Video of how news anchor teeth fall comot for live TV

Wia dis foto come from, Marichka Padalko/NSTAGRAM
Different error fit happen for live TV - technical wahala, guests wey fit surprise you and 'take two' no even dey.
Marichka Padalko, one news presenter for Ukraine bin face one very strange wahala dis week wen part of her front teeth fall out.
But, like true professional, she just put di teeth for her hand continue wit her work.
"Honestly, I tink say pipo no go notice", she write for Instagram.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
"But we dey underrate di kain attention our viewers dey pay," she add under di video wey show her teeth as e comot.
Ms Padalko open up say she bin need teeth repair about ten years ago afta her daughter do mistake smash am wen she dey play wit metal alarm clock.
Upon say di network no post di video for YouTube at first, Ms Padalko say she bin dey happy wit di amount of support wey she don get.
"For any situation, keep calm," she add.
End of Di one wey oda users dey read well well
"See una tomorrow morning."












