'Na complete breakdown of my reputation' - Alison-Madueke mention who dey behind her trial for UK

Former Nigerian minister  of petroleum resources Diezani Alison-Madueke wear check suit ontop brown dress
Published
Read am in 5 mins

Former Nigerian minister of petroleum resources Diezani Alison-Madueke say di corruption accusations wey she face break her reputation and integrity.

Diezani say some cabals dey behind wetin happun to her and na sake of say she be di first female to hold high positions for di oil sector.

For di first time afta her court case for di UK, she tok to di BBC on di kain accusations wey dem sama her and di pipo wey dey behind am.

Diezani Alison-Madueke na Nigerian politician wey become di first female president of OPEC and also di first female of Nigeria oil ministry.

Court sama Diezani wit five count charges wey surround accepting bribes and charge of conspiracy to commit bribery.

But di court later find her guilty afta di trial for London Southwark Crown Court.

Na di UK National Crime Agency (NCA), in collaboration wit Nigerian govment and oda witnesses bin chook eye for dis matter for court, but she dey cleared of all di charges.

Diezani say during di case wey run for about 13 years really affect her and no matter how she try handle am, she still no get di kain freedom wey she get bifor.

"Wen dem take your freedom away from you, no matter how you wan handle am, e get impact on you psychologically."

Pesin wey dem see as one of Africa most prominent political figures, Diezani say di accusations "dey completely damaging from di beginning sake of say I be president of Opec."

She say some pipo bin target her sake of say she hold position as female president of Opec, wey be Organization of Petroleum Exporting Countries.

'I try to fight corruption for di oil sector'

Woman on purple dress wit beads for her neck

Wia dis foto come from, SAMUEL KUBANI/AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Diezani Alison-Madueke tok wit media bifor di start of di 162nd meeting of di OPEC conference on December 12, 2012 for Vienna.

Diezani become president of Opec for 2014 and she add say na she be di first female president of di gas exporting kontris forum, for Qatar.

During di interview, she say to be di first woman to break all dose barriers na somtin wey she gatz work hard to achieve.

She say her position give oda women di courage do break barriers, but wen di accusations hit her, e dey veri traumatic for her.

"So to be di first female of dis institutions and break global ceilings for women evriwia, and to get dis accusation upon me, na complete breakdown of my reputation, integrity."

She lament say na veri painful tin to work hard to enta dose high positions, come dey face bribery charges.

"Also all di years of hardwork to get to dat position in di first place. E get many effect, e dey veri painful, veri traumatic."

Alison-Madueke become Nigeria minister of petroleum resources between 2010 and 2015 under former President Goodluck Jonathan.

Although, former president Jonathan, wey appoint Alison-Madueke, no appear as witness during di trial.

But Oga Jonathan provide statement wia e say na third parties dey pay for transport, accommodation and oda items for ministers wey dey on official overseas business.

Wen BBC ask Diezani who she go blame for all kasala wey she face, she no take side for weda na UK govment or Nigeria, but she say dem for do more processes for di case.

"I tink say blame dey evriwia, I no tink say one group fit chop di blame alone. I tink di Nigerian govment gatz look di processes and practices dem deploy for dis case."

She say law suit for oda kontris dey 'sensitive' and e no dey end well. Wit dat, she say Nigeria for take dia time look di matter well.

On di issue of how di UK National Crime Agency (NCA) handle di case, Diezani say di agency for also look di matter well, especially di information wey Nigerian govment provide.

She say wen she hold di positions as Opec head and Nigeria oil minister, she dey middle of pipo wey no like women.

"I wish say dem (NCA) take more time to look into di accusations, and decide di truth especially from di Nigerian end and wetin dem feed dem."

"I be di first female to enta dat kain position as petroleum minister and as head of OPEC for veri misogynistic society."

Diezani say na her efforts fo fight corruption for di oil sector bin vex cabals wey make her become opposition and face many tins dat time.

"Di tins I try put in place to fight corruption for di oil sector no go well wit di cabals at all"

Diezani Alison-Madueke become Nigeria minister of transportation for July 2007. Dem later move her to Mines and Steel Development for 2008.

April 2010 dem appoint her as di first female Minister of Petroleum Resources for Nigeria.

She rise well for di oil sector commanding about 13 members of di Organisation of Petroleum Exporting Countries (Opec), wen she lead di organisation.