Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Nigeria Govnors Forum go set up compensation panel for victims of police brutality
Wia dis foto come from, Nigeria Govnors Forum
Nigeria Govnors Forum say
each state go set up panel for di compensation to all di victims of police
brutality and make sure say dem give compensation to di pipo wey deserve am.
Di govnors tok dis one for dia
meeting wey dem do wit IGP on Wednesday October 14.
Di govnors also pledge dia
support to the kontri Inspector General of Police, Mohammed Adamu, plan to
reform police and make am more effective, accountable and transparent.
While dem pledge dia support,
di govnors also raise some concerns including di timing wey dem take introduce Special
Weapons and Tactics (SWAT) squad fit make pipo dey suspicious say dem just wan
dress FSARS wit anoda dress.
Dem add say e go fine if di
IGP consult di public before dem take any decision. Therefore dem advice am to
do meeting wit stakeholders to agree on format wey di reforms go take.
Consultation na one tin wey
dem enphasize for di IGP becos according to dem, police no go fit use one “single
solution” for all di 36 states and di Federal Capital Territory.
Police salary na anoda tin di
forum discuss, as dem recommend make di
IGP, di Police Service Commission and di Police Council review di salary of di
officers.
Di IGP say dem go send about
50 SWAT officers to each state.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Governor Obiano sack former OC of SARS James Nwafor
Jos End SARS protester come under fire
Unknown gunmen don open fire on End SARS protesters for Jos, Plateau State, north central Nigeria.
Earlier on Thursday, Plateau State Govnor, Simon Lalong, say northern states no dey against di Special Anti-Robbery Squad.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Protesters for Lekki, Lagos arrange ENDSARS cake
Lagos state goment don relax curfew
End Sars protesters block major road along Federal Secretariat
End Sars protesters for Abuja don block di major road along Federal Secretariat.
Protesters bin carry dia I-no-go-gree go di National Assembly but di Senate president refuse to come out come address di protesters.
Even though some lawmakers come out, dem enta street block Shehu Shagari way.
Security bin shut di Assembly gate as protesters bin dey push forward.
See fotos from di protest.
Authorities for Abuja don ban all forms of street demonstrations
Di FCT Security Committee for meeting don cancel all protests, gatherings and processions for Abuja, di Nigeria capital.
Di committee wey dey chaired by di FCT Minister, Malam Muhammed Musa Bello say dem chook eye into di directive of President Buhari and di dissolve order of FSARS by di Inspector General of Police and feel say di protesters dey cause kata kata for law abiding citizens.
Dem also tok say di Covid-19 guidelines still dey ground and di protesters no follow dem at all even as dem sabi say pipo get right to freedom of association.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Owner of Twitter tweet support for #EndSARS
Wetin we call dis foto, Jack Dorsey na co-founder and CEO of Twitter
Jack Dorsey, di co-founder of Twitter on Wednesday tweet multiple support for di protest against police brutality for Nigeria.
Di first of im support tweet just read "#EndSARS".
Small time afta, di IT entrepreneur ask im 4.5million followers to "Donate via #Bitcoin to help #EndSARS" as im retweet di account details of one group wey dey at di forefront of di protests for Nigeria.
Oga Dorsey wey bin come Nigeria for November wia im meet with young pipo of di most populous black country for di world.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Reports of Lagos attacks by anti-protest jaguda pipo
As di Nigeria protest against police brutality wan dey near di end of a second week, tori don comot say jaguda pipo carry weapons come Alausa, Ikeja for Lagos to attack #EndSARS protesters.
Videos don full social media wey show jaguda pipo dey comot from 'goment-owned bus', dey agitate with some youths wey dey ground for dia.
Di exact area for Alausa wia di incident happen na wia government offices and even that of di state govnor Babajide Sanwo-Olu dey.
Lagos State goment or di state police never react to di mata or comot statement on am.
BBC tori pesin no dey ground to independently verify wetin dey happen.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Nigeria Police Force salary vs top paid police officers for di world
SARS to SWAT - How Nigeria #EndSARS protests change things
Meet di five 'pipo' wey make #EndSARS protest dey colourful
"We don free di protesters for Ogun state "- Dapo Abiodun
Wia dis foto come from, Prince Dr. Dapo Abiodun Facebook
Wetin we call dis foto, Govnor Dapo Abiodun address protesters for im state.
Ogun state govnor Dapo Abiodun say im dey work wit im colleagues
dem for oda states to address di mata of police brutality.
Di govnor tok dis one wen in address EndSARS protesters
for Abeokuta on Wednesday.
