Easter Celebration: #HappyEaster trend as pipo dey celebrate online ontop lockdown

Wia dis foto come from, Getty Images
Hashtag Easter Sunday don dey trend for social media even though plenti pipo dey spend am for lockdown.
Top goment officials for Nigeria dey celebrate with dia kontri pipo but tell dem say make dem obseve di lockdown wey goment don put for ground.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
Meanwhile, as many Christians all ova di world dey celebrate Easter for lockdown, Pope Francis say make pipo "no fear" sake of coronavirus.
Di leader of di Roman Catholic Church tok dis one during im Easter vigil service on Saturday evening for St Peter's Basilica wey dey almost empty.

Wia dis foto come from, Getty Images
Pope Francis say make Christians be "messengers of life for dis time of death".
Member of di world 1.3 billion Catholic community fit follow live stream of di service.
Italy still dey under lockdown and most part of di world sake of di Covid-19 pandemic.

Christians around di world dey celebrate Easter, di most important festival for di Christian calendar, even with di lockdown wey mean say hundreds of millions dey for dia house.
End of Di one wey oda users dey read well well
Many priests dey hold services for churches without congregations.