Chandrayaan-2: India don launch dia second mission to Moon

Chandrayaan-2 dey take off

Wia dis foto come from, Isro

Wetin we call dis foto, Dem broadcast di lift-off live ontop India television networks to hundreds of millions of pipo.
Published
Read am in 1 mins

India don successfully lunch dia second lunar mission one week afta dem match break for am sake of technical wahala.

Dem launch Chandrayaan-2 on Monday 14:43 local time (09:13 GMT) from di Sriharikota space station.

India space oga say di agency "bounce back with flying colours" afta dem cancel dia first attempt.

India dey hope say di $145m (£116m) mission go be di first to land for di Moon south pole.

Di spacecraft enta Earth orbit, wia e go stay for 23 days before e begin im waka reach lunar orbit.

Dem show di lift-off live for TV and for di space agency official social media accounts.

Pipo clap inside di Indian Space Research Organisation (Isro) control room minutes afta di launch, as di rocket take off go outer atmosphere.

Prime Minister Narendra Modi praise di mission say na dem-dem package am".

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post