Lagos state goment don relax curfew

Youths for Nigeria protest police brutality and di activities of di Special Anti-Robbery Squad (SARS).

Live Coverage

  1. Five things wey happun for di Lagos Panel of Inquiry on police brutality on di first day

  2. Pipo loot 110 tractors from Adamawa state

    Tractor

    Na 110 tractors miss for Adamawa state for northeastern Nigeria.

    Dis wan na as pipo comot to pack tins from warehouses, including Covid-19 food item palliatives, over di weekend for many states for Nigeria.

    Tok-tok pesin of Adamawa state govnor Solomon Kondugar wey confam dis tori to BBC add say security pipo dey work hard to fish out di looters.

    “Yes we don confam say 110 tractors miss and our security pipo go work hard to fish out di looters.”

    Foto of one of di tractors pipo loot

    Wia dis foto come from, Lamaran Azare

  3. Some members reject oath of secrecy for Lagos judicial panel on police brutality

  4. See wetin Gov Sanwo-Olu tell Becky Anderson on Lekki toll gate shooting

  5. Meet di pipo wey go represent youths for Lagos judicial panel of enquiry on police

  6. Chief of Army Staff order soldiers make dem go afta hoodlums and looters

    Nigerian Army

    Wia dis foto come from, Nigerian Army/FACEBOOK

    Wetin we call dis foto, Nigerian Army

    Chief of Army Staff Lt. Gen. Tukur Burutai don order military commanders and troops to go afta hoodlums and pipo wey raid warehouses and scata property across di kontri.

    He deny accuse say army dey behind di jaguda pipo wey burn, destroy and loot public and private property wey dey happun for many kontris.

    For inside meeting wit Principal Staff Officers, General Officers Commanding, and Field Commanders, oga Burutai say di recent activities by di jaguda pipo wey tiff and destroy things show say dem wan collect arms and ammunitions at all cost from security agencies.

    Di army say di “#ENDSARS protest wey don lead to violence and destruction of property na plan of di organisers to cause wahala wey go give di army bad name and dem dey aware of dis plan from di beginning.” Oga Burutai call for loyalty among all officers and soldiers of di Nigerian Army.

  7. SERAP theraten to sue NBC as dem fine Nigerian TV stations ontop protest coverage

    Civil society group, SERAP Nigeria don give di National Broadcasting Commission 48 hours to withdraw di fine wey dem sama three TV stations for di kontri.

    NBC bin sama fine of at least N2 million on Channels TV, AIT and Arise TV unto accuse say dem disobey di broadcast code by airing of viral social media videos of di End SARS protest wey NBC claim say no dey verified.

    Serap say if di NBC fines dey illegal and if dem no withdraw am in 48 hours, dem go carry NBC go court.

    Di group add say NBC action na anoda example of Nigerian authorities to silence independent media and say di fines dey against freedom of expression.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  8. States wia govnors order residents to return palliatives wey dem loot

    looter carry palliative wey im get from warehouse

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Some of Nigeria states govnors don order all di looters for dia states to sharply begin return all di palliatives wey dem bin go loot from different warehouses.

    Di Plateau state goment give dia pipo three days to return di Covid-19 palliatives wey dey dia hand or risk arrest.

    Looters bin enta warehouse for Bukuru inside di state capital Jos on Saturday pack all di palliatives.

    Inside statement di State Commissioner of Police Edward Egbuka, say looters get till Wednesday 28, to return wetin dem cari to di nearest local goment office or chop arrest.

    For Kaduna state, di goment don order di arrest of looters of palliatives.

    Di acting state govnor, Hadiza Balarabe, say dem go trace plus arrest and cari any pesin wey loot go court.

    Im say, “ e no get any oda word but stealing to describe di looting of food items wey CACOVID bin donate.”

    Looters enta warehouse for di state on Friday, cari food plus “expired and dangerous medicine wey dem cari from NAFDAC and 8,000 tons of soyabeans wey get chemical inside from one private processing company,” im tok.

    On Saturday, Ekiti state goment bin raise alarm say looters don mistakenly pack plenty poisonous food wey dem tik say na palliative item from di warehouses wey dey di state capital Ado Ekiti.

    Di state commissioner for Information and Civic Orientation, Akin Omole,say Ekiti state no get any Covid-19 palliative becos dem don alreadydistribute all di palliatives.

  9. FCT Minister deploy police to guard warehouse dem for di capital

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja

    Di FCT Minister don order di deployment of police pipo to different warehouses, business areas and markets across di capital.

    Oga Muhammed Bello give di order afta e do sharp-sharp security meeting on top security mata for Abuja

    Oga Bello tok-tok pesin wey tok to BBC Pidgin say di looting for Gwagwalada dey unfortunate and dat di food item for di warehouse na di one wey private sector contribute during di covid19 wahala

    E further explain say dem dey wait for di private sector pipo dem to tell dem how dem go take distribute di food dem before pipo break into di warehouse.

    Meanwhile FCT police command say dem don catch fifty one pipo wey loot for Jabi-Daki-biu, Idu Industrial Estate.

    Di FCT police commissioner, Bala Ciroma say dem also recover some food items.

    E say those wey dem catch, dem go soon charge dem to court after dem complete dia investigation.

  10. Thousands of pipo break into warehouse for Gwagwalada Abuja

  11. "I chop noodles, semo (loot) and I dey kampe afta NAFDAC warning"

  12. Cost of EndSARS violence for south-south region of Nigeria

  13. Sojas dey do house to house search for Calabar loot

  14. How Nigerian suspects hide inside ship wey travel from Lagos to England

  15. 'Buhari follow international community tok for speech'

  16. Weti happun for Kumba?

  17. 'We feel you' - Arsenal send support to Nigerians afta #EndSARS gbege

    Emirates Stadium

    Wia dis foto come from, Getty Images

    London club Arsenal FC, wey get millions of fans for Nigeria, don comot wit support for Nigerians, following di recent protest against police brutality for di kontri.

    Arsenal tweet from dia official Twitter account: 'Nigeria, we see you, we hear you, we feel you."

    Dis na di first show of support from any of di big football clubs wey popular wit fans from di West African kontri.

    Nwankwo Kanu

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Dis message dey come just days afta di Lekki shootings wia soldiers open fire ontop unarmed protesters for Lagos on 20 October.

    Arsenal popularity grow during di early 2000s afta di club sign ogbonge Super Eagle player like Nwankwo Kanu. Dem go later buy JJ Okocha nephew Alex Iwobi for 2015.

    Di club on dia message wey dem write wit white text ontop black background, ecnourage Nigerians say dem see all di video and dem no fit imagine di pain di citizens dey go through.

    "Stay strong, stay safe" na how dem take close di message.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  18. How to get support if your business pafuka during curfew - Lagos

  19. Wetin be SARS?

  20. Nigerian prophets wey see vision about EndSARS protests