You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
INEC final results show how Gov. Akeredolu sweep Ondo election
Ondo State Governorship Election latest updates from di sunshine state of Nigeria 10 October vote.
Live Coverage
Daniel Semeniworima and Helen Oyibo
Ooni of Ife wife drop title of Queen of Ile-Ife, clear di air on her marriage
Wetin be di truth behind di 'white cloth' wey fall for Ondo state
How dog bite Nigerian student for 'scrotum' for im hostel
In fotos: How June 12 protests waka across Nigeria
How gunmen hijack Ondo school bus wit children, staff
'I no support call for Yoruba nation, those pipo dey on dia own' - Gov Akeredolu
'Ondo no dey part of call for Yoruba nation' - Akeredolu
Southwest Govnors to Fulani: "Dis na una home nobody dey send una away"
Akeredolu quit notice to herders don end - See wetin go happun next
Presidency caution Akeredolu, Fulani community leaders over Ondo herders 'ban'
Who be Jimoh Ibrahim? di Nigeria businessman wey billions of debt put for wahala
Jaguda pipo release 58 prisoners for Ondo prison
Akeredolu don win Ondo Election for second term
Facts about Rotimi Akeredolu di 18th Govnor of Ondo State
Nigeria youth give police dia five demand afta dem dissolve SARS
As Inspector General of police, Mohammed Adamu dissolve SARS, one Nigerian youth don list five tins wey dem want police oga to do.
Dis inlude to release all arrested protesters of endsars, justice for all deceased victim of police brutality and compensation for dia families plus odas.
Governor Akeredolu celebrate im victory for Owo afta im win
Ondo state governor, Oluwarotimi Akeredolu celebrate im re-election win for Owo with im supporters wey dey hail am afta INEC declare am di winnner.
See photos of how di celebaration waka.
President Buhari congratulate Akeredolu and tell am to serve di pipo beta
Nigeria President Muhammadu Buhari don congratulate di govnor of Ondo state state, Oluwarotimi Akeredolu on im re-election and want make e use dis second term to serve di pipo of di state beta pass wetin im do for im first term.
Oga Buhari tok dis one inside statement wey one of im aide on Media and Publicity Femi Adesina sign.
E advice di govnor to dey humble as e dey celebrate im victory.
Di president also hail di Independent National Electoral Commission for di credible election dem organize, security agencies wey maintain peace and orderliness for di election and lastly, di pipo of Ondo state for di way dem conduct themselves for di election.
See INEC live results from INEC on who win Ondo Govnorship 2020 election
Breaking, Oluwarotimi Akeredolu don win Ondo election
Governor Oluwarotimi Akeredolu na im be di winner of Ondo govnorship election.
Di Independent National Electoral Commission (INEC) declare Oluwarotimi Akeredolu of APC di winner afta e get 292830 vote to beat PDP Candidate,Eyitayo Jegede wey get 195791 votes.