"Police brutality na systemic evil wey need
serious attention," na wetin di govnor tok.
"Oda State Governors and me dey already work
out how to address dis wahala for each of our states to add to wetin federal
goment dey do", im add put.
E say dem no press charges against di more than
30 protesters wey chop arrest and say dem free all of dem.
Era wia Police dey profile pipo as yahoo boy don pass
Di Inspector General of Police don assure kontri pipo say, di era wey policemen dey look di kain car wey pipo dey drive, dia private property or profile dem to see weda dem be yahoo boys don pass.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Small Doctor tell protesters not to lose focus
Nigeria musician Small Doctor don advise di ENDSARS
protesters make dem no lose focus.
"We dey stronger togeda, no lose focus, you either dey
wit us or against us."na wetin im tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Nigerian youths still continue dia #ENDSARS protest wey don enta di eight day on Wednesday to end police brutality even though goment don agree for dia demands.
Rival group attack #ENDSARS protesters for Abuja
Wetin we call dis foto, Pro-SARS vs Anti-SARS protesters clash around Berger, Abuja.
#ENDSARS protesters for Abuja don clash wit some boys dem wey no support dia campaign.
Di incident happun for Berger
roundabout wia di protesters gada since morning.
Di protesters bin block di
major road and dis one come cause plenti hold-up for di area.
As di protesters dey do dia
we-no go gree-na so di boys dem begin attack dem wit sticks and cutlass.
Dem begin break-break motor
and anything wey dia eye see.
Dem wunjure plenti pipo
and vandalise cars.
Armed security pipo for di
area bin dey around but dem no fit calm di situation.
Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu meet wit President Muhammadu Buhari
Wia dis foto come from, Babajide Sanwo-Olu/TWITTER
Wetin we call dis foto, Lagos Govnor Babajide Sanwo-Olu
Lagos
State govnor Babajide Sanwo-Olu don meet wit President Muhammadu Buhari to present di demands of Lagos ENDSARS
protesters.
Di
govnor give assurance of di President commitment to begin holistic reform of di
entire police reform.
He
say di President don set up one panel wey dey made up of Civil Society leaders wey go chook eye inside all di cases of
abuse by di police.
Nigerians react to di new Special Weapons and Tactics squad IGP create
Nigerians for social media dey react to di new Special Weapons and Tactics squad wey di Inspector General of Police, Mohammed Adamu set up.
Some pipo believe say e go still be business as usual as pipo laptops and fones go turn "special weapon."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post, 2
Others say di kain
training wey SWAT need, na only Nigeria military fit even try provide am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post, 4
E still get di ones wey want make authorities tell dem wetin
di work of SWAT go involve.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post, 5
Pipo dey weybelieve
say ENDSWAT go soon begin trend.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post, 7
Rivers State Governor, Nyesom Wike call for total reform of Nigeria Police
Article Information
Author, Karina Igonikan
Role, BBC Pidgin
Wia dis foto come from, Rivers State Government House
Wetin we call dis foto, Rivers State Governor Nyesom Wike
Rivers State Governor, Nyesom Ezenwo Wike say make all Nigerians support di total reform of di Nigeria Police Force.Wike tok dis one wen im address End-SARS protesters for Goment House, Port Harcourt.
"If we no reform di Police, di same SARS officers go dey deployed to oda units of di Force to continue dia evil acts. So no be only to end SARS. Already, pronouncement to scrap am don land but evri Nigerian must support di total reform of the Police. SARS cannot and dem never be our friend before for Rivers state. Dem don kill one lecturer for Ken Saro-Wiwa Polytechnic without a cause and pipo keep quiet."President Muhammadu Buhari say im go reform di Police. Make we ready to hold am by im words," Di Governor tok.Di Rivers Governor say im don condemn di brutality and kidnapping activities of SARS officers against Rivers people tat-tay but instead of national support against such evil, leaders in some quarters reduced am to just politics."Wetin we find in dis kontri be say pipo like to play to di gallery. Dem hate pipo wey dey tok di truth."Wen we raise alarm over di killings of Rivers people by SARS operatives, nobody listen to us as dem say I dey play politics wit am. No Governor see di need to speak out against dat evil because e no dey happen for dia States. Now di evil of SARS don touch dem, dem want evribody to join."Rivers State no dey play second fiddle. Di life of Rivers people matter to me and I go continue to protect dem."Wetin you dey protest against, I don campaign against am long ago. If only dem listen, we for no dey protest today." Im tok