across Nigeria

  15. Hoodlums attack Warri Prison, set fire

  16. Jaguda pipo release 58 prisoners for Ondo prison

  17. Ikoyi prison for Lagos dey under attack

  18. Rivers dey relatively peaceful after di curfew

      • Author, Karina Igonikan
      • Role, BBC Pidgin
    Education Bustop for Mile One area
    Wetin we call dis foto, Education Bustop for Mile One area dey empty sake of di curfew

    Rivers State dey relatively peaceful after di State Goment declare 24 hours curfew for some parts of di State wey bin experience violence after gbege burst as some pipo do EndSars Protests.

    Di 24 hour curfew affect di whole of Oyigbo local goment area, Oilmill axis of Obio Akpor local goment, Mile One, Mile Two, Emenike, Ikoku and Iloabuchi axis of Port Harcourt city local goment.

    Pikins dem dey go school and pipo dey go about dia normal business, but di popular, Ikoku Motor Spare parts market and Rumuwoji market for Mile One dey affected as e dey for area wey dey under curfew.

  19. Aisha Yesufu say make northern Nigeria pipo ‘rise up’

    Aisha Yesufu

    Nigerian activist Aisha Yesufu tok for 2 minutes video wey she post on Twitter say make pipo for northern Nigeria rise up and protest like southerners, make dem no allow goment and religious leaders brain wash dem.

    Aisha dey tok after reports show say bandits kill anoda 20 pipo for Zamfara on Tuesday at a time wey many parts of di kontri dey protest against police brutality and bad governance.

    “My Arewa (northern Nigeria) pipo make una no allow politicians and religious leaders brain wash una say dis na about north and south, make una rise up and protest about wetin dey happun.” Dis na part of wetin di popular activist tok for Hausa language.

  20. Nobody comot CCTV camera from Lekki toll gate before shooting - Sanwo-Olu