You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

INEC final results show how Gov. Akeredolu sweep Ondo election

Ondo State Governorship Election latest updates from di sunshine state of Nigeria 10 October vote.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Helen Oyibo

  1. More pictures from polling units...

    See more pictures from gbogi/isikan 1 unit 9 ward 2 as pipo don begin come out to vote.

  2. Voting don begin

    Voting don start for some polling units for Ondo state as pipo come out to vote who dem go vote as di next govnor of di state.

    See how di voting dey go here:

  3. Election rules for voting day

    Nigeria election office, Independent National Electoral Commission (INEC) bin don announce rules voters must obey during di 10 October Ondo State Governorship election.

    INEC bin draw ear give pipo wey wan comot to vote for election wey go happun on Saturday say dem no go allow pipo wey no wear face mask to join di queue to vote sake of Coronavirus Pandemic.

  4. One for di road!

    Who want some akara dis fine Saturday morning?

    Dis mama don ready to ginger residents wey go come vote around dis area.

    But not to worry, she say she go drop di akara go vote wen voting start proper.

  5. Too late to withdraw from race now - INEC

    Tok-tok pesin for INEC Festus Okoye don tell BBC say e dey too late for any candidate to dey tok about withdrawing now.

    Im tok dey come as tori dey fly upandan say di Deputy Govnor and ZLP candidate Agboola Ajayi don withdraw from di race.

    "Well at dis point in time, di name of di candidate go still remain for di ballot paper. And whatever votes dem get dem go count am for am. Di time for withdrawal of candidacy don pass". Okoye tok.

    Meanwhile one ZLP tok-tok pesin Allen Sowore also deny di tori say Ajayi withdraw from di race.

  6. Ondo pipo don dey come out

    Ondo pipo don dey come out to ready to cast dia vote.

    We sight some for Owode/Imuagun ward 11 unit 25. St Peter unity school and

    Voting suppose start by 8:30am and end for 2:30pm across di state.

  7. E don almost set!

    Di Independent National Electoral Commission officials don already dey set up for some wards wey our tori pipo torchlight.

    Check out dis polling Unit dem sight inside filling station.

  8. Who be di main contenders for dis election?

    Sabi pipo say di candidates to watch out for na:

    • Oluwarotimi Akeredolu of di All Progressives Party (APC)
    • Agboola Ajayi - Zenith Labour Party (ZLP)
    • Eyitayo Jegede - Peoples Democratic Party (PDP)
  9. Wetin you need to know about Ondo decide 2020

    About 17 political parties go participate for di October 10 governorship election and dem include di All Progressives Congress (APC), Peoples Democratic Party (PDP), Zenith Labour Party (ZLP), Action Alliance (AA), Accord Party (AP), African Action Congress (AAC), and African Democratic Congress (ADC).

    Others na di Action Democratic Party (ADP), All Progressives Grand Alliance (APGA), Allied Peoples Movement (APM), All Peoples Party (APP), National Peoples Party (NPP), National Resistance Movement (NRM), Young Progressive Party (YPP), Labour Party (LP), Social Democratic Party (SDP), and Peoples Redemption Party (PRP).

    No woman dey contest for dis election.

  10. Una good morning!

    Welcome to our live coverage of di Ondo state govnorship election.

    Stay with us for all di action live from Ondo and di buzz and reaction from around di kontri.

  11. Ondo Election rules voters, candidates must obey during 10 October voting

  12. Na lie say wey appoint returning officer from Akeredolu hometown - INEC, ....PDP reject INEC returning officer for Ondo election

    Nigeria election joinbodi INEC say no be true say dem appoint returning officer from Owu govnor Akeredolu hometown to dey incharge of di forthcoming govnorship election for Ondo state.

    Dia tok tok pesin Festus Okoye tell BBC Pidgin say wetin political parties dey do na to force INEC to reveal who go be di returning officer for di election.

    Okoye say “We no go reveal di pesin wey go be di returning officer till election day and im work go be to calculate election results wey go come in from various LGA’s”.

    Tori bin comot on Thursday say di opposition party PDP don reject di pesin wey INEC choose to be di returning officer for di govnorship election.

    Di tori tok say di pesin come from Owo wey be govnor Rotimi Akeredolu hometown and di govnor be candidate for di election.

    INEC say dem no go share dia right to appoint returning officer wit any political party, say make party’s go di dia campaign and follow di rules while INEC go do dia own work.

    Say anybodi wey we go appoint for di election go be pesin wey dey credible and neutral.

    Govnorship election go hold for di 18 LGA’s of Ondo state on Saturday October 10.

    Why PDP reject INEC returning officer for Ondo election

    Di tok-tok pesin for People s Democratic Party, Kola Ologbodiyan say dem reject di pesin wey INEC choose to be returning officer for Ondo election because im come from di hometown of one of di candidates.

    “Dis Akeredolu cousin, im come from Owo. You no fit go to di homestead of one of di candidate to go pick di umpire of di election’

    “Di People's Democratic Party totally reject am, dem must changedi Chief returning officer.” Oga Kola Ologbodiyan tok.

  13. Police don dey ginger for Saturday election

  14. Catapult, knife, tear gas gun: See di weapons wey police go use during elections

    Many pipo no go tink am twice when dem see police dey waka wit gun for hand, but na different mata if dia officer of di law begin carri catapult upandan as weapon.

    Well, dis go be di reality for di police officers wey go work during di Ondo State govnorship elections on 10 October.

    Catapult, knife and wetin be like tear gas launcher follow for di weapons wey police go use. And wetin be that brown tin?

    See some foto of di 'strange' weapons.

  15. Akeredolu deserve to dey re-elected - Buhari

    Nigeria president don do last minute campaign in support of im fellow APC party member wey dey contest for Ondo State govnorship seat.

    President Muhammadu Buhari release tweet say im dey confident say di pipo of Ondo go re-elect di current governor Oluwarotimi Akeredolu for second term.

    "Governor Akeredolu deserve to dey re-elected to finish di good work im start for im first term."

  16. US ask for peaceful elections for Ondo

    Di United States don ask for all stakeholders in di upcoming Ondo elections make dem kontinue to dey work toward "free, fair, transparent and peaceful elections".

    Di US embassy for Nigeria release dis one for statement 4 days before di 10 October govnorship elections wey 17 political parties go drag.

    Read di full statement:

    Although some Nigerians go dey disappointed say di statement no contain strong word of warning against riggers and those behind election violence.

    In di past di US don draw ear give pipo say anyone wey involve, support or mastermind bad behaviour inside election go chop visa ban to travel go America. And di ban go cover dia families join.

  17. Ondo decides: Residents tok wetin dem expect from di winner of October 10 election

  18. Meet di major candidates wey go battle on 10 October Ondo Election

  19. Court sentence Sotitobire Prophet Babatunde to life imprisonment ontop accuse of child kidnapping

  20. Akeredolu, Jegede sign peace accord ahead of Ondo election

    APC candidate for di Ondo 2020 govnorship election Govnor Rotimi Akeredolu, im PDP counterpart Eyitayo Jegede and oda political parties and dia candidates don sign peace agreement ahead of di Saturday election.

    See fotos from di event