Ayo Fasanmi: Afenifere leader and elder Nigeria politician get ogbonge tributes from far and near

Wia dis foto come from, Sogo ọmọ Osun
Published
Tributes don dey enter for Nigerian elder statesman and politician Ayorinde Fasanmi wey die at age 94 years.
According to statement wey Osun State Commissioner for Information and Civic Orientation, Funke Egbemode bin release, confirmation of di socio-political leader death, come from in pikin Justice Obademi Fasanmi.
"Pa. Fasanmi was good example of humility, selflessness and integrity. E make ogbonge contribution to im profession, to di socio-political development of Yorubaland, and to di nation at large," di statement bin tok join.
Tori be say im die on Wednesday 29 July.
Who be Pa Fasanmi?
- Dem born am for 1925 for present day Ekiti State, south-western Nigeria
- E attend St Paul's primary school, Ebutte Metta and Government School, Ibadan
- E study for Pharmacy School of Yaba where im collect diploma certificate in pharmacy
- For small time e practice Pharmacy work for Osogbo
- E join politics wen e become member of Unity Party of Nigeria for 1978
- Dem appoint am as Federal House of Representatives to represent Ondo North
- E later serve as one of di ogas of Old Western Nigeria Housing Corporation

Wia dis foto come from, Others
Until her death at age 82 for 2014, late Madam Adejoke na Oga Fasanmi wife.











