UK court clear Nigeria former minister of petroleum Alison-Madueke of all charges

Wia dis foto come from, Getty Images
Court for UK don clear former Nigerian oil minister Diezani Alison-Madueke of six bribery charges.
Na on Wednesday di court for London say she no dey guilty of di six bribery charges wey dem bin sama her.
Dis dey come afta di corruption trial of di ogbonge former Nigeria oil minister.
Alison-Madueke, wey be for minister for petroleum resources between 2010 and 2015 under former president Goodluck Jonathan, bin stand trial for London.
Dem bin charge her wit five counts of accepting bribes and anoda charge of conspiracy to commit bribery, wey she deny.
Prosecutors allege say Alison-Madueke, wey dey 65 years bin get "a life of luxury" for London from di oil and gas industry figures wey bin dey try to get big contracts for Nigeria, wey also get hand for mismanagement and corruption.
But di former minister, wey bin tok say she no collect bribes and she bin no get any real influence ova who govment dey give big contracts to.
Afta di trial wey happun for di Southwark Crown Court, London, di court acquit Alison-Madueke of all di six charges she bin face afta more dan 46 hours of wey dem spend to decide on di mata.
Tori be say di verdict from di jury wey say she no dey guilty na serious blow to British authorities, wey bin start dia investigation into corruption allegations against Alison-Madueke more dan 10 years ago.
Alison-Madueke bin face trial wit oil industry executive Olatimbo Ayinde wey dey 54 years.
Dem sama am wit one count charge of bribery wey relate to Alison-Madueke and anoda separate count of bribery of one foreign public official.
Alison-Madueke broda Doye Agama wey dey 69 also dey charged with conspiracy to commit bribery wit im sister wey relate to payments wey im bin make to Agama church.
Both Ayinde and Agama deny di charges against dem and court also acquit dem.
Who be Diezani Alison-Madueke?
Diezani Alison-Madueke wey dem born on 6 December 1960 for Port Harcourt, Rivers State.
Na Nigerian politician and she be di first woman wey ever bicom president of di Organization of the Petroleum Exporting Countries (Opec)
She bicom Nigeria Minister of Transportation on 26 July 2007.
For 2008, dem move am go Ministry of Mines and Steel Development, and for April 2010, dem appoint am as di first female Minister of Petroleum Resources for Nigeria.
She later bicom di first female president of Opec for di 166th Opec Ordinary Meeting wey happun for Vienna on 27 November 2014.









