Arsenal begin 2026/2027 Premier League season wit home match vs Coventry, United jam wit Hull, City go host Bournemouth

Wia dis foto come from, MICHAEL REGAN/GETTY IMAGES
Premier League champions Arsenal go open di 2026/2027 Premier League season wit home game against new boys Coventry City on Friday, 21 August.
Manchester United go travel away to Hull City, Manchester City go host Bournemouth while Liverpool go travel to Newcastle.
Chelsea go also travel to Fulham to complete di set for Match Day 1.
Di new season go see 380 games.
Both di start and end date of di 2026-2027 season dey later dan di usual date sake of di 2026 World Cup.
Di new campaign go begin for Saturday, 22 August, 2026 - wey be 34 days afta di World Cup final for di United States.
Di Premier League season go now end on Sunday, 30 May, 2027, wit di Champions League final six days later.
Thirty three (33) rounds of weekend fixtures go dey for di new season, di remaining five games go happun for midweek.
Di Premier League tok say di next season schedule go dey designed to "avoid domestic competition clash wit Uefa competition dates, wherever possible".
During di Christmas and New Year period, no two rounds of matches go happun within 60 hours of each oda, to keep up wit di commitment di clubs don make to deal wit di packed schedule during dat period.
Match day one full fixture schedule
Dis na di full fixtures for di first match-day weekend for di new season
Friday, 21 August 2026
20:00 Arsenal vs Coventry City
Saturday, 22 August 2026
12:30 Hull City vs Manchester United
Everton vs Crystal Palace
Ipswich Town vs Sunderland
Nottingham Forest vs Leeds United
17:30 Brentford vs Tottenham Hotspur
Sunday, 23 August
14:00 Brighton & Hove Albion vs Aston Villa
14:00 Manchester City vs AFC Bournemouth
16:30 Newcastle United vs Liverpool
Monday, 24 August
20:00 Fulham vs Chelsea

Wia dis foto come from, Getty Images
Arsenal first 10 fixtures for 2026/2027
Arsenal vs Coventry City (H)
Aston Villa vs Arsenal (A)
Arsenal vs Chelsea (H)
Sunderland vs Arsenal (A)
Brighton vs Arsenal (A)
Arsenal vs Leeds (H)
Nottingham Forest vs Arsenal (A)
Arsenal vs Everton (H)
Liverpool vs Arsenal (A)
Arsenal vs Hull City (H)
Last six fixtures
Bournemouth vs Arsenal (A)
Arsenal vs Tottenham Hotspurs (H)
Leeds vs Arsenal (A)
Arsenal vs Nottingham Forest (H)
Everton vs Arsenal (A)
Arsenal vs Brighton (H) – final day
Chelsea first 10 fixtures for 2026/2027
Fulham vs Chelsea (A)
Chelsea vs Brighton (H)
Arsenal vs Chelsea (A)
Chelsea vs Hull City (H)
Brentford vs Chelsea (A)
Chelsea vs Bournemouth (H)
Everton vs Chelsea (A)
Chelsea vs Tottenham, Hotspurs (H)
Chelsea vs Manchester United (H)
Sunderland vs Chelsea (A)
Last six fixtures
Chelsea vs Manchester City (H)
Liverpool vs Chelsea (A)
Tottenham Hotspurs vs Chelsea (A)
Chelsea vs Everton (H)
Bournemouth vs Chelsea (A)
Chelsea vs Brentford (H) - final day
Liverpool first 10 fixtures for 2026/2027
Sunderland vs Liverpool (A)
Liverpool vs Nottingham Forest (H)
Ipswich Town vs Liverpool (A)
Liverpool vs Fulham (H)
Bournemouth vs Liverpool (A)
Liverpool vs Manchester City (H)
Brentford vs Liverpool (A)
Liverpool vs Brighton (H)
Liverpool vs Arsenal (H)
Crystal Palace vs Liverpool (A)
Last six fixtures
Leeds vs Liverpool (A)
Liverpool vs Chelsea (H)
Manchester City vs Liverpool (A)
Liverpool vs Brentford (H)
Brighton vs Liverpool (A)
Liverpool vs Bournemouth (H) - final day
Manchester City first 10 fixtures for 2026/27
Manchester City vs Bournemouth (H)
Crystal Palace vs Manchester City (A)
Manchester City vs Coventry (H)
Manchester United vs Manchester City (A)
Manchester City vs Sunderland (H)
Liverpool vs Manchester City (A)
Manchester City vs Ipswich (H)
Aston Villa vs Manchester City (A)
Manchester City vs Brighton (H)
Nottingham Forest vs Manchester City (A)
Last six fixtures
Chelsea vs Manchester City (A)
Manchester City vs Brentford (H)
Manchester City v Liverpool (H)
Ipswich vs Manchester City (A)
Manchester City vs Aston Villa (H)
Sunderland vs Manchester City (A) – final game

Wia dis foto come from, MARK COSGROVE/NEWS IMAGES VIA GETTY IMAGES
Manchester United first 10 fixtures for 2026/2027
Hull City vs Manchester United (A)
Manchester United vs Ipswich Town (H)
Everton vs Manchester United (A)
Manchester United vs Manchester City (H)
Fulham vs Manchester United (A)
Manchester United vs Tottenham Hotspurs (H)
Leeds vs Manchester United (A)
Manchester United vs Bournemouth (H)
Chelsea vs Manchester United (A)
Manchester United vs Aston Villa (H)
Last six fixtures
Manchester United vs Crystal Palace (H)
Coventry City vs Manchester United (A)
Bournemouth vs Manchester United (A)
Manchester United vs Leeds (H)
Tottenham Hotspurs vs Manchester United (A)
Manchester United vs Fulham (H)
Top six teams wit plenti stadium capacity
Di 2026/2027 Premier League season go see plenti fans get di chance to watch dia teams for dia stadium; thousands of pipo.
Di top six teams wit plenti stadium capacity na
Manchester United – 74,500 capacity
Tottenham Hotspurs – 62,850 capacity
Liverpool – 61,276 capacity
Manchester City – 61,850 capacity
Arsenal – 60,704 capacity
Everton – 52,769 capacity

Wia dis foto come from, MARC ATKINS/GETTY IMAGE
Final match day of di season fixtures
Di final league game for di season go happun for Sunday, 30 May 2027.
Arsenal vs Brighton & Hove Albion
Aston Villa vs Tottenham Hotspur
Chelsea vs Brentford
Coventry City vs Nottingham Forest
Crystal Palace vs Leeds United
Hull City vs Newcastle United
Ipswich Town vs Everton
Liverpool vs AFC Bournemouth
Manchester United vs Fulham
Sunderland vs Manchester City
Major change to di international breaks
One major tin go change for di schedule from late September and early October.
Traditionally, di opening months of di season dey get three two-week international breaks: one for September, one for October and one for November.
From next season, dis go change. November international break go continue as normal, but wit September and October, dem bin merge di two to become one long break.
Dis go mean say di Premier League season go dey three-week break afta di weekend of September 19/20 until October 10/11.
As tins dey now, di longer autumn break go continue until at least di 2030-2031 season.









